By: Alice Iduh
For swear wi oga Vice Presido Kashim Shettima go swear, e don turn preacher, dey preach peace say, Nigeria tanda gidigba for any peace matter for the West Africa.
Wetin Shettima talk, follow aproko pipo mouth, when e represent President Bola Tinubu for the inauguration of President Alassane Ouattara for Abidjan, praise Ouattara leadership and talk say e get confidence for im new term.
E still carry Nigeria goodwill enter cote de ivoir, dey wish the Ivorian President success as e start him new term.