Blog sidebar

Background

Sports

Kanté Don Bounce Back For France Ahead World Cup Qualifiers

World Cup winner N’Golo Kanté don make comeback for France national team as dem recall am for November World Cup qualifiers against Ukraine and Azerbaijan. Di midfield machine last play for France November last year for draw wey end 0-0 with Israel. Kanté wey dey play for Saudi Pro League club Al Ittihad don show say e still get energy and form. France coach Didier Deschamps talk say, “E dey […]

todayNovember 7, 2025 29 101

Sports

Foden Beat Osimhen Grab UCL Award

Manchester City star boy Phil Foden don beat Super Eagles striker Victor Osimhen take win di UEFA Champions League Player of di Week for Matchday Four. Foden shine well well as City knack Borussia Dortmund 4-1, scoring two fine goals from outside di box wey help di Premier League side collect dia third UCL win dis season and move up to fourth for di league phase table. Osimhen too no […]

todayNovember 7, 2025 21 21

National

“We Go Defeat Terr0rism” – Tinubu Tell US

President Bola Tinubu don assure United States say him government dey fully committed to defeat terr0rism for Nigeria. Di assurance come on Thursday, November 6, for Abuja, as response to security wahala wey President Donald Trump raise. Tinubu talk say despite political gbege wey dey, him administration go still dey engage dia international partners well-well. Di statement follow the swearing-in of two new Ministers and one positive update from Minister […]

todayNovember 7, 2025 7

National

Naija Man Cry As Him 23-Year-Old Wife And Baby D!E Few Days To Dia One Year Wedding Anniversary

One Naija man, Udeme Etuk Emmanuel, don enter deep mourning after him 23-year-old wife, Mary, die just few days to dia one-year wedding anniversary. Di couple marry on November 2, 2024, but Mary give up di ghost few days ago after she born dia first pikin  sadly, di newborn baby still die join. Both mother and pikin don lay to rest on Thursday, November 6, 2025, for Okoyo Community, Ukanafun […]

todayNovember 7, 2025 15 56

Sports

Eagles Fit Win 2025 AFCON — Nwabali

Super Eagles goalkeeper Stanley Nwabali don talk say e believe Nigeria fit carry di 2025 Africa Cup of Nations (AFCON) trophy go house. Di Chippa United shot-stopper yarn say fans no just expect di team to show face for Morocco, but to actually win di cup. Di 2025 AFCON go happen for Morocco from December 21, 2025 to January 18, 2026. Nwabali, wey blow for di 2023 edition for Ivory […]

todayNovember 7, 2025 23 69

Entertainment

We Don Adapt To Suffer Because Government No Dey Do Anything – Zlatan Ibile

Naija rapper, Zlatan Ibile, don yarn say Nigerians don already get used to suffer because government no gree fix di economy. Di Zanku crooner talk dis one as e dey react to UK rapper, Dave, wey talk say Nigerians dey spend for club while beggars dey sit down outside dey look. As Zlatan dey talk for Madame Joyce show for UK, he mention say, “We don used to am. Na […]

todayNovember 7, 2025 14

Lagos

Lagos NMA Stand Gidigba With NARD, Blame FG For Doctors Strike

Di Nigerian Medical Association (NMA), Lagos State chapter, don throw full support behind di ongoing strike by di Nigerian Association of Resident Doctors (NARD) wey dey fight against poor pay and bad welfare conditions. Di Lagos NMA accuse Federal Government say dem neglect doctors and fail to fix di worsening condition for tertiary hospitals. Chairman of Lagos NMA, Dr. Babajide Saheed, talk say government don refuse to fulfill agreements wey […]

todayNovember 7, 2025 13 110

International

11 Year Old Russian Girl Dun Change Am For Putin Sake Of Her Uncle Wey Wound For This Ukraine War So

Russian Presido Vladimir Putin don jam wahala after one 11-year-old girl, Kira, from Siberia, face am for Red Square, Moscow, over how dem dey treat her uncle wey wound for di Russia-Ukraine w@r. Di small girl, wey her papa, Vladimir Pimenov, die last year for Donetsk region while fighting, beg Putin make dem transfer her uncle go “better hospital for Russia.” She tell am say her uncle, Anton Fisyura, don […]

todayNovember 7, 2025 10

Lagos

Justice For Ochanya: Lagos Protesters No Gree For Rape Cases

Child rights activists and civil society groups don storm di Lagos State House of Assembly on Thursday, dey demand justice for late Ochanya Ogbanje and other pikin wey don suffer sexual abuse for Nigeria. Di protesters, wey march from Ikeja Under Bridge go di Assembly complex, carry placards wey read “Justice for Ochanya,” “Stop Child Molestation,” and “Protect Our Children, Punish Pedophiles.” Di protest come as di #JusticeForOchanya movement trend […]

todayNovember 7, 2025 18 204

National

FRSC Don Arrest 27,000 Drivers For Three Months Over Traffic Offense

Di Federal Road Safety Corps (FRSC) wey dey for FCT don yarn say dem don arrest over 27,000 drivers between July and September for different traffic wahala. Di FCT sector commander, Felix Theman, drop dis gist for Abuja during di 2025 ember months town hall meeting wey carry di theme “Take Responsibility For Your Safety Stop Distracted Driving.” E talk say di message dey timely because e remind people say […]

todayNovember 6, 2025 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app