By: Esther Ayoola
Justice Hamza Muazu for Federal High Court, Abuja don fine EFCC N500,000 based on say dem ask for adjournments for di trial of former CBN Governor, Godwin Emefiele.
Dem tell di EFCC on Wednesday to call dia last witness, and pay diĀ fine to Emefiele.
Nor be amebo say, EFCC dey prosecute Emefiele for 20-count charge wey include criminal breach of trust, forgery, and collecting money by false pretence.
EFCC tuk say Emefiele collect $6.23 million wey suppose be for 2023 election observers, and give contract advantage to two companies, April 1616 Nigeria Ltd and Architekon Nigeria Ltd.