Blog masonry

Background

Sports

Super Eagles Sweep AFCON Group Stage

By: Esther Ayoola Super Eagles of Nigeria don finish AFCON Group C with 100% win record, beating Uganda 3-1 to finish top of di group. Before dis game, Nigeria already beat Tanzania 2-1 and beat Tunisia 3-2, so dem collect 9 points finish di group stage. For di final group match, Super Eagles open scoring 28th minute through Paul Onuachu, and Raphael Onyedika add two quick goals for second half make am 3-0 before Uganda get small consolation goal. With […]

todayDecember 31, 2025 11

obodo oyinbo

UAE Comot Bodi From Yemen Terrorism Fight

By: Esther Ayoola United Arab Emirates don announce on Tuesday say dem dey withdraw dia forces from Yemen, ending wetin dem call “counterterrorism” operations, afta Saudi Arabia accuse Abu Dhabi of supporting separatists. Yemen’s internationally recognised government demand say make UAE pull dia troops within 24 hours, a call wey Saudi Arabia support, because dem no wan foreign interference wey fit destabilise di country. Earlier for Tuesday, Saudi-led coalition attack southern Yemeni port Mukalla, targeting weapons shipment wey dem say […]

todayDecember 31, 2025 9

National

Kwankwaso Charge Those Weh Wan Japa From NNPP

By: Esther Ayoola Leader of New Nigeria Peoples Party (NNPP), Rabiu Musa Kwankwaso, don sama beta warning to im members wey dey reason to waka from di party say political betrayal no dey bring long-term success. E tuk say, as e dey meet supporters for im house for Kano, afta reports say some members, including Kano State Governor Abba Kabir Yusuf, dey plan to comot from party. Kwankwaso say e no go surprise, if dem nor succeed for dia new […]

todayDecember 31, 2025 8

National

Rivers Lawmakers Reject N100,000 Christmas Bonus

By: Esther Ayoola Rivers State House of Assembly on Tuesday tuk say dem reject N100,000 wey dem credit for each lawmaker account as Christmas bonus, wey Governor Siminalayi Fubara allegedly approve. Di Chairman of House Committee on Information, Petitions and Complaints, Enemi George, na im sign di statement. Dem say di money no follow due process because all public spending suppose get legislative approval before e fit enter account. According report, di lawmakers don start return di funds and warn […]

todayDecember 31, 2025 7

Lagos

Lagos, TEC Giant Open Sanwo-Olu Mini Stadium For Sura

By: Esther Ayoola Lagos State Government join bodi with TEC giant don di ogbonge launch Sanwo-Olu Mini Stadium, eight-a-side astroturf pitch for Sura under bridge, Lagos Island. Governor Babajide Sanwo-Olu say di project na part of him plan to encourage youth and promote sports development. DG of Lagos State Sports Commission, Lekan Fatodu, thank TEC experts for dia  support and youth empowerment.

todayDecember 31, 2025 12

Sports

Aruna Quadri Finish 2025 As Africa No. 1 Table Tennis Player, 28th For World

By: Esther Ayoola Nigeria table tennis star, Aruna Quadri, don finish 2025 as Africa number one, International Table Tennis Federation ranking show on Tuesday. Quadri wey don hold Africa top for most part of the year, end the season 28th for world with 1,065 points, the only African wey pass 1,000 points for men ranking. Egypt player Omar Assar follow, e dey 32nd for world with 965 points according to 2026 Week 1 ranking. The 37-year-old Nigerian collect him points […]

todayDecember 31, 2025 14

National

Governor Otti Clear Matas Dat Im Support Obi Move To ADC

By: Esther Ayoola Abia State Governor, Alex Otti, don clear say e no get plan to waka comot from Labour Party like Peter Obi wey be 2023 presidential candidate. Otti tuk dis one on Tuesday during him monthly media briefing wey hold for Umuahia, Abia State capital. Governor yarn say Peter Obi don personally tell am say e wan leave Labour Party. Otti add say e dey fully support Obi decision and respect the choice wey Obi don make.

todayDecember 31, 2025 17

National

PDP Explain Why Governors Dey Defect To Di APC

By: Esther Ayoola Di Pipos Democratic Parti don put accusation for wi Federal Government head, say, dem dey marginalise governors, ni make everi bodi dey run enter all progressives congress. PDP tuk, tuk, Ini Ememobong, clear dis one for TV sitdon tuk, say many governors wey don leave PDP dey do am to “connect to centre make dem fit carry benefits go back dia states.” E add say, di Tinubu government no dey treat all parties equal, and e dey […]

todayDecember 31, 2025 5

obodo oyinbo

Operation Hadin Kai Troops Catch Suicide Bomber

By: Esther Ayoola Troops of Operation Hadin Kai don record big win for Borno State as dem arrest one suspected suicide bomber. The man, Abubakar Mustapha, say bindey Banki town for Bama LGA wia security agents catch am with materials wey fit make Improvised Explosive Devices (IEDs). Lt. Col. Sani Uba talk say preliminary investigation show say Mustapha dey plan attack and dem dey interrogate am to find him sponsors and collaborators. For another operation, troops for Cameroon–Nigeria border stop […]

todayDecember 31, 2025 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app