By: Esther Daniel
Afrobeats star Davido tok during one livestream with content creator Carter Efe say nobody fit beat am for any free and fair election, but im no get plans to join politics now because e believe say Nigeria election process no straight forward.
Di singer say im rather focus on im music career until elections for Nigeria become free, fair and transparent.
Davido add say im no fit accept any election wey dem go manipulate results, insis say e no go allow anybody cheat am.
Im still express confidence say if Nigeria conduct credible election, e fit even win presidential election