Entertainment

VDM Join Police Raid Alleged Baby Factory For Abuja Over Seven-Day-Old Baby Sale

todayJuly 22, 2026 2

Background
share close

By: Esther Daniel

Social media activist, Martins Vincent Otse, popularly known as VeryDarkMan (VDM), don join operatives of di Nigeria Police Force Special Tactical Squad (STS) for raid of one alleged baby factory for Karshi area of Abuja.

Di operation happen after allegation come out say dem dey sell one-seven-day-old baby.

VDM share videos of di operation for im official social media page, e show how e follow police officers carry out di raid.

According to am, Di team leave for di operation around 4:00am and reach di location for about 5:01am to rescue di newborn baby and uncover di alleged baby factory.

Di police authorities never release full details of di operation as investigation continue.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds