Entertainment

85 Results / Page 3 of 10

Background

Entertainment

Waje Land Abuja, Shake Gov Wives Conference With Strong Talk

By: Esther Ayoola Nigerian singer and humanitarian Waje scarra area for inside the 6th Nigerian Governors’ Conference, where big madams, policymakers, and development partners gather discuss women, health, education, youth and social welfare wahala. Waje, wey don always fight for women rights and youths, join the conversation on how influencers fit shape society and push better change. She yarn say policies nor dey enough, na the everyday behavior wey people […]

todayDecember 5, 2025 11

Entertainment

Wizkid and Asake Don Join Hands for EP “REAL (Vol. 1)” This December

By: Esther Ayoola Tori don land for music fans! Wizkid and Asake don announce say dem dey drop collabo drop EP “REAL (Vol. 1)” this December, and fans don dey ginger for di collabo. The two both of announce for the x handle, even show small snippet of tthe track “Jogodo” during Apple Music 1 appearance with DJ Tunez, give people taste of wetin dey come. Asake yan say their […]

todayDecember 5, 2025 41

Entertainment

Imisi BBNaija Don Land: Ebute Metta Stand Still for Homecoming Showdown

By: Esther Ayoola Today, Imisi Ayanwale  di winner of tv reality show,   dey return to her Ebute Metta hometown for big  welcome party as fans gather make dem hail her home. She  win full N150 million grand prize back on October 5, 2025, and since then everybody don dey follow her matter with bumper to bumper.! As part of di plan, she don invite big names for entertainment from Bolaji […]

todayDecember 5, 2025 32

Entertainment

2Baba Eye Comot Water As Marriage Gbege Grip Am For Neck

By: Rilwan Agbomeji Na wah oh! Nigerian music star, Innocent Idibia wey everybody sabi as 2Baba, don finally  open mouth talk wetin dey im mind for first time since di hot gbege with im wife, Natasha Osawaru burst everywhere for internet. For im IG tori on Wednesday, 2Baba tok say e need help, omo di message short but e carry weight wey hit body like trailer. E no finish there […]

todayDecember 3, 2025 33

Entertainment

PORTABLE VEX – DRAG JUMA JUX FOR SECRET NAIJA COLLABO!

By: Alice Iduh Portable don fire shot for social media as e call out Tanzanian singer Juma Jux for enter Naija coded and drop song with Ekunrawo without even hail am. Na for him Instagram page, the controversial street singer para troway, demand say dem must create space for am on the new track “Halima.” Portable talk say Juma Jux sneak enter the country and e no dey okay say […]

todayDecember 2, 2025 16

Entertainment

Kaka Igbokwe Confirms 2Baba’s London Arrest After Airport Clash With Wife

By: Esther Ayoola Former manager of music icon, Innocent Idibia wey everybody sabi as 2Baba and pikin of late legend Christy Essien-Igbokwe,, Kaka Igbokwe, don confirmate say di old trending video of 2Baba arrest for London after him quarrel with him pregnant wife, Natasha Osawaru, na true. Recall, 2Baba travel go United Kingdom with him pregnant wife for concert tour, but him no show for di October 2, 2025 performance […]

todayDecember 2, 2025 44

Entertainment

Reality TV Star Don Reveal How She Take Create Her Stage Name

By: Esther Ayoola Reality TV star and actress Roseline Afije, wey people sabi as Liquorose, don explain how she take get her unique stage name, and she talk say na her love for sapele water join with her real name inspire am. For one podcast wey she do with VJ Adams, Liquorose yarn say she choose the name back for December 2012, and since then e don turn her identity […]

todayDecember 2, 2025 21

Entertainment

Asake Lagos Concert Dey Face Backlash

Ásake Lagos homecoming concert don dey face wahala as fans rush social media criticise di ₦300,000 ticket price, wey dem call too high for dem wey don dey support him since him street-pop days. Wetin suppose be triumphant return for di global Afrobeats star don turn online revolt, with longtime supporters dey accuse organisers of “pricing out di true fans.” Fans compare di cost to international shows, @Yemmmmie_ talk say […]

todayDecember 1, 2025 24

Entertainment

“My First Pikin, Nino, No Wan Follow My Footsteps” – 2Face Talk

Legendary Nigerian musician, Innocent Idibia wey everybody sabi as 2Face don yarn say im first pikin, Nino, no dey interested to follow im footstep as musician. Even though Nino sabi play sax well well, im papa talk say im wan become medical doctor. 2Face talk dis one as e carry Nino come stage for Abuja during one event wey dem dey celebrate im 25 years for music industry. E shout, […]

todayNovember 28, 2025 25

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds