Blog masonry

Background

National

EU Say Dem Ready Tighten Security Bond With Naija

By; Rilwan Agbomeji Di European Union and Nigeria don agree to tighten dia security and defence relationship to tackle di security wahala for di country. Dis one happen on Wednesday for Abuja, wen EU Ambassador to Nigeria and ECOWAS, Gautier Mignot, visit di Chief of Defence Staff, General Olufemi Oluyede, for Defence Headquarters. Mignot congratulate Oluyede on im new appointment and talk say EU ready support Naija with stronger defence cooperation. Di move na part of EU plan to work […]

todayDecember 18, 2025 6

Lagos

TIME Africa Give Sanwo-Olu Big Shout For Road Work, City Upgrade For Lagos

By: Rilwan Agbomeji Lagos Governor, Babajide Sanwo-Olu, don collect 2025 TIME Africa Special Recognition Award for di big road, transport, and city work wey im dey run. TIME Africa yan say di award na for di way Lagos dey handle long-standing city gbege with steady investment for roads, hospitals, schools, digital system, and government wahala. Dem shout Lagos as correct example how to run big African city, wey get over 24 million people. TIME Africa talk say to run Lagos […]

todayDecember 18, 2025 12

Lagos

Five Lagos, Osun Herbalists Jam Court On Top Fake $3m, €280k Waka

By: Rilwan Agbomeji EFCC don yarn say five herbalists wey dem knack for different shrines for Lagos and Osun go siddon court over fake $3.4m and €280,000 wahala. Di arrests follow petition wey talk say di herbalists scam Halima Sanni for N26 million. EFCC talk say dem dey waka dey pose as spiritual healers wey fit do cleansing and solve gbege for people life and money marras. Now di anti-graft oga don ready carry dem go court make justice catch […]

todayDecember 18, 2025 14

Niger Delta

Delta Assembly Pass 2026 State Budget Sharp Sharp for Two Weeks

By: Esther Ayoola Delta State House of Assembly, on Monday, don pass di 2026 State Budget of 1.7 trillion naira. Di approval happen for Asaba, two weeks after Govnor Sheriff Oborevwori present di budget to di House. Di new figure big pass di earlier proposal by 65.6 billion naira, as lawmakers adjust am to meet state needs. Breakdown show say 500 billion naira go for recurrent spending, while 1 trillion, two hundred and twenty nine point nine billion naira go […]

todayDecember 16, 2025 13

National

Malami Don Point Hand Give EFCC Say Dem Dey Play Wayo

By: Esther Ayoola Former AGF and Justice Minister, Abubakar Malami, don raise dust on Monday as e demand make EFCC oga rescue himself from any investigation wey concern am. Through im spokesman, Muhammad Doka, Malami allege say EFCC dey run di probe with bias, personal beef and political witch-hunt because e just comot go ADC party. Di former minister accuse anti-graft body of illegal detention, media wahala and breaking due process, say no be justice dem dey find. According to […]

todayDecember 16, 2025 11

Lagos

Lagos Go Shine – 22,000 Solar Streetlights Don Start To Hang

By: Esther Ayoola Lagos night go soon dey shine like day! State government don yarn say dem don start to hang 22,000 plus solar streetlights for every corner under Light Up Lagos Solar Streetlight Initiative. Lagos State Electrification Agency dey run di work, Ministry of Energy dey watch sharp sharp make nothing scatter. Ololade Agboola, deputy director for Public Affairs, talk am on Sunday say na so dem wan make Lagos streets dey kpata kpata bright, safe, and correct for […]

todayDecember 15, 2025 18 1

Lagos

Sanwo-Olu Dey Back Food Hustlers Make Lagos No Hungry

By: Rilwan Agbomeji Lagos Governor Babajide Sanwo-Olu don sound am clear-clear say im government ready to carry food entrepreneurs for head make Lagos no ever hungry. E drop di talk for 2025 Lagos Food Festival wey hold for Muri Okunola Park, VI, under di theme “Taste Without Borders.” Sanwo-Olu yarn say for di past eleven months, state government don roll out plenty food and agriculture support programs through di Ministry of Agriculture and Food Systems. According to am, di moves […]

todayDecember 15, 2025 14

Sports

Super Eagles Jim Jim Bodi For Cairo, 12 Players Still Dey Load

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles don kick off dia Cairo mission, as dem go hold first official training on Monday evening, after more players don touch camp ahead of di international match, Training go start 8:00pm local time for main bowl of Cairo International Stadium, with coach Eric Chelle and im technical crew dey ready to drill di boys. As at Monday morning, 11 players don report for Renaissance Hotel camp for Cairo. Di names include goalkeepers Francis Uzoho, Stanley […]

todayDecember 15, 2025 31

National

Supreme Court Give Presido Green Light To Handle Emergency, Freeze Elected Officials

By: Rilwan Agbomeji Supreme Court don back President power to declare state of emergency for any state to stop law and order breakdown or total wahala. Di apex court decide six-to-one say during emergency, President fit suspend elected officials, but di suspension gats dey within small limited time. Lead judgment by Justice Mohammed Idris yarn say Section 305 of di Constitution give President power to use special measures to restore calm when emergency rule dey. Di ruling clear say President […]

todayDecember 15, 2025 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app