Lagos

1066 Results / Page 2 of 119

Background

Lagos

Lagos Police say di tear-gas picture of pensioners for alausa na AI

By: Ayobami Dada Lagos Police don deny report say dem fire tear gas on pensioners during dia protest for Alausa on Monday, August 31. Police say about 500 pensioners gather peacefully, while security operatives dey maintain order, dem no fire any tear gas. Di Command say after government officials address di protesters, NUP executives hold meeting before dem peacefully comot around 4:30pm. Police also yarn say di viral photo wey […]

todaySeptember 1, 2026 13

Lagos

Falana Demand Police Arrest As Tear Gas Scatter Pentioners

By: Mariam Ajayi Human rights lawyer, Femi Falana, call for di arrest of police officers wey  use tear gas scatter pensioners wey protest for Alausa, Lagos. Di pensioners gather for Lagos State Gorment Secretariat and House of Assembly complex dey demand dia outstanding pension adjustments and wage awards before police scatter di protest. Di retirees say di Lagos State Gorment never pay dem pension increases, consequential adjustments and wage awards […]

todaySeptember 1, 2026 10

Lagos

Lagos Gorment press marras Against Gender-Based Violence

By:Mariam Ajayi Lagos State Government don raise serious alarm, say domestic violence for house don reach level wey everybody must put hand stop am immediately. Lagos Justice boss, Lawal Pedro, SAN, through Titilola Vivour-Adeniyi, don raise alarm over domestic and sexual violence for Lagos. Gorment reveal say Lagos don record over 33,000 domestic and sexual violence cases between September 2021 and July 2026. Di state gorment say e no go […]

todaySeptember 1, 2026 8 2

Lagos

Lagos Don Plan To Fix Primary Healthcare

By: Mariam Ajayi Lagos State Gornment don begin three-year plan to improve primary healthcare as population growth and shortage of health workers dey pressure facilities across di state. Health Commissioner Akin Abayomi disclose dis last week during planning meeting for Lagos, saying about 70 per cent of healthcare delivery dey happen for primary centres. Di state health board and local gornment chairmen dey identify gaps in workers, equipment and infrastructure […]

todayAugust 31, 2026 6

Lagos

LAWMA Place Beta Seal On Top Some Markets Inside Ajah-Lekki

By: Mariam Ajayi LAWMA don start to dey clamp down for Ajah-Lekki side, as dem don seal some markets, companies and churches wey dem talk say dem no dey follow waste and environmental rules. LAWMA Director of Public Affairs, Mukaila Sanusi, say places like Kodak Moment, Bayrock Lifestyle, Alpha Pharmacy and Ramayaa Mall na among the places wey LAWMA don clamp down on. Di agency tuk say hotels, hospitals, shops […]

todayAugust 31, 2026 8

Lagos

Lagos Police Join Youths For Peace Waka Against Jaguda Doings

By: Yusuf Abuh Lagos State Police Command don join youths and key stakeholders for Peace Walk to mark International Youth Day 2026 and launch campaign against political and digital thuggery. Di walk, led by Commissioner of Police CP Tijani Fatai, happun to promote peace, responsible citizenship and positive youth engagement across Lagos. Oga CP campaign also dey encourage youths make dem reject violence, online abuse and political thuggery while promoting […]

todayAugust 27, 2026 13

Lagos

Suspected Cultists Kpai Security Man Inside Lagos Estate

By: Mariam Ajayi One security man wey dem identify as Stanley don kpai after two suspected cult members shoot am for Royale Estate, Sangotedo area of Lagos, on Friday night. Witness say di attackers storm di estate around 10pm to 11pm, shoot Stanley several times including for di head, before dem fire shots into di air and run comot. Lagos State Police Command tok tok pesin, Abimbola Adebisi, confirm di […]

todayAugust 26, 2026 8

Lagos

IGP Olatunji Disu Draw Ear Say Jungle Justice Na Crime

Di Inspector-General of Police, Tunji Disu, don drag ear say anybody wey kpai person through jungle justice fit face murder charge and death penalty, as e give di warning for video wey Nigeria Police Force share on Tuesday, August 25, 2026. Disu say e issue di warning because innocent Nigerians dey lose dia lives through rumours, suspicion and mistaken identity, press mouth say nobody no get right to try, sentence […]

todayAugust 25, 2026 11

Lagos

Sanwo Olu Tok Say APC Dey Ready To Win Lagos For Di 2027 Election

Lagos Govo, Babajide Sanwo-Olu, don talk say APC don ready well-well for di 2027 general election, as e dey confident say di party go carry victory for Lagos. Sanwo-Olu talk dis one on Monday after e waka go inspect APC presidential and gornorship campaign offices to see how preparation for di election dey go. Di Govo say di party campaign structure don dey set, as dem don start to dey […]

todayAugust 25, 2026 12 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds