Blog horizontal

Background

National

Train Driver Jam 18 Months For Steal N6.99m

Justice Rahman Oshodi for Lagos State Special Offences Court don sentence 39-year-old train driver, Christopher Ofielu, wey dey work for Nigerian Railway Corporation, to one year and six months jail or make e pay N1.5m fine for stealing N6,995,944 wey belong to HabariPay Limited. Ofielu confess say e steal the money after EFCC catch am for October 2023, when e use system glitch transfer di money from HabariPay account go […]

todayOctober 21, 2025 3

National

Free Nnamdi kanu Protesters Run As Security Fire Tear Gas, Gunshots For Abuja

Human rights activist, Omoyele Sowore, still lead di #FreeNnamdiKanuNow protest for Abuja on Monday, even after court order and police warning. Protesters start di march from areas like Transcorp Hilton, dey chant “Free Nnamdi Kanu now,” “Na our constitutional right to protest,” and “No tear gas us.” But police no gree. Dem land early, fire tear gas and gunshots, scatter everybody. Some protesters still shout “Tear gas no fit stop […]

todayOctober 20, 2025 18

Lagos

Lagos Government Don Launch “Trash For Cash” Program To Boost Recycling

Di Lagos State Government don launch new program wey dem call “Trash for Cash” to encourage residents to turn dia waste to money by exchanging recyclable items like plastic, cans, and bottles for cash. Dis initiative na part of government plan to promote cleaner and greener Lagos. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, announce am for him X handle on Monday, say through LAWMA, dem don begin sensitisation […]

todayOctober 20, 2025 9

Lagos

Sanwo-Olu Confirm Say Lagos Still Dey Ground For Sustainable Growth Ahead 2025 Climate Change Summit

Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu, on Sunday confirm say Lagos dey committed to push sustainable growth through new ideas and better investment for resilience as e go host the 2025 International Climate Change Summit. Di summit wey go happen for Lagos Continental Hotel from November 6 to 7, 2025, go gather big leaders, investors, climate scientists, and policy makers from all over di world. According to statement from Commissioner for […]

todayOctober 20, 2025 6

Lagos

LASG Join Hand Wit AFD and Others to Launch €360m Waterways Transport System

Lagos State Government join hand with French Development Agency (AFD), European Union (EU), and European Investment Bank (EIB) to launch big project wey dem call Omi Eko Project. Dis project go upgrade Lagos waterways transport with modern speed boats wey get better technology. Di plan na to make ferry system for Lagos organised, cheap, and better so dat e go connect places well and make life easy for Lagos people. […]

todayOctober 20, 2025 3

Lagos

Insecurity: People Wey Dey Dopemu Area For Lagos Dey Cry Out For Help

People wey dey Dopemu for Agege Local Government Area, Lagos State, don dey cry out to state government make dem help stop the yawa wey area boys dey cause for dia streets. Di boys dey always show for street every evening, especially for places wey get shops, dey carry cutlasses, axes and other dangerous weapons to dey attack traders and people wey dey return from work. Eyewitness talk say di […]

todayOctober 20, 2025 6

Lagos

Nigerians Must Fast, Pray To Avoid Wahala Wey Dey Come — Former Lagos Deputy Gov Ojikutu

Former Lagos State Deputy Governor, Alhaja Sinatu Ojikutu don announce say October 23, 2025, di day wey she go turn 80, go dey observed as day of fasting, prayer, and sobriety. She call make people from all over join body dey pray for survival and better life as hardship dey come. Ojikutu also talk say di day suppose be time to show love and help poor people wey no get […]

todayOctober 20, 2025 4

Lagos

Govt Dey Okay As Dem Dey Remove Illegal Structures For Safety Sake

Group wey concern for Lagos don show strong support for state govt as dem dey remove illegal structures for different areas of Lagos. Di group talk say dem no gree with 30-day ultimatum wey Igbo National Union Worldwide (INU-W) give Lagos govt, say make dem stop di removal. Dem call di ultimatum one way to bring back old wahala like di 1952 NCNC palava for Lagos. Di group talk say […]

todayOctober 20, 2025 3

National

Police Don Arrest Suspected Varsity Cult Leader, Recover Pistol, Others For Ondo

Operatives of di Ondo State Police Command don arrest one suspected cult leader, Boluwatife Abdul, wey be student for Adekunle Ajasin University, Akungba-Akoko (AAUA). Dem describe Abdul as notorious cultist for di school community, and dem catch am red-handed as e dey hold secret meeting with him cult members. Police tok-tok pesin for di state, Olayinka Ayanlade, confirm di arrest, say di guy don dey dia watchlist since. He add […]

todayOctober 20, 2025 5

Sports

Postecoglou Comot As Forest Coach After Chelsea Defeat

Nottingham Forest manager Ange Postecoglou don lose him job on Saturday after just eight matches as coach, minutes after Chelsea waka come City Ground carry 3-0 win. Di club put for X say, “After plenty bad results and poor performance, Ange Postecoglou don stop to be head coach immediately.” Di club no want talk more for now. Forest owner Evangelos Marinakis leave him seat during di match, and after full-time, […]

todayOctober 20, 2025 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app