Blog no sidebar

Background

OBODO NAIJA

IPMAN Say Refineries Revival Go Reduce Fuel Price

By: Mariam Ajayi Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria, IPMAN, don talk say bringing Port Harcourt, Warri and Kaduna refineries back to work fit help reduce fuel prices for Nigeria. IPMAN toktok pesin, Chinedu Ukadike, tok dis one during one interview with tok tok channel as debate over fuel subsidy return dey continue. E say di best way to bring down fuel price, wey dey between N1,230 and N1,299 per […]

todayAugust 26, 2026 15

OBODO NAIJA

Sowore Vow Say E Go Make Nigeria Four Refineries Work If E Win 2027

By: Mariam Ajayi African Action Congress, AAC, presidential candidate, Omoyele Sowore, don promise say e go make Nigeria four government-owned refineries work if e win di 2027 presidential election. Sowore make di promise on Tuesday during interview for one media station, where e blame corruption and mismanagement of public funds by past administrations for di refineries’ failure. E say if Nigeria fit refine crude oil locally, di country go save […]

todayAugust 26, 2026 19

Sports

Awoniyi Scores, Assists As Coventry Beat Plymouth 4-2 In Carabao Cup  

By: Mariam Ajayi Super Eagles striker Taiwo Awoniyi don open im goal account for Coventry City as e score one goal and provide assist for dia 4-2 win against Plymouth for Carabao Cup on Tuesday. Awoniyi put Coventry ahead just three minutes into di match after e finish Caleb Yirenkyi assist. Just two minutes later, di Nigerian striker turn provider as e set up Jack Rudoni to make am 2-0. […]

todayAugust 26, 2026 10

obodo oyinbo

Strait Of Hormuz Still Dey Closed As Iran, US Gbege Demselves

By: Mariam Ajayi According to di Deputy Foreign Minister, Kazem Gharibabadi say US must first return to im commitments before dem fully open di waterway. U sabi say, US President Donald Trump say all mines (dat navy bomb) for di international waters of di strait don clear and warn say any ship wey try plant new bomb ehn go dance osurugede dance, dem never shishonshi. Meanwhile, US State Department say […]

todayAugust 26, 2026 23

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Order Make Dem Do Benin-Agbor-Asaba Road

By: Mariam Ajayi Presido Bola Tinubu don order total reconstruction of di Benin-Agbor-Asaba road and other major federal highways for Edo State and nearby areas. Minister of Works, David Umahi, give di order on Tuesday when e inspect di bad Benin-Agbor-Asaba road and apologise to motorists over di hardship wey dem dey face. Umahi also condemn di contractor wey dey  handle di road after hin accuse rain say naim dey […]

todayAugust 26, 2026 10

Lagos

Suspected Cultists Kpai Security Man Inside Lagos Estate

By: Mariam Ajayi One security man wey dem identify as Stanley don kpai after two suspected cult members shoot am for Royale Estate, Sangotedo area of Lagos, on Friday night. Witness say di attackers storm di estate around 10pm to 11pm, shoot Stanley several times including for di head, before dem fire shots into di air and run comot. Lagos State Police Command tok tok pesin, Abimbola Adebisi, confirm di […]

todayAugust 26, 2026 17

Sports

Ethiopa Wan Bid To Host Di 2028 African Cup of Nations

Ethiopia don officially submit bid to host di 2028 Africa Cup of Nations, (AFCON), wey go be di first time di country go host di tournament in more than 50 years. Ethiopian Football Federation confirm di bid for post wey dem make for X late Monday, and di last time wey Ethiopia host di continental tournament na 1976. Ethiopia get about 130 million pipo, make am di second country with […]

todayAugust 25, 2026 15 4

obodo oyinbo

Chase Illegal Migrants Comot – Abelardo de la Espriella Yarn

Colombia right-wing Presido, Abelardo de la Espriella, don order immigration crackdown, as e tell authorities make dem start to dey arrest foreign pipo wey enter di country without proper papers, and wey don commit crime, so dem fit deport dem. Abelardo wey enter office on August 7, after e campaign say e go deal with crime and drug-trafficking gangs. Immigration no be major part of im campaign, but for security […]

todayAugust 25, 2026 11

OBODO NAIJA

Comot If You No Go Support APC – Samuel Danjuma Shekwolo Yarn

As 2027 general election dey come near, Kuje Area Council chairman for FCT, Samuel Danjuma Shekwolo, don threaten say e go resist residents wey wan vote against di ruling All Progressives Congress (APC). For one video wey dey circulate for social media, Shekwolo say e no go allow anybody for di council work against APC or oppose Presido Bola Tinubu second-term ambition. Di chairman point to development projects wey Presido […]

todayAugust 25, 2026 20

Lagos

IGP Olatunji Disu Draw Ear Say Jungle Justice Na Crime

Di Inspector-General of Police, Tunji Disu, don drag ear say anybody wey kpai person through jungle justice fit face murder charge and death penalty, as e give di warning for video wey Nigeria Police Force share on Tuesday, August 25, 2026. Disu say e issue di warning because innocent Nigerians dey lose dia lives through rumours, suspicion and mistaken identity, press mouth say nobody no get right to try, sentence […]

todayAugust 25, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds