By: Esther Ayoola
Nor be small gbege oh, between Lagos State Traffic Management Authority and one ambulance driver, say im go, wunjor one delivery rider for leg for Odo Iya-Alaro bridge wey dey go Maryland along Ikorodu road.
The two both of dem drag demsleves for traffic wella wella, nor be small.
Lagos state traffic management agency tuk tuk person, Adebayo Taofiq, confirm the matter for statement on monday.
Wey dem con explain give tori pipo, the trafic management talk say, truck catch fire for the same area earlier, based on anywhow Character and so dem nor go allow the ambulance drive and like this, like this dem don arrest the driver go kirikiri.