By: Rilwan Agbomeji
Federal Govment don cut rope follow say any kidnapper or bandit go face di music just di way dem take dey treat terrorists.
Minister of Information, Mohammed Idris na im carry di mata for head as e take serious reach, siddon tori pipo dey tell dem for Abuja how di federal govment ready to wipe out any jaguda boi wey no wan allow Nigeria drink water keep cup.
According to Idris say di Federal Govment, now go dey use full counterterror law take tackle bandits and kidnappers so dat pipo and community go dey safe.