Blog masonry

Background

National

Dele Momodu: Atiku No Go Step Down For Obi For 2027

By: Rilwan Agbomeji One Former presidential candidate and Atiku Abubakar close friend, Dele Momodu, don clear marra, say Atiku no go withdraw from 2027 presidential race to support Peter Obi. Momodu talk dis oneĀ  on Thursday while e dey react to political talk for Nigeria, say Atiku join ADC for November 2025 afta e comot from PDP so e fit secure party ticket for 2027 election. According to am, Atiku plan am well as strategy to contest again, and no […]

todayJanuary 8, 2026 40

National

Breaking: Rivers Assembly Start Waka To Comot Govnor Fubara From Office

By: Rilwan Agbomeji Rivers State House of Assembly don start impeachment process against Governor Siminalayi Fubara and im deputy, Ngozi Oduh. During plenary wey dem show live for Television on Thursday, Speaker Martins Amaewhule preside as Majority Leader, Major Jack, read di allegations of gross misconduct against Fubara. Twenty-six lawmakers sign the notice, say di mata involve serious wahala against di Nigerian Constitution. Amaewhule tuk say dem go serve Governor Fubara di notice within di next seven days.  

todayJanuary 8, 2026 61

Sports

Adesanya Say E Nor Dey Enter Go Boxing

By: Rilwan Agbomeji UFC former two-time middleweight champion Israel Adesanya don share update on how im wan waka, say e nor go switch go boxing afta e finish for mixed martial arts (MMA). E yarn dis one during one Question & Answer session for Thailand, say e wan finish e career for UFC. Adesanya tuk say, e bin think about boxing small because of money, but e feel say MMA na di real ultimate fight. Di 35-year-old kickboxer add say […]

todayJanuary 8, 2026 21

National

Senator Oshiomhole Jim Jim Di Bodi For Okpekpe 10km Race

By: Rilwan Agbomeji Na former Edo State Govnor and current senator for Edo North, Comrade Adams Oshiomhole, say im don dey do jim jim di bodi for Okpekpe International 10km Road Race wey go hapun for May 2026. For one video wey don spread like kolta, Oshiomhole show as e dey waka train with im Okpekpe white T-shirt, show say e cover 8.92km for 85 minutes and burn 492 calories. E tuk say person no fit just wake up run […]

todayJanuary 8, 2026 35 4

National

NERC: Togo, Niger, Benin Dey Owe Naija N25bn Gbese For Electricity

By: Rilwan Agbomeji Nigerian Electricity Regulatory Commission (NERC) don share update say Togo, Niger, and Benin dey owe Nigeria about N25 billion for electricity wey dem buy from Nigeria grid. NERC tuk dis for dia Third Quarter 2025 report, wey show say di three countries suppose pay $18.69 million but dem don only pay $7.125 million, leaving $11.56 million unpaid. Di regulator explain say di debt dey because these international companies dey buy power under bilateral arrangements from Nigeria, and […]

todayJanuary 8, 2026 40

National

Court Put Ice Block For Malami, Sons 57 Properties

By: Rilwan Agbomeji Federal High Court for Abuja don order make government hold 57 properties wey dem say get link with former Attorney-General, Abubakar Malami, and two of im pikin dem, Abdulaziz and Abiru-Rahman. Justice Emeka Nwite give di order afta EFCC carry ex parte application come court on Tuesday. EFCC talk say di properties, wey value reach about N213.2 billion, be money from illegal activities. Dem say di properties dey Abuja, Kebbi, Kano and Kaduna, and e include hotels, […]

todayJanuary 8, 2026 51 4

National

Govnor Makinde Arrange Im Mehn To Rascal Di Jaguda Boys Wey Attack Oloka

By: Rilwan Agbomeji Oyo State Govo, Seyi Makinde, don condemn di attack wey kill five forest guards for Oloka Village. E talk say di people wey do am go dance ayagayagayagayo, face justice. Di Govo press tuk say na cross-border attack ni hapun, and security agencies don dey work to catch di criminals. E beg residents, especially for Oriire LGA and border areas, make dem remain calm as normalcy don return.

todayJanuary 8, 2026 28

Sports

How Di Morocco 2025 AFCON Waka So Far

By: Rilwan Agbomeji Di battle for di 2025 Africa Cup of Nations (AFCON) dey strong by every match day,Ā  beta performances for all di top teams, and high hopes from every corner of Africa. And like dis, di tournament don reach Quater finals phase. Na 52 African countries enter di race from di qualifiers to di group stage of di competition.   Group Stage Results – AFCON 2025 (Morocco) Matchday Results December 21, 2025 Morocco 2‑0 Comoros   December 22, […]

todayJanuary 8, 2026 45 3

Sports

Super Eagles Refuse to Travel Say Dem Never See Dia Match Bonus

By Ebi Oboko Nor be small tin oh, say di Super Eagles of Nigeria and coaches no gree travel to Marrakech wia dem suppose face Algeria for AFCON quarterfinals say NFF never pay dem dia Four match bonus. Africa Aproko Journalist, Oluwashina Okeleji, ni troway dis update for Instagram, say na wetin hapun on Wednesday, normal dem supposr travel on Thursday, today from FEZ b4 dis news dey break so. Di super Eagles don beat Tanzania, Tunisia, Uganda for group, […]

todayJanuary 8, 2026 27

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds