By: Esther Ayoola
Six people, including one pregnant woman and five final-year nursing students, say ni kpai for one big car askident for Kwara side of Ilorin, Ogbomoso road.
FRSC Kwara commandant, Rosemary Alo, konfam say di askident hapun for Ote area for Kwara.
Alo say, Some of di victims kpai on di spot, while some others kpai for hospital.
Say di five nursing students, na 500-level students wey dey do Open and Distance Learning for one higher institution for Oyo State, say na dia  second semester exams dem bin dey write wey dis badness sup.