Blog horizontal

Background

obodo oyinbo

US And Israel Join Body Put Naval Blockade On Iran Ports

Prime Minister Benjamin Netanyahu don decideĀ  say Israel go support US President Donald Trump plan to put naval blockade on Iran, and say dem dey work closely with America. US military don announce say dem go start the blockade for all Iranian ports after tuks with Iran jam beta rock. Trump also tuk say dem go block the Strait of Hormuz, wey be very important trade route, until Iran open […]

todayApril 13, 2026 40

Sports

How Armed Robbers Attack And Kpai Ghana Footballer, Dominic Frimpong

For Ghana, say Premier League footballer Dominic Frimpong kpai afta armed robbers attackĀ  dia team bus on Sunday night as di team dey come back from away match for Ashanti Region. Di club Berekum Chelsea FC naim konfamate dis mata, say masked men wey carry guns and assault rifle open fire for di team bus, na so players scata. Ghana Police Service tuk say di incident hapun around 10:30pm for […]

todayApril 13, 2026 62

National

ADC Leadership Crisis, Supreme Court To Hear David Mark Appeal For Abuja Tuesday

Say Supreme Court of Naija go hear appeal on Tuesday for Abuja, where di court go decide mata wey involve leadership wahala of African Democratic Congress. According to appeal wey David Mark and im lawyer file, say make court hellep to stop execution of Court of Appeal ruling of March 12, so dat status quo go remain. Dem sti ask say make Independent National Electoral Commission no change ADC national […]

todayApril 13, 2026 62

National

Yobe Gorment Put Mouth For Military Air Strikes For Borno State

Yobe State Gornment, through im Security Adviser Brig Gen Dahiru Abdulsalam (retd.), don explain wetin hapaun for Borno say di incident involve Boko Haram for Jilli community. Dem also clear say, di strike no happen for Yobe State, but for Gubio Local Government Area inside Borno State. E explain say on Saturday, April 11, 2025, Air Component of Joint Task Force Operation HADIN KAI carry out air strike for Jilli, […]

todayApril 13, 2026 28

National

FG Remove Import Duty For Buses, EVS, Machine To Ease Economy Wahala

Federal Gornment don grant waiver wey go remove import duty for mass transit buses, electric vehicles, and manufacturing machines. Dis move come as President Bola Ahmed Tinubu direct economic team make dem find way reduce pressure wey high fuel price and global crisis dey put on Nigerians. According to statement wey Presidential aide Dada Olusegun post for X, di policy na to hellep reduce inflation and make life and business […]

todayApril 13, 2026 28

Sports

Inter Milan Run Comeback Beat Como 4-3, Open Gap For Title Race

By: Esther Ayoola Inter Milan do beta comeback win against Como 4-3 for Serie A, move nine points clear Napoli wey only draw 1-1 with Parma. Como bin dey lead 2-0 before first half end, thanks to goals from Alex Valle and young star Nico Paz. Marcus Thuram bring Inter come back into di match with two sharp goals wey level everything. Denzel Dumfries and later finish from Manuel Akanji […]

todayApril 13, 2026 35

Sports

Fear Grip Arsenal Fans As City Close EPL Title Gap

By: Esther Ayoola Say like dis now, Arsenal fans dey worry as title race don dey tight afta dem lose 2-1 to Bournemouth for Emirates Stadium. Di defeat mean say dia lead don reduce to just six points with Manchester City sti getting one match in hand. City no waste time as dem beat Chelsea 3-0 to show say dem sti dey serious for di race. If City win dia […]

todayApril 13, 2026 28

Sports

Rivers United Climb Back Top As Ikorodu City Shine For Matchday 34

By: Esther Ayoola Rivers United don return go top of di Naija Premier League table afta dem knack Plateau United 1-0. Wisdom Samuel na im score di only goal for di match for inside 11th minute of di game. Ikorodu City also carry strong win against Kano Pillars, as dem boost dia hope for continental competition. Di Matchday 34 results don make di title race and relegation battle hot as […]

todayApril 13, 2026 27

obodo oyinbo

Magyar Win Hungary Election, Become New Prime Minister

For Hungary inside Budapest on Sunday night, election result show say PĆ©ter Magyar and im Tisza party win big landslide say pipo vote against corruption and old gornment rule. Dat di country vote with high turnout of about 79%, say dem use ballot box choose change, reject di long rule of Viktor OrbĆ”n and im Fidesz party. Magyar now dey warm up to take over as di new prime minister […]

todayApril 13, 2026 16

obodo oyinbo

Trump Order US Navy To Block Strait Of Hormuz Say Iran Nor Wan Respect Demselves

US Presido, Donald Trump like dis don order US Navy say make dem block Strait of Hormuz because Iran say dem nor go stop dia nuclear program. Trump tuk for im truth social say even though, dem get small peace agreement for Islamabad with Iran, im nor go spare anybody wey go attack US property. Di US Presido warn say any Iranian wey go try attack US or other ships […]

todayApril 13, 2026 30

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds