Blog horizontal

Background

National

Court Don Sentence Three Men To Death For Robbing 87-Year-Old Woman for Ekiti

Di Ekiti State High Court wey dey sit for Ado-Ekiti don sentence three people Shadrack Apos (30), Lucky Akpos (33), and Adunola Precious (24) to d3ath by hanging for robbing one 87-year-old woman. Dem arraign di trio for August 19, 2024, before Justice Lekan Ogunmoye on top two-count charge of conspiracy and armed robbery. According to di charge, dem rob Mama Victoria Folorunso for Ifaki Ekiti on June 12, 2024, […]

todayOctober 28, 2025 9

Lagos

Lagos Boxer Kill Carpenter Over Burst Ball For Ikorodu

One professional boxer wey people sabi as Bintin don allegedly punch one local carpenter, wey dem call Yellow, die for Adamo area of Ikorodu, Lagos, after dem quarrel over one burst football. Witnesses talk say wahala start after Yellow mistakenly burst di ball wey belong to Bintin pikin. Di boxer wife quickly call her husband, and as e reach house, e vex go meet Yellow accuse am say e burst […]

todayOctober 28, 2025 43 2

Lagos

Shortlet Agent Chop Diaspora Family ₦1.3m For Ikoyi

As Detty December dey near, wahala don start again as reports don show say many Nigerians wey dey live abroad don dey fall victim to fake shortlet agents for Lagos. One diaspora family don lose ₦1.3 million give one agent wey promise dem one fine apartment for Ikoyi. Di family see di agent page for Instagram wey full with luxury shortlet pictures for Ikoyi and Lekki, and e look legit. […]

todayOctober 28, 2025 19

International

Ouattara, 83, Don Win 4th Term As Ivory Coast President

Ivory Coast Presido, Alassane Ouattara, don win im fourth term after di presidential election wey happen for di West African country. According to di Independent Electoral Commission (CIE) wey announce provisional result on Monday evening, di 83-year-old leader grab about 89.77% (3.75 million votes), while businessman Jean-Louis Billon carry only 3.09%. Voter turnout reach 50.1%, and di final result go come out after di Constitutional Council finish to check any […]

todayOctober 28, 2025 13

Sports

Oliseh Hail Iwobi As First Naija Player To Hit 300 Premier League Games

Former Super Eagles star, Sunday Oliseh don hail midfielder Alex Iwobi after e make history as di first Naija player wey don play 300 Premier League matches. Iwobi reach dis big milestone during Fulham weekend match against Newcastle United for St. James’ Park. Di 29-year-old start im Premier League journey for October 2015 when e debut for Arsenal against Swansea City, and since den, e don play for three clubs […]

todayOctober 28, 2025 15

Sports

Super Falcons’ Michelle Alozie Make 2025 FIFPRO World XI List

Super Falcons defender Michelle Alozie don make di 26-player shortlist for di prestigious 2025 FIFPRO Women’s World 11 wey dem announce on Monday. Di nomination base on votes wey professional football players from around di world cast. Alozie get di nod after one hot year wey she shine for Nigeria’s strong campaign for 2024 Women’s Africa Cup of Nations (WAFCON) for Morocco. Di Houston Dash right-back be one of di […]

todayOctober 28, 2025 27

Lagos

Otti Hail Abia Biker We Ride From Lagos, Vow To Still Put People First

Governor Alex Otti don talk say him government no go gree make anything distract dem from giving Abia people di real dividends of democracy, as him still stand gidigba to better di welfare and well-being of di people. Di Governor yarn dis one when him receive one Abia-born cyclist, Mr. Wisdom Chisom, we ride bicycle all di way from Lagos reach Abia just to honour di Governor for him visible […]

todayOctober 28, 2025 16

Lagos

Police Don Storm Lagos As Residents Cry Over Demolition Deaths

Two pikin don reportedly die for Oworonshoki, Lagos, as police deploy full ground to control wahala wey burst from di new demolition wey Lagos State Government start again. Police full everywhere from Iyana Oworo reach Adeniji Adele after some residents threaten say dem go block road for protest. Fresh demolition start around midnight for Coker and Ojulari area, just one day after government yarn say about 80 landlords don collect […]

todayOctober 28, 2025 22

Lagos

Drug Traffickers Don Enter Nigeria Courier Services

For Lagos wey dey always full of traffic and wahala, dispatch riders don turn di real heartbeat of city life. As di road dey choke and people dey find how to move fast, dem riders dey weave in and out like breeze carry food, parcel, and document go offices and houses sharp sharp. Dem don become di engine of convenience for Nigeria wey every minute mean money. According to National […]

todayOctober 28, 2025 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app