Blog horizontal

Background

Lagos

Residents Scoop Diesel As Tanker Fall For Gbowai Apapa

By: Esther Ayoola Say nor be small traffic for Liverpool Bridge, Apapa, Lagos State on Monday, dat One diesel tanker fall gbowai for ground and na so resident carry keg dey go fetch di fuel for road, forgetting say e fit explode. Lagos State Traffic Management Agency (LASTMA) ni dey clear konfam news on Monday. According to LASTMA, dem don succeed divert di traffic to di other side of di […]

todayJanuary 19, 2026 11

Lagos

Two Kpai, Plenti Wunjor For Lagos-Ibadan Expressway Askident

By: Esther Ayoola Say, nor be small gobe for area, at least two pipo say ni kpai on Sunday for Lagos-Ibadan Expressway, Kara Bridge side, near Mowe, afta some motors jam demsleves. According to di Lagos state Traffic management agency tuk tuk, Adebayo Taofiq, say di accident happen when one truck wey dey carry bags of flour lose control, ram several commercial buses and one parked Toyota Corolla, wey wunjor […]

todayJanuary 19, 2026 8

Sports

AFCON 2025 Award Winners

By: Esther Ayoola Senegal don become champions of 2025 Africa Cup of Nations afta dem beat Morocco 1–0 for extra time for final wey happen for Rabat on Sunday. Pape Gueye score di winning goal for 94th minute afta normal time finish 0-0. Di final still get wahala as VAR show say Morocco get late penalty wey Brahim Diaz miss afta Senegal goalkeeper Edouard Mendy save am. Despite pressure from […]

todayJanuary 19, 2026 24 2

Sports

Senegal Shock Morocco, Win Second AFCON Title

By: Esther Ayoola Senegal don win dia second Africa Cup of Nations trophy afta dem beat Morocco 1–0 for extra time for Rabat on Sunday. Di final wey  wahala yanfuyanfu, see Senegal lift di trophy against all odds, Pape Gueye goal settle am for Senegal side. U sabi say, Senegal play dia fourth final yesterday, win dia first for 2021, while Morocco dey try im second final since 2004.

todayJanuary 19, 2026 10

obodo oyinbo

Syrian Government, SDF Agree Ceasefire

By: Esther Ayoola Syrian government share update, say dem don reach agreement with Kurdish-led  Syrian Democratic Forces, SDF,  say make dem stop to kill dia self. Dis agreement  dey come  days afta plenty fight, fight between di Syrian gornment and di SDF for  northeastern Syria. According to report, SDF go comot from area wey dey west side of River Euphrates. Syrian Presido Ahmed al-Sharaa tuk on Sunday say, gornment go […]

todayJanuary 19, 2026 11 6

National

Police Catch Man Wey Help Enugu Native Doctor Kill Six-Year-Old Girl

By: Esther Ayoola Police for Anambra, like jet li don arrest one pikin wey dey work with Enugu native doctor, Obieze Ezeani wey dem dey call E Dey Play E Dey Show, for di abduction and murder of six-year-old girl, According to police tuk, tuk, SP Tochukwu Ikenga, say, Di suspect, Friday Akonobi, 28, dem catch am for Awkuzu early momo on January 17, 2026. SP Ikenga say Akonobi, join […]

todayJanuary 19, 2026 6 4

National

VP Shettima Land Davos To Lead Nigeria For World Economic Forum

By: Esther Ayoola Vice President Kashim Shettima don land Davos for Switzerland to lead Nigeria delegation for 56th World Economic Forum wey go hold from January 19 reach 23, 2026. Before dis, e waka Conakry, Guinea, to represent President Bola Tinubu for di inauguration of President Mamadi Doumbouya last Friday. On arrival, Minister of Foreign Affairs Yusuf Tuggar, Minister of Industry, Trade and Investment Dr Jumoke Oduwole, plus officials from […]

todayJanuary 19, 2026 9

National

Police Enter Bush For Osun Jaguda Boys Say Dem Kpai Ex-NURTW Boss

By: Esther Ayoola Osun Police don start investigation into di killing of former NURTW unit chairman, Kazeem Oyewole, wey suspected hoodlums allegedly Kpai for Osogbo on Sunday. Di murder cause gbege for some motor parks as people wey sabi Oyewole dey waka around dey find those wey dem think kill am. Oyewole, wey be part-time chairman of NURTW Aregbe Unit from 2018 to 2022, get attack around Elelede Junction for […]

todayJanuary 19, 2026 7

National

African Ministers Re-Elect Nigeria’s Dele Alake As AMSG Chairmo

By: Esther Ayoola African ministers of solid minerals don re-elect Nigeria Minister of Solid Minerals, Dr Dele Alake, as Chairmo of Africa Minerals Strategy Group (AMSG). Dem re-elect am for di 2026 AGM wey sup for Riyadh, Saudi Arabia, during Future Minerals Forum, afta e don first serve as pioneer chairman since 2024. Speaking on Sunday afta di elections, Alake urge African countries make dem join hand use solid minerals […]

todayJanuary 19, 2026 4

National

HEDA Carry Oyo N30bn Mata Go EFCC

By: Esther Ayoola Di Human and Environmental Development Agenda (HEDA) don carry mata go Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) over how Oyo State use N30bn wey Federal Government release afta Bodija explosion for January 2024. HEDA tell aproko pipo on Sunday, say dem dey fear say di money for compensation, reconstruction, and emergency relief no enter wia e suppose enter. According to HEDA, only about N4.5bn of di fund […]

todayJanuary 19, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app