Blog sidebar

Background

Lagos

Lagos Community Cry For Help Say Dem Blackout Wan Finish Dem For Months

By: Esther Ayoola Residents of Aina Aladi Community Development Association for Alagbado, Lagos, tuk say dem dey suffer oh, serious blackout because of faulty transformer. Community leader, Afeez Lawal, naim carry dis mata dey yarn tori pipo on Saturday, Say dem carry mata to Ikeja Electric office, no response. E explain say di transformer misbehave for about three years before e finally break down for December 2025, wey leave over […]

todayMay 4, 2026 10

Sports

Inter Milan Win Third Serie A Title in Six Seasons

Inter Milan don win Serie A title again, securing dia 21st Scudetto with 2-0 victory over Parma for San Siro. Marcus Thuram na im start di scoring before half-time, before Henrikh Mkhitaryan add another goal for second half to seal di win. With three matches still remaining, Inter don dey top Napoli by 12 points and AC Milan by 15 points. Dis na dia third title in six seasons, as […]

todayMay 4, 2026 10

Lagos

LAWMA Beg Gornment To Arrange Long Term Plan For Lagos Waste Management

By: Esther Ayoola Di Managing Director/CEO of Lagos Waste Management Authority (LAWMA), Dr Muyiwa Gbadegesin, don konfam matas, say Lagos State never sti get proper Waste Management Master Plan. E yarn dis one when e receive European Union and ECOWAS delegation for Ijora Olopa, Lagos. E explain say LAWMA dey push make gornment develop di plan wey go guide long-term waste management, investment, and beta sustainability for di state. Gbadegesin […]

todayMay 4, 2026 8

obodo oyinbo

US Fit No Accept New Iran Peace Proposal – Donald Trump

Donald Trump talk on Saturday say e go check new peace proposal wey come from Iran, but e still show doubt whether di deal go work, as e no close door for possible fresh attack on Iran. Peace talks between United States and Iran don jam for ground since ceasefire start on April 8. One round of peace talks wey happen for Pakistan to end di war wey don pass […]

todayMay 3, 2026 13

Politics

Why We Comot From ADC – Kwankwaso Camp

Spokesman to Rabiu Musa Kwankwaso, Habib Saleh Muhammad, don konfamate say di former Kano State govo and im political camp don decide to comot from African Democratic Congress (ADC), as internal wahala and time no dey before 2027 elections. For exclusive interview with media pipo, Muhammad talk say dem take di decision after plenty consultation with stakeholders across local governments. E further explain say di move come because of wetin […]

todayMay 3, 2026 12

Sports

Sir Alex Ferguson Land For Hospital Before Man Utd vs Liverpool

Manchester United legend manager, Sir Alex Ferguson, don land hospital after health matter catch am for Old Trafford. Di incident happen just before Sunday Premier League showdown between Red Devils and Liverpool. According to BBC, no be life-and-death emergency, na to play safe dem rush am go hospital. Even with that one, Sir Alex still comot di stadium inside ambulance. People for United camp dey confident say di Ferguson go […]

todayMay 3, 2026 16

Politics

ADC Fix Dates For Primaries

African Democratic Congress don drop full timetable for im 2026 primary election, as party members wey wan contest now don know when battle go start. For statement wey Bolaji Abdullahi release on Sunday, di party talk say sale of nomination forms go run from May 5 to May 10, 2026. Aspirants go submit their forms from May 11 to May 13, while screening go begin from May 14 to May […]

todayMay 3, 2026 10

Politics

Breaking: Peter Obi Dump ADC

Former Labour Party presidential candidate Peter Obi don comot from African Democratic Congress because of serious gbege inside di party and for di country. Di former Anambra State govo post dis statement wey im X on Sunday. E describe Nigeria politics as something wey don turn toxic, full of intimidation, insecurity, and discouragement. Obi explain dat, di decision im think am wella before resigning, hoping dat e go find beta […]

todayMay 3, 2026 11

obodo oyinbo

US Plan To Comot About 5,000 Troops From Germany

US Defense Secretary, Pete Hegseth,  don order make about 5,000 American soldiers comot from Germany within di next one year, according to Di Pentagon on Friday. Dis move dey come as fresh wahala dey show for relationship between United States and Europe over di Middle East war. At di same time, Donald Trump announce say tariff on cars and trucks from di European Union go rise to 25 percent from […]

todayMay 2, 2026 10

Lagos

Ojeleye Collect APC Expression of Interest Form

Journalist, Adewale Lateef Ojeleye, don officially declare say e wan contest for 2027 general election after e collect All Progressives Congress Expression of Interest and Nomination Form for Ifako-Ijaiye Constituency 01 seat for Lagos State House of Assembly. Ojeleye collect di form today for APC secretariat, wey mark di official start of im political ambition to represent people of Ifako-Ijaiye Constituency 01. After e collect di form, Ojeleye talk say […]

todayMay 2, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds