Blog masonry

Background

National

Tinubu Message National Assembly To Increase 2026 Budget To ₦67.4 Trillion

Wi oga Presido, Bola Tinubu don write National Assembly make dem increase di 2026 budget by ₦9 trillion, from ₦58.4 trillion go ₦67.4 trillion. Oga Senate Presido, Godswill Akpabio, read di letter for Senate floor on Tuesday. Tinubu tuk say di increase go hellep manage gorment mata wella . E also say e go cover past legal commitments, manage gornment debt, and fund few important projects without stress for domestic market.

todayMarch 31, 2026 15

obodo oyinbo

How Iran Fires Missiles Across Middle East

Say like dis Iran don fire missile across Middle East afta fresh explosion hapun for Tehran on Tuesday According to local media, say di thing cause power cut for parts of di city. Nor be amebo say US Presido, Donald Trump tuk say e fit attack Iran oil hub, power stations, and water plants to stop dia threat, as dia peace tuk nor dey get head. Israel Prime Minister Benjamin Netanyahu say more than half of dia military target don […]

todayMarch 31, 2026 14

National

Oga Presido Tinubu Send Letter Of $6B Foreign Loan To Senate

Wi oga Presido Bola Tinubu, don enter senate again dey ask dem to approve $6 billion loan from outside to help run gornment. Na for two separate letters request  him send to Senate President Godswill Akpabio and naim im put dis one and dem read during Tuesday’s plenary. For one letter, e dey seek $5 billion from Abu Dhabi Bank to hellep finance budget. For another letter, e ask for $1 billion from Citibank for fix key port work like […]

todayMarch 31, 2026 11

National

New Ogun Cp Ojajuni Officially Report For Duty Post

Ogun State new Police Commissioner, Bode Ojajuni, don resume work yesterday for Ogun State say im go ensure law and order Di CP say im go make sure say im officers respect pipo rights and follow law and rules. Ojajuni con sti beg bed di public make dem dey respect police and join hand with dem to fight crime

todayMarch 31, 2026 15

National

President Tinubu Tell Security Make Dem Hunt Killers Weh Attack Plateau, Kaduna

Wi oga Presido, Bola Tinubu don tell security mehn make dem hunt down di jaguda boys wey dey behind di killings for Plateau State and Kaduna State. Nor be amebo say Gunmen kpai about 28 pipo for Angwan Rukuba, Jos, and some others attack Kahir village for Kaduna, kill plenty pipo. Tinubu say di kpaing and wedding abduction na shame for Naija and make security agencies dey pursue di criminals plus people wey dey spread fake news. E also urge […]

todayMarch 31, 2026 13

National

Former Deputy Kano State Govo Gawuna Catapult From APC

Former Kano State deputy governor, Nasiru Gawuna, don resign from All Progressives Congress. Im write letter go di APC chairmo for Gawuna Ward, Nassarawa Local Government Area,  say na im own personal decision, and e effective March 29, 2026. Gawuna thank di party for di opportunity wey e get as member. Him resignation follow im 2023 governorship ambition for APC wey nor work and aside dat one, im nor give any reason.

todayMarch 31, 2026 14

National

FG Get Approval From UK, US, France, Others To Send Ambassadors

Federal Gornment don konfam say some countries don approve Naija ambassador nominees, including United Kingdom, France and United States, as dem dey try fill empty diplomatic positions. Foreign Affairs Ministry tuk, tuk, Kimiebi Ebienfa, tuk dis one for statement wey dem release on Monday, say about ten countries don give approval so far. Dem call dis approval “agrément”, wey mean say di kontry don accept di ambassador, so di person fit start work officially. Other countries wey don gree include […]

todayMarch 31, 2026 11

Sports

Kenya Drop $30m, Secure 2027 AFCON Hosting Slot

Kenya don pay $30 million give Confederation of African Football to secure dia place as one of di countries wey go host 2027 AFCON. Minister for Sports, Salim Mvurya, naim share dis update to tori pipo, say dis payment show say Kenya readiness. E sti mention say gornment don set up new Multi-Agency Local Organizing Committee to plan everything.

todayMarch 31, 2026 12

Sports

Ghana Football Association Sack Otto Addo Afta Germany Friendly Loss

Ghana Football Association don sack coach Otto Addo on Tuesday, few hours afta dem lose friendly match 2-1 to Germany for Stuttgart. Na late goal from Deniz Undav make Germany win di match, as e be say Ghana don lose four matches back-to-back, including 5-1 beating from Austria last week. GFA thank Addo for im work but say dem go soon announce new coach as Black Stars dey prepare for FIFA World Cup wey go happen for North America. Ghana […]

todayMarch 31, 2026 20

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds