Blog no sidebar

Background

obodo oyinbo

5.8-Magnitude Quake Hit Off Cuba Coast, No Casualty Report Yet

By: Esther Ayoola Say One 5.8-magnitude earthquake hit near di coast of Cuba early Tuesday, According to United States Geological Survey, e hapun for 11.6 kilometer deep, 49 km south-southwest of Maisi town. Cuba dey try fix electricity afta di whole island blackout. Aftershocks reach 4.7 magnitude, USGS say no danger at all, dat dem dey monitor di situation.

todayMarch 18, 2026 4

obodo oyinbo

President Trump Say France Go Escort Ships For Strait Of Hormuz If Things Cool Down

By: Esther Ayoola President Emmanuel Macron of France tuk on Tuesday say France fit hellep protect ships for Strait of Hormuz, but only if di situation don cool down. E tuk am for France, afta US Presido Donald Trump, beg im  allies to help secure di waterway wey Iran don block because of di US and Israel attack. Macron explain say oil price don jump 40–50% since Iran begin attack […]

todayMarch 18, 2026 6

obodo oyinbo

Trump Top Counterterrorism Oga Joe Kent Resign, Say Make US Stop Di War For Iran

By: Esther Ayoola President Donald Trump top counterterrorism senior man, Joe Kent, don resign over di war wey dey hapun for Iran. For im letter for X, e tuk say Iran no get "imminent threat" for US and so im nor understand di kind of war dem dey fight for Iran Meanwhile, White House say dem get strong proof say Iran bin dey plan attack US first. With im resignation, […]

todayMarch 18, 2026 4

National

IGP Olatunji Disu Visit Blast Victims, Tighten Security For Maiduguri

By: Esther Ayoola Inspector-General of Police, Olatunji Disu, don visit di victims of di recent bomb blast for Maiduguri wey dey hospital, come check di Monday Market bomb site. Im still waka go Borno State Gornment House and Police Command to see how security dey and plan beta joint action. IGP Disu tuk say im dey feel for di victims and dia family, and dat police go do everything to […]

todayMarch 18, 2026 23

National

VP Shettima Condemn Maiduguri Blast Wey Kpai 25, Pray For Di Families

By: Esther Ayoola Vice Presido, Kashim Shettima don mourn di 25 people wey kpai for di explosions wey happen for different areas for Maiduguri, Borno State on Monday. VP Shettima, tuk dis tuk on Tuesday during di closing of di Annual Ramadan for State House Mosque, Abuja, E sha pray make Almighty Allah give di dead pipo peaceful rest for Aljannah firdaus and give dia family strength to survive di […]

todayMarch 18, 2026 6

National

Vice Presido Shettima Hail Soludo For Unity, Development, And Nation Progress

By: Esther Ayoola Vice Presido, Kashim Shettima don praise Anambra State Govo Chukwuma Soludo for im work for Anambra. Shettima yarn dis while e dey represent Presido Bola Tinubu for di inauguration and swearing-in of Soludo and him deputy, Dr Onyekachukwu Ibezim, for Awka, di state capital. According to Shettima, Soludo dey show national interest pass partisan politics, and im leadership dey unify pipo and make progress without wahala.

todayMarch 18, 2026 8

National

President Tinubu Order All Appointees Wey Wan Contest 2027 Election To Exit Im Gorment

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don order, say make all im political appointees wey wan run for any election for 2027 resign from dia work before March 31. Head of Information for OSGF, Dewan Goshit, naim announce dis news on Tuesday. Baba Seyi say, dis follow Section 88(1) of di Electoral Act 2026 and di INEC timetable for party primaries. Dis order dey affect all presidential […]

todayMarch 18, 2026 5

National

President Tinubu Land London For Historic State Visit

By; Esther Ayoola Oga Presido, Bola Tinubu, wey dey go do historic state visit, don land London, United Kingdom with im wife, Oluremi Tinubu. According to president tuk, tuk, Bayo Onanuga dem touch London Stansted Airport for 3:18 pm on Tuesday. Tinubu meet Mark Bevan, Deputy Lieutenant of Essex, plus Naija acting High Commissioner Ambassador Mohammed Maidugu and other big oga dem. For di visit, King Charles III and Queen […]

todayMarch 18, 2026 5

National

Keyamo Admit Say Na Because Akure Airport Fence Weak Ni Make Jaguda Boys Enter

By: Esther Ayoola Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo, tuk on Tuesday for radio, Ilese-Ijebu, Ogun State, say na one weak link for back of Akure Airport, Ondo State naim allow jaguda boys enter di airport do nonsense. Di Minister say all airports for di obodo Naija sha get dia safety packages, travellers nor suppose fear, but wetin hapun dat day for Akure airport na di weak link […]

todayMarch 18, 2026 5

Lagos

LASODA Give 50 Disabled Workers Tools To Boost Work Productivity For Lagos

By: Esther Ayoola Lagos State Office for Disability Affairs (LASODA) don do give away to 50 physically challenged workers for different ministries, give dem beta working tools and technology to make dia work easier. General Manager, Adenike Oyetunde-Lawal tuk for di programme, wey dem call “Enhancing Productivity: Supporting Civil Servants with Disabilities,” say, na part of effort to boost work efficiency. According to di LASODA General Manager, di programme na […]

todayMarch 18, 2026 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app