Blog horizontal

Background

Lagos

Gateman Pack Full Dorti Throway Inside Gutter

Di Lagos state government don gbab one man wey dey throway dorti inside gutter for No. 18 Oluoga Ikorodu on Tuesday. Dis one dey for inside video wey di commissioner for environment and water resources, Tokunbo Wahab post for Instagram on Tuesday. Inside di video, Mr John Ehidreme, wey be gateman for one school carry one full bin of dorti dey pour am inside gutter, another woman sef no carry […]

todayJuly 14, 2026 15

obodo oyinbo

Ribadu, Top US Official Meet to Boost Security Partnership

By : Jolayemi Olajide National Security Adviser Nuhu Ribadu don meet with senior United States delegation wey Frank Garcia, di new US Assistant Secretary of State for African Affairs, lead to strengthen security partnership between both countries. Di meeting happen for Abuja on Monday and na Garcia first official visit to Nigeria since e resume office on June 1, 2026. Ribadu talk say both sides discuss how to improve long-standing […]

todayJuly 14, 2026 17

obodo oyinbo

US Bomb Iran Again as Trump Plan New Port Blockade

By : Jolayemi Olajide US don carry out another round of air strikes on Iran as the fight between both countries continue to increase. President Donald Trump announce plan for im truth social to place fresh blockade on Iranian ports and add 20 percent charge on goods moving through Strait of Hormuz. US military say dem hit different targets inside Iran to weaken the country’s ability to attack ships, while […]

todayJuly 14, 2026 10

Sport Yarns

Messi Set to Battle England as 39-Year-Old Legend Chases Another World Cup Glory

By : Jolayemi Olajide Lionel Messi go finally face England for di first time in im career as Argentina and England prepare for Wednesday World Cup semi-final. Di 39-year-old captain just play im 200th match for Argentina after dem beat Algeria for di group stage, and e still dey hope to carry im country reach another World Cup final. Messi international journey start for 2005 when e make im debut […]

todayJuly 14, 2026 14

Sports

Lamine Yamal Put Pressure For France Body

As di 2026 World Cup don enter Semi Finals, Spain and France go play by 8pm dis night, na so tension dey full bodi. But Spanish wonder boy, Lamine Yamal no send either tension or pressure as e go post picture of di 5-4 victory wey Spain knack give France for 2025 UEFA Nations League Semi Finals. Yamal drop dis post for him Instagram story on Tuesday to remind France […]

todayJuly 14, 2026 20 1

Lagos

How Unknown Gunmen Kpai Lagos transport Secretary, Ijaya

By : Jolayemi Olajide Nor be small tin oh, Lagos National Union of Road Transport Workers, NURTW Organising Secretary, Toba Ajiboye, wey people know as Ijaya wey do lose im life after unknown gunmen attack am for Ikorodu Road. Report say the gunmen block im motor for night as e dey return from Fadeyi, come open fire and scatter the motor with bullets. Though first report talk say Ajiboye survive […]

todayJuly 14, 2026 10

OBODO NAIJA

Court Order Make Police Arrest Self-Claimed PFIPC Oga Adeyemi

By : Jolayemi Olajide Justice Muhammed Umar of Federal High Court for Abuja don order make police arrest Adeniyi Adeyemi after e no show for court to answer the charges against am. Adeyemi, wey dey call himself Director-General of Presidential Foreign Investment Promotion Council, suppose take plea for eight-count charge wey involve forgery, fraud and impersonation. Even though one lawyer, Genesis Francis, appear for am, the defendant no come court […]

todayJuly 14, 2026 10

south west

Senate explain to Makinde why im need to dey careful with security mata

By : Jolayemi Olajide Senate don warn Oyo State Govo, Seyi Makinde, say make e no dey make statement wey fit spoil Federal Gornment and security agencies effort to fight terrorism and kidnapping, after e call on United Nations make dem investigate the abduction of school children and teachers for Oriire Local Government Area. Senate give di warning after dem discuss motion wey Senate Leader Opeyemi Bamidele bring about di […]

todayJuly 14, 2026 12

National

Reps Drop Dia State Police Bill, Follow Presidency Own

By : Jolayemi Olajide House of Representatives don suspend work on dia own constitutional amendment bill for state police and decide to continue with similar bill wey Presidency submit. During Tuesday plenary, lawmakers introduce the Executive-sponsored Constitution Alteration Bill and quickly pass am through first and second reading. After debate, the House send the bill go Committee on Constitutional Review make dem examine all the provisions, safeguards and how the […]

todayJuly 14, 2026 13

Lagos

Lagos Gornment Vow To Drag X User Go Court Over Fake Flood Video Wey He Post

By: Esther Daniel Lagos State Gornment don threaten to carry one X user wey people dey call Enugu Loudspeaker go court on Tuesday, after di person post fake video of flood con claim say na Lagos e happen. Oga Tokunbo Wahab, disclose dis one for X, as he talk say di user break di law when e share misleading video wey no even originate from Lagos at all. Wahab warn […]

todayJuly 14, 2026 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds