Blog horizontal

Background

National

Rauf Aregbesola Reject Move Say Im Nor Dey Return To Im Former Ex, APC

By: Esther Ayoola Former Osun state Govo, Rauf Aregbesola don clear di air, say e sti dey with African Democratic Congress and no plan to go back to im ex, All Progressives Congress. Im yarn dis one for meeting inside Ilesa on Sunday, Aregbesola tell party members from all 332 wards say rumour about im return to APC na pure lie. Di former Osun State govo sti use di meeting […]

todayMay 11, 2026 12

OBODO NAIJA

Gunmen Kpai UNIBEN Student for Campus Gate After Exam

By : Jolayemi Olajide A yet-to-be-identified part-time political science student of di University of Benin (UNIBEN) don reportedly kpai after im collect bullet inside im car  for  main gate, Ugbowo campus. According to video wey surface online, dem kpai di student shortly after im finish semester exam, though authorities never fully Konfam that part of the story. UNIBEN management don distance students and staff from di incident, saying di shooting […]

todayMay 11, 2026 12

National

Vice Presido Shettima Vow To Speed Law To Deliver Ogbonge Public Administration

By: Esther Ayoola Vice Presido, Kashim Shettima don assure, say Federal Gornment go reach out to important stakeholders make dem pass ogbonge amendment bill to change Naija administration wey dey before National Assembly. Say dis bill go change name of Institute of Chartered Secretaries and Administrators of Naija (ICSAN) to match modern governance level and also expand dia doings. Shettima tuk dis one when ICSAN delegation led by Presido and […]

todayMay 11, 2026 12

National

Reactions To NDC Zoning 2027 Presidential Ticket Go South

By: Esther Ayoola Say Senator representing Anambra Central, Victor Umeh don praise di Nigerian Democratic Congress for zoning dia 2027 presidential ticket go South, say e go hellep keep Naija unity strong. Im yarn dis one for TV sit don tuk on Sunday. E tuk say di arrangement na strategic move wey show North and South power balance, and say delegates support di decision for dia convention.

todayMay 11, 2026 8

National

Rivers Political Crisis Hit Anoda Level As APC Fail To Konfam Fubara Screening For 2nd Term

By: Esther Ayoola Say confusion Gadima, why All Progressives Congress nor gree konfam di screening for suspended Rivers State Governor, Siminalayi Fubara, afta im show face for dia ongoing screening of governorship aspirants. In fact, as di mata take hot reach, Party National Secretary, Ajibola Basiru, clear journalists on Sunday wetin really play but dodge all di question on whether dem screen di governor. E neither konfam nor deny if […]

todayMay 11, 2026 11

National

Six APC Kano Aspirants Dump Race, Rally Behind Shekarau For Senate Seat

By: Esther Ayoola Six aspirants for All Progressives Congress, Kano Central senatorial seat don pull out from di race ahead of 2027 election. Say dem reach agreement to support former Kano State Govo, Ibrahim Shekarau. Di decision hapun for high-level meeting wey Governor Abba Yusuf call for Abuja on Sunday, and di tuk last for several hours. Di aspirants explain why dem step down, say na to bring unity and peace for Kano State.

todayMay 11, 2026 11

Lagos

Lagos Police Save Four Kidnap Pikin, Return Dem Giv Dia Families

Lagos State Police don rescue four pikin wey kidnappers carry, and don return dem back give dia families after one patrol operation wey happen for Alafia Bus Terminal, Coker-Orile for Lagos. Dis one dey for inside statement wey Lagos State Police Public Relations Officer, SP Abimbola Adebisi, release on Sunday, say on 8th of May, 2026, around 11:40pm, as police officers dey do routine patrol around Alafia Bus Terminal, Coker-Orile, […]

todayMay 10, 2026 20 1

OBODO NAIJA

EFCC Declare Former Minister Sadiya Farouq Wanted

EFCC don declare former Humanitarian Affairs Minister, Sadiya Farouq, wanted over allegation say she divert government money, abuse her office, and join hand for criminal conspiracy. Di anti-corruption agency put di notice for dia website on Saturday, tell members of di public say anybody wey know where she dey make dem alert EFCC sharp-sharp. According to di commission, anybody wey get useful information fit report for any EFCC office for […]

todayMay 9, 2026 16

Politics

Obi Get Green Light as NDC Zone Presidential Ticket to South

Nigeria Democratic Congress (NDC) don reserve dia 2027 presidential ticket for Southern Nigeria, and many people dey talk say dis move fit boost former Anambra State Governor, Peter Obi chance well-well. Dem make di announcement on Saturday during dia national convention wey dey happen for Abuja. Di party still confirm am for dia official X handle, as dem post say, “NDC presidential ticket don go South!” Top party big men […]

todayMay 9, 2026 18

obodo oyinbo

US Wan Rush Comot Americans From Hantavirus Ship

United States don talk say dem dey arrange evacuation flight to carry Americans wey dey inside one cruise ship wey hantavirus don affect, as di ship dey head go Canary Islands. According to one spokesperson from di U.S. State Department, government dey work to make sure say all American passengers return home safely. Dem also talk say dem dey cooperate with government of Spain and other U.S. agencies to handle […]

todayMay 9, 2026 15 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds