Blog horizontal

Background

OBODO NAIJA

ADC Tackle APC Over Security Wahala

African Democratic Congress don accuse di All Progressives Congress say  dem don make insecurity worse for country. ADC chairmo, David Mark and tuk, tuk Bolaji Abdullahi ni tuk dis one on Wednesday for NEC meeting wey  dey hold for Abuja. According to di two senior men  gornment never handle security mata wella, explaining how dem wan take parrol for 2027.

todayMarch 26, 2026 7

OBODO NAIJA

APC South-West Pick New Exco By Consensus For Lagos Congress

Kekemeke and seven other zonal executives don become leaders by consensus for All Progressives Congress South-West congress wey hapun for Mobolaji Johnson Arena, Lagos. Chairmo of di  congress committee, Jide Jimoh, say about 1,398 delegates from states like Oyo, Ondo, Osun, Ogun, Ekiti and Lagos show for di exercise. Dem use consensus arrangement and voice vote take confirm di new executives. Babajide Sanwo-Olu, wey speak for South-West govo, praise di […]

todayMarch 26, 2026 5

obodo oyinbo

Britain, France And 30 Countries Dem To Join Bodi On Top Strait Of Hormuz Marras

Britain and France wan hold meeting dis week for Europe with about 30 countries to hellep reopen di Strait of Hormuz. According to Britain defence official rob mind with tori pipo,  di join bodi doings go include top officials from Britain, France, Germany, Italy, Japan and Netherlands and 24 other countries. Say Britain top military oga, Richard Knighton, don already meet di first six countries plus Canada on Sunday for […]

todayMarch 25, 2026 13 1

OBODO NAIJA

PDP Start Fresh Reconciliation To Join Back Factions

Di Peoples Democratic Party don start fresh reconciliation to join back di aggrieved factions wey dey inside di party. Di National Working Committee wey Tanimu Turaki (SAN) dey lead, supported by PDP govos na im dey  yarn dis one for Abuja on Wednesday. Turaki talk say, From last night and to dis morning, di reconciliation don dey get small head. E explain say di move follow one advice from Court […]

todayMarch 25, 2026 6 2

OBODO NAIJA

How Abuja Court Carry $13 Million From Lagos Socialite Aisha Give Federal Gorment

Federal High Court for Abuja don send order say di $13 million wey dey linked to Lagos socialite, Aisha Achimugu, and her company, Oceangate Engineering Oil & Gas Ltd,  say right now, don give   Federal Gornment di money. Justice Emeka Nwite give di judgement on Wednesday say  di EFCC don prove beyond doubt say di money di madam kpake am fraudulently. Di Court  say, di company no fit explain where […]

todayMarch 25, 2026 4

obodo oyinbo

US Send 15-Point Peace Plan To Iran

Iran don receive 15-point peace plan from US, and dat na Pakistan deliver am as intermediary dis week to try settle di nuclear issue. Di plan, wey dem no show to  public, fit help stop some of Iran nuclear facility and US suppose also remove sanctions from Iran. One Israeli minister explain di mat give tori pipo on Tuesday say di plan fine for paper, but e be like say […]

todayMarch 25, 2026 4

OBODO NAIJA

Gunmen Kill 9 Soldiers, 1 Policeman, Burn Military Trucks For Kebbi

Gunmen don launch one deadly ambush for Shanga Local Government Area, Kebbi state  kpaing about nine soldiers and one police officer on Tuesday night. Governor Nasir Idris confirm di attack and condemn di killing. Eyewitnesses share say di security operatives dey go operation for Giro Masa community when di gunmen surprisingly attack dem. Say di incident cause serious panic as dem burn two military trucks, while di community still dey […]

todayMarch 25, 2026 2

obodo oyinbo

US Police Arrest Driver Wey kpai Nigerian Graduate Fadero

Metropolitan Nashville Police for US don arrest one driver wey dey link to fatal hit-and-run wey kpai one Nigerian graduate, Oluwalayomi Fadero. Report from local station WSMV4 say di mata na since on Friday after di suspect, Ray Eugene Padgett, thief one vehicle come dey run. Di owner of di truck trace am reach one area, but when di suspect notice say dem dey follow am, e reverse motor jam […]

todayMarch 25, 2026 4

OBODO NAIJA

Trailer Askident Kpai Two Pipo For Ibadan

Two people don go kpai for one serious askident  wey happen on Wednesday for Beere Roundabout inside Ibadan, Oyo State capital. Police tuk, tuk, Ayanlade Olayinka, na im dey konfamte dis mata give tori pipo, say one man and one woman die immediately when one Mack truck wey belong to oil and gas company lose control as e dey come down from Beere area. According to am, di truck lose […]

todayMarch 25, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app