Lagos

1135 Results / Page 2 of 127

Background

Lagos

Lagos Transport Bus Go Jam Pickup Van For Iyana Oworo

Two pipo don dkpeme like dis and two others wunjure for ground  inside motor askident  along Adekunle corridor, very close to Iyana Oworo, Lagos State. Dis  wahala hapun when one Suzuki transport  bus comot go jam  one pickup van. Lagos State Traffic Management Authority LASTMA toktok, Adebayo Taofiq, naim even konfamate di askident inside  statement According by inofrmat by di LASTMA oga, na dia officers help rescue the injured victims, […]

todayOctober 19, 2026 7

Lagos

NAFDAC Seize Fake Drinks Wey Worth Over ₦2 billion for Lagos

NAFDAC don uncover over 20 illegal shops wey dem dey use cook fake drinks for Zamfara Plaza, inside Lagos International Trade Fair Complex, Ojo, on Tuesday, October 13, 2026. Di agency say dem gbab pipo wey dey mix fake drinks, change expiry date for old drinks to make dem look like fresh one and keep drinks wey dem ban for sale. NAFDAC say dem gbab two suspects and carry fake […]

todayOctober 14, 2026 11 4

Lagos

Trailer Buy Waka Go Jam Two Buses for Berger, Wunjure Five

No be small eruku burst for Berger bus stop  Lagos, say one trailer  go do  eye-service jam  two commercial bus, wojure  five pipo yangayanga for ground. Lagos traffic pipo naim rush go  rescue di victims carry dem go hospital, while police come pack di broken motor go station make investigation start. LASTMA  oga Olalekan Bakare, sef konfamte dis mata, wia e tell di victims family sorry. Bakare konfam say, di […]

todayOctober 14, 2026 6 2

Lagos

NAFDAC Catch Two Men For Fake Drink Factory For Lagos

By: Jolayemi Olajide NAFDAC operatives don uncover suspected fake drink factory for Zamfara Plaza, BBA Trade Fair Complex, Lagos State. Di agency suspect say dem dey use di place change labels for expired drinks, including Bullet Energy Drink, Don Julio tequila and Jameson whiskey. NAFDAC arrest two men for di place, but dem never release dia names as at di time dem report di incident. Video wey di agency post […]

todayOctober 13, 2026 9

Lagos

Fire Burn House For Itire, Two Men Rescue

By: Jolayemi Olajide  Firefighters don rescue two men, age 75 and 42, after fire burst for Onitire Road, Itire, Lagos, Tuesday night. Lagos State Fire Service talk say dem receive emergency call around 9:10 p.m. and reach di place by 9:35 p.m. Di fire burn one eight-room bungalow and damage part of another building wey dey nearby. Di 42-year-old man wey burn as e try rescue di elderly man don […]

todayOctober 13, 2026 10

Lagos

Police Gbab 4 Suspected Cultist For Lekki, Ajah Area

Lagos State Police Command  don do small Rambo go kramp  four suspected cultists jaguda boys, say dem bin dey do jaguda doings for  Lekki, Ajah and Elemoro area. According by statement wey police tok tok pesin, Adebisi Abimbola release say dem arrest one Arisekola Ojo, Oluwatobi Oyewole, Oluwaseyi Odunewu and Olumagba Ifatope. Abimbola konfamate say police nor be winch say na information wey di suspects by diasef give during di […]

todayOctober 13, 2026 8

Lagos

LAWMA Close Over 25 Buildings Say Dem Dey Dirty Lagos

Lagos waste management pipo, don carry dia hammar knack, beta  akpako untop over 25 buildings, including one filling station, lock everywia for  Ago Palace Way, Okota, Lagos, say na dem dey make lagos dey smell. LAWMA oga Director, Dr Muyiwa Gbadegesin, naim by himself lead di operation with hin street sweepers naim dem take package di clearing Dem also kramp some boys wey dey use dia small barrow dey park […]

todayOctober 13, 2026 8

Lagos

LAWMA Seal 25 Buildings For Okota Over Dirty Environment

By: Mariam Ajayi LAWMA don seal over 25 buildings for Okota because of dirty environment, as dem share 172 recycling bins give houses for Osborne Estate, Ikoyi. Di oga of LAWMA, Dr Muyiwa Gbadegesin, lead dem workers go clear plenty refuse wey people dump anyhow for Ago Palace Way, including road middle and around bridge. LAWMA carry compactor trucks, payloader, tipper trucks and street sweepers go clear di dirty place, […]

todayOctober 12, 2026 7

Lagos

LASTMA Show As Dem Take Save 670 Pipo For Lagos Askidents

By: Mariam Ajayi Update for lagos, Senior mehn lagos traffic pipo don drop bomb, bring report card say  inside just nine months, na  1,409 road askident dem don witness con  save about  670 souls. Na number one tok tok person of traffic marras, Adebayo Taofiq, dey  yan dis on  Sunday. Hin say na every day di oga kpatakpata of traffic marras, Olalekan Bakare, dey shout, emergency team need to join […]

todayOctober 12, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds