By: Esther Ayoola
Super Eagles don hold dia fourth training session for FES, Morocco, on Sunday as dem dey prepare for dia 2025 AFCON Group C match against Tanzania on Tuesday.
Nigeria go face Tanzania for di Complex Sportif de Fes for dia first Group C game.
Di team wey land Morocco last Thursday don also train on Friday and Saturday to sharpen dia preparations.
Before dem reach Morocco, di three-time African champions camp for Egypt for five days, where dem lose 2–1 for friendly match against di hosts.