Blog no sidebar

Background

Sports

We Go Block Osimhen Goal – Skriniar

Fenerbahce captain, Milan Skriniar don fire warning shot, talk say dem ready lock Victor Osimhen completely as di Istanbul derby go burst tonight for RAMS Park. Galatasaray dey top table with one point, and dis match don turn full-blown city war as both sides dey ginger for supremacy. On top post for X, Skriniar yarn say Osimhen and Icardi fit be hot strikers, but tonight, Fenerbahce dey come rugged, compact […]

todayDecember 1, 2025 6

foreign

Cash Don Finish For Sudan, Pipo Dey Swap Goods, Run Credit

Sudan economy don kpafuka, money don vanish comot, everywhere don turn wahala zone, one euro wey before dey 450 pounds now dey sell 3,500 for black market, money don disappear everywhere. Banks don loot, cash don vanish, people don dey swap everything, chairs, hoes, cloth, even fridge, just to chop, buy fuel or run generator. Civil servant Ali for Dilling talk say e never see banknote for over nine months, […]

todayDecember 1, 2025 19

National

Jonathan Brief Tinubu On Guinea-Bissau Wahala

Former Presido Goodluck Jonathan don land for Aso Rock to give Presido Tinubu full gist of wetin shelle for Guinea-Bissau election, as tradition demand anytime former presido handle regional wahala. Jonathan talk say di election don already finish, results dey almost complete, and di only correct next step na to announce who truly win instead of dis confusion wey don drag military enter matter. E beg ECOWAS leaders make dem […]

todayDecember 1, 2025 15

National

Atiku Demand Make Dem Probe N17.5tn Pipeline Security Money

Former Vice Presido, Atiku Abubakar don drag President Bola Tinubu gornment for Abuja on Sunday, say how dem spend N17.5tn on pipeline security and related wahala for just one year. Na for inside statement wey dem wrap like moi moi through di Atiku news waka waka dem, on Sunday, in yanyanpu dis one say,  di money pass 12 years wey Nigeria dey pay fuel subsidy wey dey help millions of […]

todayDecember 1, 2025 6

National

Taraba Governor Go Meet Tinubu For Aso Rock

Taraba Governor Agbu Kefas don go Aso Rock to meet Tinubu for closed-door session, E waka enter inside di Presidential Villa around 2pm on Monday. Dis na im first visit since e dash PDP goodbye join APC, and e waka enter di State House with APC National Chairman, Prof. Nentawe Yilwatda. Kefas cancel im APC welcome wey suppose hold November 19, say e no make sense to celebrate while Kebbi […]

todayDecember 1, 2025 5

National

Oluremi Tinubu Don Call Nigerians Make Dem Renew Fight To End Hiv/Aids By 2030

Wi Oga presido wife Senator Oluremi Tinubu, don call Nigerians make dem renew their commitment to end HIV/AIDS by 2030. She talk this one for statement wey she post for her X handle to mark World AIDS Day 2025 with the theme “Overcoming Disruptions; Transforming the AIDS Response.” According to her, the day remind everybody say make we ginger our efforts to finish HIV/AIDS once and for all. She still […]

todayDecember 1, 2025 5

National

FG, Asuu Don Enter Talks On 40% Pay Rise

Na wah o! Federal Gornment don yarn say dem wan give ASUU lecturers 40% salary increase, according to di pipo wey follow tori pipo talk for Abuja. Dis one land as ASUU leaders dey ready to waka back go negotiation table with Federal Gornment team wey Yayale Ahmed lead, afta dem don finally settle matter and hammer deal for ASUU National Executive Council meeting for Abuja last Sunday. Branch leaders […]

todayDecember 1, 2025 7

Lagos

Lagos Dey Upgrade Waterfronts For Detty December – Alebiosu Talk

Di Lagos State Gorment don come with anoda mata say residents and holiday visitors go enjoy modernised waterfronts dis Detty December, as new reforms don land to boost di state tourism. Di Commissioner for Waterfront Infrastructure Development, Dayo Alebiosu, tok dis one for statement wey dem issue on Sunday after di Lagos Tourism and Hospitality Stakeholders’ Summit wey Ministry of Tourism, Arts and Culture host. He add say di state […]

todayDecember 1, 2025 3

Lagos

Rice Sellers Don Predict That Price Go Fit Drop Ahead Christmas

Some Senior   farmers for the ogbonge  Farmers Association of Nigeria (AFAN) ,  don cut cap for lagos govo, Babajide Sanwo-Olu  say im ma do well as him take slash Lagos rice from N64,000 to N57,000 per bag, Na on top tok tok with stori pipo for the state capital, Di Vice Chairmo of AFAN Southwest and Lagos chapter,  Sakin Agbayewa,  hail di move, say e go create competition and make […]

todayDecember 1, 2025 5

Lagos

CITN Dey Support Lagos Revenue Collection

Former Federal Inland Revenue Service (FIRS) Chairman, Dr. Tunde Fowler, don reflect on di support wey e receive from Chartered Institute of Taxation of Nigeria (CITN) as e dey grow Lagos State revenue base when e serve as Chairman of LIRS for 2005. Him Talk dis one for night of tributes wey CITN organise for dia founder, Chief David Ajibola Olorunleke. Fowler tok say, E wan emphasise say CITN help […]

todayDecember 1, 2025 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app