Blog masonry

Background

Lagos

LASEMA Warn Drivers Afta Two Pipo Kpai For Trucks Askident

By: Esther Ayoola Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) like dis now, dey vex oh, dey, warn drivers to stop wawawa driving asap, afta two pipo kpai for askident wey hapun Thursday morning for Cele Bus Stop, Apapa-Oshodi Expressway. Untop yarnings with tori pipo, LASEMA Permanent Secretary, Dr Olufemi Oke-Osanyintolu, say, di  two 40-foot container trucks wey nor get  plate number,  collide, jam di other one wey park on im own. Oga Olufemi say, na beg im take dey beg […]

todayFebruary 20, 2026 16

Lagos

Babajide Sanwo-Olu Cleartruck Owners To Avoid Drunk Drivers

By: Esther Ayoola Oga govo, Babajide Sanwo-Olu don sama beta warning to truck and cargo motor owners, say make dem nor dey give dia motor to drunk drivers. Sanwo Olu, make am clear say, any driver wey dem catch on hard drugs go get am hot, hot from di state gorment. U sabi say, na About 1,000 officers of National Drug Law Enforcement Agency Lagos State Command, don benefit from di governor free eye care program to hellep dem stay […]

todayFebruary 20, 2026 13

obodo oyinbo

Underage Pikin Dem Full Instagram – Zuckerberg Yarn

Meta oga Mark Zuckerberg don bow head small, talk say dem slow well-well to fish out underage pikin wey full Instagram, as e stand trial for California. Families for America dey accuse Meta say dem knowingly hook children and no block those under 13 sharp sharp. Zuckerberg admit say dem don upgrade dia system, but confess say dem for move faster pass wetin dem do. Na im be di hottest witness for the case, as plenty parents drag social media […]

todayFebruary 19, 2026 11

OBODO NAIJA

Every Vote Go Count – Akpabio

Senate Presido, Godswill Akpabio don yarn say di new Amendment Electoral Act 2026 wey Presido Bola Tinubu sign go make every Nigerian vote matter. Akpabio talk say di law go stop di gbege wey dey happen when results dey waka from polling units go collation centres. E still yarn say e go fix di wahala wey Nigerians dey fear about election palava, make future elections clean and correct, say Nigerians go enjoy better election.

todayFebruary 19, 2026 18 4

Lagos

Sanwo-Olu Charge New LSSTF Board Make Dem Revive Sports

Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu don yarn make di new Lagos State Sports Trust Fund (LSSTF) board use all resources waka push grassroots, school sports, and other sporting waka for Lagos. Di board dey led by Enitan Oshodi wey be former Sports Commissioner and ITTF Africa oga, Olaposi Agunbiade na Executive Secretary/CEO. Others like Olabode Agoro, Adeniyi Adekoya, Gbolahan Onibuje and di rest go join body make sports shine. Sanwo-Olu talk say dem gats use their brain, contacts and experience […]

todayFebruary 19, 2026 12

Lagos

Sanwo-Olu Host Japan Ambassador, Promise Stronger Lagos-Japan Partnership

Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don welcome Japan Ambassador to Nigeria, H.E. Suzuki Hideo, for courtesy visit for Lagos House, Marina, as dem tuk about how to make Lagos and Japan relationship strong. Oga govo give di Ambassador special Eyo plaque as sign of honour and to show Lagos rich culture. Both men use di meeting discuss better way to improve economic cooperation, infrastructure development and investment between Lagos and Japan.  

todayFebruary 19, 2026 15

OBODO NAIJA

President Tinubu Package New Election Bill 2026

President Bola Ahmad Tinubu don sign di Electoral Act Amendment Bill 2026 into law on Wednesday, even as many Nigerians dey complain about one clause wey make electronic transmission of election results optional. Di signing hapun for Presidential Villa with Senate President Godswill Akpabio, Speaker Abbas Tajudeen, Senate Leader Opeyemi Bamidele, Deputy Speaker Benjamin Kalu and other top government officials present on wednesday. According to Tinubu, say im follow di senate bumper to bumper, saying day di bill go make […]

todayFebruary 19, 2026 10

Sports

Arsenal Blow Two-Goal Lead, Dirty Dia Title Hope

Arsenal title hope for Premier League don suffer big setback as dem throway two-goal lead and play 2-2 draw with bottom team Wolves on Wednesday night for Molineux. Bukayo Saka score early goal and Piero Hincapie add another one for second half, make am be like say Mikel Arteta boys go extend dia lead for top of di table. But Wolves no gree give up, as Hugo Bueno pull one back before late drama happen for stoppage time.  

todayFebruary 19, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds