By: Esther Ayoola
Di Human and Environmental Development Agenda (HEDA) don carry mata go Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) over how Oyo State use N30bn wey Federal Government release afta Bodija explosion for January 2024.
HEDA tell aproko pipo on Sunday, say dem dey fear say di money for compensation, reconstruction, and emergency relief no enter wia e suppose enter.
According to HEDA, only about N4.5bn of di fund don reach victims, while di rest of di money dey mia.
Dem dey ask EFCC make dem investigate who divert or misuse di N30bn.