Lagos

Building Fall for Fadeyi, Kpai One Pesin 

todayOctober 23, 2026 3

Background
share close

One pesin don kpai, as rescue team bring out three men alive after one two-storey building wey dem dey build fall for Akinola Street, near Fadeyi Bus Stop, along Ikorodu Road, Lagos, early Friday morning.

Lagos State Emergency Management Agency, LASEMA, tok say dem receive call for 12:10 midnight, and dia rescue team reach di place two minutes later.

As dem dey dig through di broken blocks, dem hear pipu dey cry under di building wey show say some pipu fit still dey alive.

LASEMA say dem bring machine come help dem dig, as dem give di three men first aid before dem carry dem go hospital.

Fire service workers and police join di rescue work, as dem still dey torchlight to find out if more people remain under di fallen building.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds