By: Rilwan Agbomeji
Lagos Governor, Babajide Sanwo-Olu, don collect 2025 TIME Africa Special Recognition Award for di big road, transport, and city work wey im dey run.
TIME Africa yan say di award na for di way Lagos dey handle long-standing city gbege with steady investment for roads, hospitals, schools, digital system, and government wahala.
Dem shout Lagos as correct example how to run big African city, wey get over 24 million people.
TIME Africa talk say to run Lagos sharp-sharp, na big-structure and long-term solution dem need, no be small-small patch job.