Blog horizontal

Background

obodo oyinbo

UN Beg World Pipo To Stop Di Killings For Sudan

By: Esther Ayoola UN human rights chief Volker Türk don beg di world make dem stop di killing and war crimes wey dey happen for Sudan. Di war between di national army and di Rapid Support Forces (RSF) don dey go for almost three years and no sign say e go stop anytime soon. Survivors tuk say RSF don kpai plenty pipo for El Fasher, some because of dia non-Arab […]

todayFebruary 10, 2026 5

Sports

Chukwuebuka Enekwechi Finish Fifth For Madrid Shot Put

By: Esther Ayoola Olympic finalist Chukwuebuka Enekwechi, for men’s shot put, don muscles finish fifth for Madrid World Indoor Tour afta him throw 20.38 metres for men shot put. Di Naija record holder try wella as him compete with plenty world-class athletes wey dey throw pass 21 metres early for season. American Jordan Geist carry di first place, as e match him world lead with 22.04m. Jamaica man Rajindra Campbell […]

todayFebruary 10, 2026 6

Sports

Chelle Explain Wetin Sup Between Osimhen, Lookman For AFCON 2025

By: Esther Ayoola Super Eagles coach, Éric Chelle, don tok for di first time about wahala wey happen between Victor Osimhen and Ademola Lookman for 2025 AFCON. Di fight hapun during Nigeria Round of 16 match wey dem play against Mozambique. Chelle tuk for interview say, for di pitch, Victor tell Lookman say, Make im stop to dey play in front of goal, say na di gbege wey hapun be […]

todayFebruary 10, 2026 5

Sports

Man City Last-Minute Winner Open EPL Title Race

By: Esther Ayoola Man United legend, Roy Keane, say Manchester City wining Liverpool for last minute na big wahala for Arsenal Premier League title hope. Pep Guardiola team dey six points behind Arsenal, but dis win still keep pressure. Erling Haaland score penalty for stoppage time make City carry all three points comot Anfield. If dem beat Fulham next, City fit reduce Arsenal lead for table to just three points.

todayFebruary 9, 2026 13

Sports

Naija Footballer Ola Kpai Afta Brain Wunjury, Wife And Small Pikin Land UK

By: Esther Ayoola Cry cry never still dey stop afta di death of Nigerian footballer, Saburi Adeniji wey people sabi as Ola, afta e wife and small pikin reach UK just one day afta him pass away. Adeniji wey be left winger for Kings Park Rangers Football Club for Sudbury, die on Friday morning afta e suffer serious brain stem injury. According to di club, di 26-year-old try fight for […]

todayFebruary 9, 2026 9

Sports

Tennis Star Adeleye Carry Naija Enter Davis Cup Round Two

By: Esther Ayoola Naija number one tennis player, Daniel Adeleye, once again don make Nigeria proud,  beating Uzbekistan 3-1 for Davis Cup World Group II play-offs for Lagos Lawn Tennis Club on Sunday. Afta di first day tie finish 1-1, Nigeria win di doubles match as Canice Abua and Michael Emmanuel beat Denis Istomin and Khumoyun Sultanov 7-6, 6-4. For di reverse singles, Adeleye come through again, beat Ilya Ignatov […]

todayFebruary 9, 2026 4

Sports

Pyramids Blow Rivers United 4–1, konfam Top Spot

By: Esther Ayoola Pyramids FC don konfamate demself as number one for Africa and Group A for 2025/26 CAF Champions League afta beating Rivers United 4–1 for Uyo on Sunday. Rivers United shock fans when Stephen Manu score first for 33rd minute with correct long-range goal. But Pyramids come back for second half, show power, and turn di game around sharp sharp. With dis win, Pyramids don secure quarter-final spot […]

todayFebruary 9, 2026 4

Sports

Ikorodu City Enter Top Of NPFL Beating Niger Tornadoes

By: Esther Ayoola Ikorodu City don climb di top of Nigeria Premier League table afta beating Niger Tornadoes 2–0 for home on matchday 25. Joseph Arumala na him score both goals wey carry Oga Boys reach 41 points, level with Rivers United and Nasarawa United but dem dey ahead on goal difference. Inside di beta support for Mobolaji Johnson Arena, Ikorodu control di game and show say dem be title […]

todayFebruary 9, 2026 4

obodo oyinbo

Iran Arrest Four Politician Dem, Say Dem Dey Scarra U.S

By: Esther Ayoola Iran police on Sunday don arrest four persons, say na dem dey try “scatter di country” and work “for Israel and US side” particularly during January protest. According to report, Three of dem na big reform politician, say Azar Mansouri (head of Reform Front), Mohsen Aminzadeh (former diplomat), and Ebrahim Asgharzadeh (former lawmaker). Di fourth person dem nor tuk di name, but court say dem di pipo […]

todayFebruary 9, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app