Blog sidebar

Background

National

Oyo Police Re-Catch Suspected Kidnapper Weh Escape Custody

By: Esther Ayoola Oyo State Police Command don re-arrest one suspected kidnapper wey escape from police hand before. According to police tuk tuk, DSP Ayanlade Olayinka on Wednesday, di Police catch di man, Ayomide Kareem, 25 from Osorun’s Compound, Oyo, for Irepo Junction, Ojongbodu, around  during one routine stop-and-search patrol. Dem stop am because e dey waka suspicious, and wia dem con see say  na di same person wey escape […]

todayMarch 19, 2026 6

National

VP Shettima Vow Say FG Go Crush Terrorists, Visit Maiduguri Bomb Blast Victims

By: Esther Ayoola Vice Presido Kashim Shettima don tuk say Federal Government go make sure say dem defeat terrorism, and anybody wey dey behind recent attacks go face serious action. E tuk say apart from order wey president don give security chiefs, government dey put more money for equipment and logistics to strengthen di fight against terrorism. Shettima yarn dis one for Maiduguri when e go visit people wey bomb […]

todayMarch 19, 2026 4

National

CDS Oluyede Insists Say Borno, Yobe Pipo Must Join Fight Against Boko Haram

By: Esther Ayoola Chief of Defence Staff, Olufemi Oluyede, on Wednesday for Maiduguri Say na some residents for Borno and Yobe dey support insurgents, say if not, why dem nor dey share informate with security. Di Army chief  yarn dis one afta one four-hour security meeting wey include Army Chief Waidi Shuaibu and Operation Hadin Kai commander Abdulsalam Abubakar, as dem review how Boko Haram and ISWAP sti dey operate. […]

todayMarch 19, 2026 3

National

Police Pay N2.4B Insurance Money To Officers, Families

By: Esther Ayoola Say di Naija Police don pay over N2.4 billion insurance money to 1,075 officers and pipo wey lose dia life on duty, under di Group Life Assurance plus IGP Family Welfare Schemes. Di Inspector-General of Police, Olatunji Disu, ni give di cheque to families on Wednesday for Force Headquarters, Abuja. Dat di money cover different years, including 2018 reach 2026, plus some old once wey dem never […]

todayMarch 19, 2026 3

National

Labour Party Faction Fix May Dates For Primaries

By: Esther Ayoola Nenadi Usman-led faction of Labour Party say dem go conduct presidential primary election on May 23, 2026 ahead of 2027 general elections. Dem make dis one afta dia National Executive Council meeting, where dem also fix May 15, 2026 for governorship, National Assembly and State Assembly primaries. According to dem, dem put di dates to ensure better planning and smooth process.

todayMarch 19, 2026 2

National

Court Fine EFCC N500k For Always Delaying Emefiele Trial

By: Esther Ayoola Justice Hamza Muazu for Federal High Court, Abuja don fine EFCC N500,000 based on say dem ask for adjournments for di trial of former CBN Governor, Godwin Emefiele. Dem tell di EFCC on Wednesday to call dia last witness, and pay di  fine to Emefiele. Nor be amebo say, EFCC dey prosecute Emefiele for 20-count charge wey include criminal breach of trust, forgery, and collecting money by […]

todayMarch 19, 2026 3

obodo oyinbo

US Intelligence Clear Iran Say Dem Nor Rebuild Nuclear Weapon After US-Israel Attack

By: Esther Ayoola US intelligence don shake table say Iran nor even rebuild dia nuclear machine wey US and Israel destroy last June 2025. Trump ally and US national intelligence director, Tulsi Gabbard, na tuk dis one for her written testimony to Senate intelligence committee on Wednesday for Washington, DC. She explain say afta Operation Midnight Hammer, Iran nuclear plan end and dat Iran nor do any rebuild, reason wey […]

todayMarch 19, 2026 4

obodo oyinbo

Saudi Arabia Clear Iran Say Dem No Go Tolerate Anymore Attack

By: Esther Ayoola Saudi Arabia Foreign Minister Prince Faisal bin Farhan Al Saud don warn Iran on Thursday, for Riyadh say dem no go dey tolerate any more attacks for Saudi Arabia and neighbouring Gulf states. Im yan dis give tori pipo for di Saudi capital, dat Iran don dey attack dem since dem keep quiet nor mean say Saudi Arabia nor get power, dat dem get strong military power, […]

todayMarch 19, 2026 3

Sports

Anthony Joshua Return To Full Training Afta Lagos-Ibadan Car Crash

By: Esther Ayoola Say like dis, Anthony Joshua don start full training again as e dey prepare for him summer comeback, join di team wey dey train Oleksandr Usyk. Di British-Nigerian boxer last fight na December 19, wen e stop Jake Paul for six rounds for Miami. But days later, him life scatter small, as e waka enter big car crash for Lagos-Ibadan Expressway wey kill him padi dem, trainer […]

todayMarch 19, 2026 1

Sports

Lookman Assist Make Atlético Madrid Beat Spurs 7-5 For UCL

By: Esther Ayoola Ademola Lookman give assist as Atlético Madrid qualify for UEFA Champions League quater finals, even though dem lose 3-2 to Tottenham Hotspur for di second leg. Lookman collect ball for counter, cut small for box corner, then pass am to Julian Alvarez wey score make e 1-1. Tottenham first goal na from Randal Kolo Muani, then Xavi Simons score two, one na penalty. Atlético second goal come […]

todayMarch 19, 2026 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app