Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Say nor be small gbege for Kachia LGA of Kaduna State, dat Residents of Ariko community dey cry dat bandits attack dem early Sunday morning during Easter service, kill six worshippers and kidnap many others.
Eyewitnesses talk say di gunmen come in large numbers, surround First ECWA Church and St. Augustine Catholic Church, then open fire on pipo wey dey worship.
According to locals, di attackers carry out di operation to kidnap victims and collect money, as dem also steal church offering before dem leave.
As at di time wey konfam package dis report no authority don tuk.
Written by: Ridwan Agbomeji
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026