Blog masonry

Background

National

Police Catch Man Wey Help Enugu Native Doctor Kill Six-Year-Old Girl

By: Esther Ayoola Police for Anambra, like jet li don arrest one pikin wey dey work with Enugu native doctor, Obieze Ezeani wey dem dey call E Dey Play E Dey Show, for di abduction and murder of six-year-old girl, According to police tuk, tuk, SP Tochukwu Ikenga, say, Di suspect, Friday Akonobi, 28, dem catch am for Awkuzu early momo on January 17, 2026. SP Ikenga say Akonobi, join four oda pipo wey still dey run to give virgin […]

todayJanuary 19, 2026 6 4

National

VP Shettima Land Davos To Lead Nigeria For World Economic Forum

By: Esther Ayoola Vice President Kashim Shettima don land Davos for Switzerland to lead Nigeria delegation for 56th World Economic Forum wey go hold from January 19 reach 23, 2026. Before dis, e waka Conakry, Guinea, to represent President Bola Tinubu for di inauguration of President Mamadi Doumbouya last Friday. On arrival, Minister of Foreign Affairs Yusuf Tuggar, Minister of Industry, Trade and Investment Dr Jumoke Oduwole, plus officials from Nigerian mission for Switzerland, receive am well. Shettima go join […]

todayJanuary 19, 2026 9

National

Police Enter Bush For Osun Jaguda Boys Say Dem Kpai Ex-NURTW Boss

By: Esther Ayoola Osun Police don start investigation into di killing of former NURTW unit chairman, Kazeem Oyewole, wey suspected hoodlums allegedly Kpai for Osogbo on Sunday. Di murder cause gbege for some motor parks as people wey sabi Oyewole dey waka around dey find those wey dem think kill am. Oyewole, wey be part-time chairman of NURTW Aregbe Unit from 2018 to 2022, get attack around Elelede Junction for afternoon, but di full story no clear as at press […]

todayJanuary 19, 2026 8

National

African Ministers Re-Elect Nigeria’s Dele Alake As AMSG Chairmo

By: Esther Ayoola African ministers of solid minerals don re-elect Nigeria Minister of Solid Minerals, Dr Dele Alake, as Chairmo of Africa Minerals Strategy Group (AMSG). Dem re-elect am for di 2026 AGM wey sup for Riyadh, Saudi Arabia, during Future Minerals Forum, afta e don first serve as pioneer chairman since 2024. Speaking on Sunday afta di elections, Alake urge African countries make dem join hand use solid minerals push economic growth and industrial development across di continent.

todayJanuary 19, 2026 4

National

HEDA Carry Oyo N30bn Mata Go EFCC

By: Esther Ayoola Di Human and Environmental Development Agenda (HEDA) don carry mata go Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) over how Oyo State use N30bn wey Federal Government release afta Bodija explosion for January 2024. HEDA tell aproko pipo on Sunday, say dem dey fear say di money for compensation, reconstruction, and emergency relief no enter wia e suppose enter. According to HEDA, only about N4.5bn of di fund don reach victims, while di rest of di money dey […]

todayJanuary 19, 2026 8

National

Makinde Promise ₦5m Each, Scholarship For Forest Guards Pikins

By: Esther Ayoola Oga Govnor of Oyo state,  Seyi Makinde don announce say im go pay ₦5 million each to di families of di five Forest Guards wey Jaguda boys Kpai for Old Oyo National Park. Makinde tuk dis one when e visit Oloka Village for Oriire Local Government Area to check di place wey di incident happen. In addition, e promise to give scholarship, reach university level for di children of di guards, come sti konfamate dat, di gornment […]

todayJanuary 19, 2026 5

Lagos

Lagos Police Activate CCTV Centre To Rascal Jaguda Boys

By: Esther Ayoola Lagos State Police Command don activate CCTV Surveillance Centre to strengthen security for Lagos Island and nearby areas. Police Commisioner, Olohundare Jimoh, tuk say di centre go help police monitor activities beta and respond fast to any security threat. CP Olohundare Jimoh visit area for third mainland bridge, explain dat, dis one sef go make di catching of Jaguda boys go wiririwere, as dem go dey monitor everyone from TV for office.

todayJanuary 19, 2026 12

Lagos

Sanwo-Olu Charge Lagos Councillors Make Dem Package Well For Grassroots Pipo

By: Esther Ayoola Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don open onboarding and retreat programme for councilors for Lagos, tell dem make dem do dia touch lighting work with boldness. Govo Sanwo Olu gather di councillors from all 377 wards of Lagos for Lekki to train dem, share policy ideas, and guide dem on legislative work. Lagos state govo, wey im special advicer on environment, Olakule, Rotimi Akodu, represent, remind di councillors say, dia office na chance to serve people for […]

todayJanuary 19, 2026 5

Sports

Joshua Return Training After Crash, Im Go Decide Whether To Continue

By: Esther Ayoola Senior Boxer, Anthony Joshua go soon decide im future for ring “when time reach,” Dis na according im promoter, Eddie Hearn, untop post for social media. Joshua, wey be 36 years, survive one car crash wey hapun for near Lagos on December 29, wey kill im two close mehn, him coach Sina Ghami and trainer Latif ‘Latz’ Ayodele. Hearn tuk say Joshua don dey train again, e even share video for Snapchat wey e dey hit pads, […]

todayJanuary 16, 2026 34 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app