International

174 Results / Page 15 of 20

Background

International

One 4 Year Old Girl Drown For Private Nursery Swim Lesson Wey No Get Lifeguard

One four-year-old girl, Berra Dizi, don drown for swimming pool wey dem say too deep for children, inside one private nursery for Suleymaniye area of Inegol, Bursa Province, Turkey. Di sad incident happen on August 12 during swimming lesson. CCTV show how staff rush pull Berra from di water as she float motionless, while swim teacher try save am. Nurse give her first aid before dem rush am go hospital, […]

todayOctober 8, 2025 15

International

Denmark Wan Ban Social Media For Pikin Dem Wey No Reach 15 Years

Denmark don yarn say dem wan ban social media for pikin dem wey no reach 15 years, as government talk say na to protect childhood and make young people mind better. Prime Minister Mette Frederiksen talk dis one for parliament on Tuesday, October 7, but she no talk which social media dem go ban or how dem go take do am. But di plan don cause plenty talk for Denmark […]

todayOctober 8, 2025 10

International

Cameroon 92-year-old Presido Biya Show Face Rare To Start Election Campaign

Cameroon 92-year-old Presido, Paul Biya, don finally show face for campaign rally on Tuesday for Maroua, inside di troubled Far North region, as di oldest head of state for di world dey plan extend him 43-year rule for di upcoming October 12 presidential election. For stadium wey full of supporters, Biya promise say if dem vote am in again for di 8th time, he go boost security for di region […]

todayOctober 8, 2025 22

International

Five People Don Arrest After Dem Try Kill Ecuador President Noboa.

Five people don enter police hand afta dem allegedly try assassinate Ecuador President, Daniel Noboa. Di Minister of Environment and Energy, Ines Manzano, talk say di wahala happen on Tuesday as Noboa dey travel inside convoy go event for Cañar province. Over 500 people wey dey protest surround him motor, begin throw stones, and later dem discover bullet marks for him car. Even though Noboa no wound, authorities don file […]

todayOctober 8, 2025 12

International

Four Pipo Wound, Police Shoot Suspect For Manchester Synagogue Wahala

Four people dem injure and one suspect wey carry knife police shoot on Thursday after dem ram car and stab people outside synagogue for Manchester, officials yarn. Greater Manchester Police declare say na “major incident” just after 9:30am (0830 GMT) after police officers get call to Heaton Park Hebrew Congregation Synagogue for Crumpsall area, northwestern side of di city. “Paramedics show for di place, dem dey take care of people […]

todayOctober 2, 2025 10

International

Naija Person Don Jam Wahala for Try Traffic Him Daughter Go Iraq

NAPTIP don arrest five people wey dem suspect say dey do human trafficking and rescue 24 victims for Nnamdi Azikiwe International Airport, Abuja. Among di people wey dem arrest, one na papa wey try carry im own daughter go Baghdad, Iraq. NAPTIP spokesperson, Vincent Adekoye, talk say di operation wey NAPTIP DG, Binta Adamu Bello, lead na based on correct intelligence and dem catch di suspects unaware. One of di […]

todayOctober 2, 2025 9

International

Snapchat Don Cause Wahala As Dem Wan Begin Charge People To Keep Old Photos And Videos

Snapchat, one of di most popular social media apps for di world, don trigger serious backlash after dem announce say dem go start to charge users wey dey save old photos and videos for dia “Memories” feature. Since 2016, Snapchat don allow free unlimited storage, but under dis new policy, anybody wey don pass 5GB go need to pay to keep access. Di new subscription go start from $1.99 (about […]

todayOctober 2, 2025 6

International

Elon Musk Don Halfway Enter Race To Be World First Trillionaire

Elon Musk, wey be Tesla and SpaceX CEO, don nearly reach to become di world first trillionaire, Forbes magazine report on Wednesday. Di 54-year-old billionaire be di richest person for world and e briefly reach net worth of $500 billion as shares of im electric car company rise after e small waka for politics. On Wednesday, im net worth reach $500.1 billion before e drop small to $499.1 billion, according […]

todayOctober 2, 2025 8

International

Two People Don Die As Police Open Fire For Anti-Government Protesters For Morocco

Two people don die for di fifth night of anti-government protest wey dey happen for Morocco. State media talk say na police open fire on top group of protesters wey try break enter police station wey dey near di city of Agadir. Di people wey organise di protest don beg make everybody maintain peace, and dem don condemn police say dem dey use repressive security approach. Di protest wey dem […]

todayOctober 2, 2025 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app