Blog horizontal

Background

Sport Yarns

Messi Set to Battle England as 39-Year-Old Legend Chases Another World Cup Glory

By : Jolayemi Olajide Lionel Messi go finally face England for di first time in im career as Argentina and England prepare for Wednesday World Cup semi-final. Di 39-year-old captain just play im 200th match for Argentina after dem beat Algeria for di group stage, and e still dey hope to carry im country reach another World Cup final. Messi international journey start for 2005 when e make im debut […]

todayJuly 14, 2026 14

Sports

Lamine Yamal Put Pressure For France Body

As di 2026 World Cup don enter Semi Finals, Spain and France go play by 8pm dis night, na so tension dey full bodi. But Spanish wonder boy, Lamine Yamal no send either tension or pressure as e go post picture of di 5-4 victory wey Spain knack give France for 2025 UEFA Nations League Semi Finals. Yamal drop dis post for him Instagram story on Tuesday to remind France […]

todayJuly 14, 2026 20 1

Lagos

How Unknown Gunmen Kpai Lagos transport Secretary, Ijaya

By : Jolayemi Olajide Nor be small tin oh, Lagos National Union of Road Transport Workers, NURTW Organising Secretary, Toba Ajiboye, wey people know as Ijaya wey do lose im life after unknown gunmen attack am for Ikorodu Road. Report say the gunmen block im motor for night as e dey return from Fadeyi, come open fire and scatter the motor with bullets. Though first report talk say Ajiboye survive […]

todayJuly 14, 2026 10

OBODO NAIJA

Court Order Make Police Arrest Self-Claimed PFIPC Oga Adeyemi

By : Jolayemi Olajide Justice Muhammed Umar of Federal High Court for Abuja don order make police arrest Adeniyi Adeyemi after e no show for court to answer the charges against am. Adeyemi, wey dey call himself Director-General of Presidential Foreign Investment Promotion Council, suppose take plea for eight-count charge wey involve forgery, fraud and impersonation. Even though one lawyer, Genesis Francis, appear for am, the defendant no come court […]

todayJuly 14, 2026 10

south west

Senate explain to Makinde why im need to dey careful with security mata

By : Jolayemi Olajide Senate don warn Oyo State Govo, Seyi Makinde, say make e no dey make statement wey fit spoil Federal Gornment and security agencies effort to fight terrorism and kidnapping, after e call on United Nations make dem investigate the abduction of school children and teachers for Oriire Local Government Area. Senate give di warning after dem discuss motion wey Senate Leader Opeyemi Bamidele bring about di […]

todayJuly 14, 2026 12

National

Reps Drop Dia State Police Bill, Follow Presidency Own

By : Jolayemi Olajide House of Representatives don suspend work on dia own constitutional amendment bill for state police and decide to continue with similar bill wey Presidency submit. During Tuesday plenary, lawmakers introduce the Executive-sponsored Constitution Alteration Bill and quickly pass am through first and second reading. After debate, the House send the bill go Committee on Constitutional Review make dem examine all the provisions, safeguards and how the […]

todayJuly 14, 2026 13

Lagos

Lagos Gornment Vow To Drag X User Go Court Over Fake Flood Video Wey He Post

By: Esther Daniel Lagos State Gornment don threaten to carry one X user wey people dey call Enugu Loudspeaker go court on Tuesday, after di person post fake video of flood con claim say na Lagos e happen. Oga Tokunbo Wahab, disclose dis one for X, as he talk say di user break di law when e share misleading video wey no even originate from Lagos at all. Wahab warn […]

todayJuly 14, 2026 18

Lagos

Lagos Gornment Arrest Mama Wey Send Her Pikin Go Pour Dirty Inside Gutter

By: Yusuf Abuh Lagos State Gornment don arrest one woman, Mrs McCarthy, for No. 56 Adaranijo Street, Pedro inside Shomolu on Monday, after she send her pikin go pour dirty inside covered gutter. Lagos State Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, wey disclose dis arrest on top im official X account, warn say any parent wey dey push their pikin to break environmental laws go face heavy punishment. […]

todayJuly 14, 2026 8

Sports

Celtic Hold Talks With Iheanacho Over New Deal

By: Yusuf Abuh Celtic manager Martin O’Neill don Konfam say di club don make Kelechi Iheanacho offer as talks continue for di striker to return to the team. Iheanacho contract with di Scottish champions end last month after e join di club last September on one-year deal. Even though injury affect him and reduce his playing time, di former Manchester City striker still make strong impact with important goals for […]

todayJuly 14, 2026 11

Sports

Osimhen To Hit Classroom Again After Football

By: Yusuf Abuh Super Eagles striker Victor Osimhen don reveal say e plan to go back school and get university degree despite him success for football. Di Galatasaray forward tuk say football don teach am plenty things, an dat school naim be di way after football for am. Osimhen say life lessons dey come from everyday experiences, but e believe say learning for classroom still get value. Di 2023 African […]

todayJuly 14, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds