Lagos

1135 Results / Page 3 of 127

Background

Lagos

Train Jam Car For Lagos, But Di Driver Escape Wunjure

By: Kofoworola Olayinka Ehwooo, make God shout for satan, na so devil one bin take di life of One 55-year-old driver, but hin  escape with  serious wunjure after train jam im Honda car for PWD railway crossing for Lagos. according by lagos traffic oga, Olalekan Bakare-Oki, Di train bin dey go Agege when di askident happen, and di car spoil wetin nor good. Beofr LASTMA officials and security men rescue […]

todayOctober 9, 2026 14

Lagos

Lagos Fire Service Records 1,324 Emergency Call In Nine Months

By: Kofoworola Olayinka Lagos State Fire and Rescue Service don record 1,324 emergency incidents between January and September 2026, including 1,135 fire calls, as di state gorment beg resident to take fire prevention serious during dry season. Di service Senior Public Affairs Officer, Fadairo Maria, yarn dis for di third-quarter activity report, wey show say di incidents include 79 rescue calls, 100 salvage operations, nine collapsed-building incident and one gas-related explosion. Di […]

todayOctober 9, 2026 11

Lagos

Train Ram Car For PWD Railway Crossing, Driver Escape Injury

By: Kofoworola Olayinka A 55-year-old driver escape injury after train ran im Honda car for PWD railway crossing for Lagos as di vehicle suffer heavy damage. Di Lagos State Traffic Management Authority, LASTMA, say im officials and security personnel rescue di driver and clear di damaged car from di railway track. Di agency say di train wey dey head towards Agege continue im journey after dem clear di track, but […]

todayOctober 9, 2026 11

Lagos

Lagos Gorment Beg Youth To Put Bodi For Military Recruitment

By: Mariam Ajayi Lagos State Gornment don begin toast lagos youths wey dey between 18 and 26 years say make dem join  military sake of say di state need meet  dia recruitment quota. Say dis nor be to look and thruway face like say insecurity nor concern youth, dat naija reallyneed beta collabo and energy to battle insecurity. Senior man Seco to di Gornment, Abimbola Salu-Hundeyin, naim drop dis micro […]

todayOctober 9, 2026 10

Lagos

Hit And Run Driver Jam Teenager For Onipanu BRT Lane

By: Mariam Ajayi One teenage boy don land for hospital after hit and run driver jam am as e dey cross Onipanu BRT corridor dey go Fadeyi for Lagos State on Wednesday. Di boy sustain serious head and leg injuries for di accident, according to wetin di Permanent Secretary of LASEMA, Dr. Olufemi Oke-Osanyintolu, talk. LASEMA Cobra Team sharp-sharp run reach di scene within two minutes around 4:32 pm to […]

todayOctober 8, 2026 14

Lagos

ADC Candidate Clear Community NEPA Bill For Residents

By: Mariam Ajayi ADC candidate for Eti-Osa Constituency II, Ayodele Adio, don clear  NEPA bills wey pipo owe for one community wey no get light tey tey. Adio make di move during im visit with community leaders and NEPA officials on Wednesday, as residents celebrate when power return to di community. But residents later complain say light don go off again after one alleged instruction to NEPA to disconnect am, […]

todayOctober 8, 2026 10

Lagos

Passenger Kpai Inside Kenya Airways Plane Wey Dey Come Lagos

By: Mariam Ajayi One Kenya Airways plane wey bin dey come Lagos from Nairobi, say from no wia, person just kpeme for plane as hin near Lagos. Nobody sabi wetin kill di man. According by infomate wey di airline tok tok person, Michael Achimugu, bring out, di passenger just stop to respond about 20 minutes before di plane land and dem try first aid, kpokrikpor, di man don go, otilor. […]

todayOctober 7, 2026 9

Lagos

Federal Government Sign Deal To Give Lagos 24-Hour Light

By: Mariam Ajayi Nor be small collabo doings as Wi Federal Gornment and Lagos state agree join body to give Lagos corridor 24/7 steady light. Say already wi oga Presido, Bola Tinubu don sign dis 24/7 Energy Zones magic project make e settle  all di financial and technical issues. Minister of Power, Joseph Tegbe, yarn dis micro soft word  after him go shook body for meeting with baba  Govo, Babajide […]

todayOctober 7, 2026 6

Lagos

Baba Presido,Tinubu React To Military Aircraft Askident

By: Mariam Ajayi Wi oga Presido, Bola Tinubu don declare three days national mourning and order say make mehn mehn touch dis mata of how military aircraft take go get askident for Ondo State wey nor be winch cause am. According by di Ondo state govo, Lucky Ayedatiwa all 32  passengers kpeme for dis askident. As a mark of respect for di 25 passengers and seven crew members wey kpai […]

todayOctober 6, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds