Blog horizontal

Background

Lagos

Sanwo-Olu Clear Area For Investors Say Make Dem Con Invest

By: Esther Ayoola Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu don  turn loyal governor, dey hail both local and foreign investors say,  make dem con invest for lagos. Di governor yarn dis one on Tuesday when him commission one Ogbege logistic company for Alaro City inside Lekki Free Zone, a mega warehouse and trading hub. Sanwo-Olu talk say di new project na big boost to Nigeria logistics and supply chain system and […]

todayDecember 9, 2025 6

south east

AAC Ginger Anambra Gorment Over Badness Of Jaguda

By: Alice Iduh Di African Action Congress don tear shirt condemn di December 7 gunmen attacks wey shake Nawfia for Njikoka LGA and one church for Lilu, Ihiala, saying di kain wahala no fit continue again. Party  tuk tuk persin, Anyanwu Chinedu,  ni dey clear newsmen  how im pipo dey in pain and clear  di Anambra State government sharpaly  do security reforms. Chinedu shout say make authorities take sharp-sharp action […]

todayDecember 9, 2025 9

National

Govo Bago Express Hapiness As Im Receive The 100 Papiri School Pikins

By: Alice Iduh Nor be  small happiness one finish   niger state govo, Umaru Bago for face, as  im ma  receive di 100 pikins wey jaguda boyz bin kpake   from st. Mary’s catholic school for papiri afta federal gornment secure dem. Di matter be say, how security take rescue di childrensis, nor  sti dey clear oh, whether, na  mind rob oh with the jaguda boys, abi na force, or whether dem […]

todayDecember 9, 2025 5

International

Prime Minister Starmer Join Tiktok Dey Do Tap Tap

By: Rilwan Agbomeji Britain Prime Minister, Keir Starmer, don launch im TikTok account on Monday to connect with younger voters, even though gorment  no dey allow to use di app for uk. Wey tori pipo con ask say na whole prime mister dey do tap tap, Na im tok tok person dey clear di matter that, na for  security measures, say nor be tap tap di Starmer dey do for […]

todayDecember 9, 2025 16 1

National

Vice Presido Shettima Enter Abijan Dey Preach Peace

By: Alice Iduh For swear wi oga Vice Presido Kashim Shettima go swear,  e don turn preacher, dey preach peace say, Nigeria tanda gidigba for any peace matter  for the  West Africa. Wetin Shettima talk, follow  aproko pipo mouth, when e represent President Bola Tinubu for the inauguration of President Alassane Ouattara for Abidjan, praise Ouattara leadership and talk say e get confidence for im new term. E still carry […]

todayDecember 9, 2025 3

Sports

Nwabali Chance To Play For Afcon 2025 Dey Shakibala Cause Of Wunjuri

By: Rilwan Agbomeji Tori dey fly fly down and up  say Super Eagles keeper, Stanley Nwabali, fit miss AFCON 2025 as im still dey battle ankle and hand Wunjury. Chippa United coachie, Vusumuzi Vilakazi, na carry marras for hea dey yanyanpu  give tori pipo say,  Nwabali get wunjury. Vilakazi talk say na during Nigeria World Cup playoffs for Morocco last month e worsen di injury, and since e come back, […]

todayDecember 9, 2025 11

Lagos

Lagos Traffic Arrest Ambulance Driver Say Im Wunjor Dispatch Rider

By: Esther Ayoola Nor be small gbege oh, between Lagos State Traffic Management Authority and  one ambulance driver,  say im go,  wunjor one delivery rider for leg for Odo Iya-Alaro bridge wey dey go Maryland along Ikorodu road. The two  both of dem drag demsleves for  traffic wella wella, nor be small. Lagos state traffic management agency tuk tuk person, Adebayo Taofiq, confirm the matter for statement on monday. Wey […]

todayDecember 9, 2025 4

Lagos

Lagos Gorment Ginger Dia Women Leaders To Wrestle Tuberculosis

By: Esther Ayoola Based on the rascality of the ogbonge diseases wey dem dey call,  tuberculosis, Lagos State gorment  like this like this don enter meeting  appoint womens with capacity,  including female lawmakers, newly elected female local government chairmen, and wives of lawmakers say make dem act as Ambassadors to fight tuberculosis for community level. This particular event dem  hold for First Lady Banquet Hall, Lagos House, wia the  First […]

todayDecember 9, 2025 5

International

TikTok Lock Night LIVE For Naija

By: Rilwan Agbomeji TikTok don announce say dem go block Nigerians to dey use  LIVE late-night as from Sunday midnight, and na part of one serious safety investigation wey dem dey run. Plenty creators see in-app notice wey tell dem sharp-sharp say from 11pm reach 5am, LIVE don waka disappear and anybody wey try enter go just meet “No Access.” Di move shock users because even LIVE shows from other […]

todayDecember 8, 2025 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app