Blog masonry

Background

Sports

Zambia Carry Last-Minute Draw Against Mali For AFCON 2025

By: Rilwan Agbomeji AFCON 2025 Group B take enter stage on Monday Afternoon as Zambia and Mali take play 1-1 draw. Mali start sharp from kickoff and create plenty chances, but El Bilal Touré miss big penalty for 41st minute. For 60th minute, Mali finally score when Lassine Sinayoko finish clean from corner move. Zambia no gree loss, Patson Daka later score one mad equalizer wey carry di game enter draw.  

todayDecember 22, 2025 51

Sports

Tanzania Go Make Match Hard For Super Eagles – Onazi

By: Rilwan Agbomeji Former Naija Midfielder, Ogenyi Onazi don warn say Tanzania go make life hard for Super Eagles for dia AFCON 2025 Group C match on Tuesday for Morocco. Onazi yarn for TV siddon talk say players gatz prepare well if dem wan collect full three points. Super Eagles dey favourite to top di group wey get Tunisia and Uganda join body.  

todayDecember 22, 2025 35

Sports

We Ready Well-Well To Face Nigeria – Gomandi

By: Rilwan Agbomeji Tanzania coachie Manuel Gomandi talk say im team don ready for AFCON 2025 Group C opener against Nigeria. Dem go face Super Eagles for AFCON first time since 1980. Dem lose 3-1 back then, wey Christian Chukwu lead Nigeria to di African Championship.

todayDecember 22, 2025 30

Sports

Lookman Yarn Say AFCON 2025 Cup Na For Naija

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles winger, Ademola Lookman don clear marras dat di Super Eagles ready to go di extra mile to collobi di 2025 African Cup of Nations Dis yarnings dey follow fans demand on social media mata say Naija miss out for di 2026 world via penalty to Dr Congo Lookman respond for TV siddon talk dat di team go correct di past by showing correct skills and unity for di 2025 AFCON

todayDecember 22, 2025 28

National

Naija And US Sign $5.1bn Agreement To Join Hand For Health Sector

By: Rilwan Agbomeji US don agree five-year health deal with Naija to help di country guide for health matas and boost church hospitals make country health system strong and boost church hospital dem. US Deputy tuk tuk person, Thomas Pigott, yarn dis one wrap am like groundnut send giv news pipo on Saturday. Pigott yarn say US go drop nearly $2.1bn for HIV, TB, malaria, polio plus mama and pikin health.

todayDecember 22, 2025 25

National

FG Declare Say Kidnappers And Bandits Na Terrorists

By: Rilwan Agbomeji Federal Govment don cut rope follow say any kidnapper or bandit go face di music just di way dem take dey treat terrorists. Minister of Information, Mohammed Idris na im carry di mata for head as e take serious reach, siddon tori pipo dey tell dem for Abuja how di federal govment ready to wipe out any jaguda boi wey no wan allow Nigeria drink water keep cup. According to Idris say di Federal Govment, now go […]

todayDecember 22, 2025 44

Sports

Super Eagles Train For Morocco Ahead AFCON Match With Tanzania

By: Esther Ayoola Super Eagles don hold dia fourth training session for FES, Morocco, on Sunday as dem dey prepare for dia 2025 AFCON Group C match against Tanzania on Tuesday. Nigeria go face Tanzania for di Complex Sportif de Fes for dia first Group C game. Di team wey land Morocco last Thursday don also train on Friday and Saturday to sharpen dia preparations. Before dem reach Morocco, di three-time African champions camp for Egypt for five days, where […]

todayDecember 22, 2025 42

obodo oyinbo

US Dey Chase Venezuela Oil Tanker Over Sanctions

By: Esther Ayoola Di United States don start to chase anoda Venezuela oil tanker for international waters as part of dia pressure against President Nicolas Maduro government. Dis one come just one day afta US Coast Guard seize di second vessel near Venezuela coast within two weeks under one “blockade” wey former President Donald Trump order. One US official tell reporters say di tanker na part of Venezuela “dark fleet” wey dey try dodge US sanctions on di oil sector. […]

todayDecember 22, 2025 46

National

Akpabio Carry Natasha Suspension Mata Go Supreme Court

By: Esther Ayoola Senate Presido, Godswill Akpabio don carry matter of Senator Natasha Akpoti-Uduaghan suspension go Supreme Court. Dis one dey sup, afta Court of Appeal for Abuja send Federal Government message dat Akpabio no follow court rules well. Court documents show say Akpabio file di appeal since December 1, 2025.

todayDecember 22, 2025 27

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds