Blog horizontal

Background

National

Bandits Kpai 5 For Otobi, Benue State

By: Esther Ayoola Nor be small thing oh, eehooo, say Bandits don kpai kpai pipo for Benue again oh, say  five pipo kpai for Otobi community, Otukpo LGA, Benue State. One of di people wey dem say die, na 2019 PDP House of Assembly candidate, Igbabe Ochi. According to report, di attack happen around 1:30am on Tuesday, after community volunteer guards do better commando scarra some jaguda boys wey wan […]

todayJanuary 13, 2026 6 1

Lagos

Lagos Council declare Seven-Day Mourning For Badagry King

By: Esther Ayoola Di Chairmo of Badagry Local Gornment, Babatunde Hunpe, on Tuesday don go declare, say dem go observe seven days of mourning for di late Akran of Badagry, Aholu Menu Toyi I, wey die on Monday, January 12. Hunpe make dis announcement for Badagry through im Chief Press Secretary, Kriko Augustine. Di govo of Lagos State, Babajide Sanwo-Olu, approve di announcement as Akran join him ancestors peacefully afta […]

todayJanuary 13, 2026 5 3

National

Lagos APC Tell Obi Say Tinubu Dey Active For Governance

By: Esther Ayoola Di Lagos State chapter of di All Progressices Congress on Tuesday don tuk dia tuk, say, wi oga Presido, Bola Tinubu no dey miss and dat e dey active for him duties. Di comment follow question wey Peter Obi, Labour Party presidential candidate for 2023, raise about di president’s presence yesterday. APC spokesman, Seye Oladejo, tell newsmen for Lagos say Tinubu still dey fully involved for governance, […]

todayJanuary 13, 2026 5 6

Sports

CAF To Arrange Draw For 2027 AFCON Qualifiers

By: Esther Ayoola Di Confederation of African Football (CAF) go do draw for di preliminary round of di 2027 Africa Cup of Nations (AFCON) qualifiers on Tuesday evening, wey go officially start di journey to di tournament. CAF on Monday don release di official pots for di teams wey go play for di preliminary stage. Pot 1 get Lesotho, Burundi, Ethiopia, Eswatini, South Sudan and Mauritius. Pot 2 get Chad, […]

todayJanuary 13, 2026 13 3

Lagos

Okpebholo Address Marras On Di Shops Wey Jaguda Boys Burn For Ekpoma

By: Esther Ayoola Following di Badness wey sup for Ekpoma over di weekend, Edo State Govo, Senator Monday Okpebholo, on Tuesday don drop promise, say di state gorment go hellep rebuild di shops wey fire burn for Ekpoma Police Division, for Esan West Local Government Area. Okpebholo tuk dis one when e visit di police station to assess di damage to di shops wey Police Officers Wives Association build. According […]

todayJanuary 13, 2026 5

National

How Jaguda Boys Do Warling Film For Obajana Police HQ

By: Rilwan Agbomeji Say nor be small war start film play for Obajana Police Divisional Headquarters for Kogi State, dat jaguda boys enter di area and begin shoot wetin nor good kill one civil defence guide, but last last face and scata dem. Several security personnel and vigilante members sustained gunshot wunjor for di mata oh. Resident say di mata wey sup from Sunday to Monday night nor allow dem […]

todayJanuary 13, 2026 6 2

foreign

Iran Minister Drop Yarns Dat Iran Nor Go Legbere For Anybody

By: Rilwan Agbomeji Iran Foreign Minister Abbas Araghchi, once again don tuk oh, say Iran ready for war if America wan “test” dem. Dis dey come afta US President Trump warn say im fit use military over Iran protests. Protests start over money wahala but don grow to big calls for system change. Ontop interview with tori pipo,  E say tuk channels with US still open but Iran military strong […]

todayJanuary 13, 2026 5 3

Sports

Dan Evans, Oda Brit Tennis Players Chop Defeat For Australian Open

By: Rilwan Agbomeji Great Britain tennis player, Dan Evans go fall hand for Australia, fail to reach Australian Open main draw. Im go lose inside first round for qualifying phase wey sup for Melbourne. Na so im service weak like dodo, lose 6-1, 6-2 to Japan player Rei Sakamoto. Oda Britons, Jay Clarke and Jack Pinnington Jones, also lose straight sets, and Oliver Crawford lose 6-3, 2-6, 6-3 to Spain […]

todayJanuary 13, 2026 9 3

National

Edo Gorment React To Jaguda Boys Doings For Ekpoma

By: Esther Ayoola Edo State Governor, Monday Okpebholo, don condemn di attack wey hoodlums carry go Onojie of Ekpoma palace after dem hijack peaceful protest against kidnapping and insecurity for di area. Di protesters scata market, kill goats, beat cows, block major road and destroy parts of di palace, making businesses come standstill. Governor Okpebholo finally visit di palace on Monday and tuk say di violence no dey acceptable, dat […]

todayJanuary 13, 2026 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app