Lagos

879 Results / Page 13 of 98

Background

Lagos

Lagos Police Oga Visit Army, Navy to Boost Security Teamwork

Police Commissioner for Lagos, Mr Fatai Tijani, don waka go visit some important military formations for di state to make security work beta. According to police spokesperson, SP Abimbola Adebisi, di visits hapun on Wednesday and cover 9 Brigade Nigerian Army, 651 Base Service Group, and Navy Ship Beecroft for Apapa. For 9 Brigade wey dey Lagbaja Cantonment, Ikeja, di commander Ayokunle Owolabi na im receive di commissioner. Dem say […]

todayApril 23, 2026 25

Lagos

Lagos Collobi ₦1.3 Trillion From Tax For 2024 – Govo Sanwo Olu

Governor Babajide Sanwo-Olu share update say Lagos State don make about ₦1.3 trillion as internally generated revenue for 2024. Im yan dis one as e speak on Wednesday for opening of 159th Joint Revenue Board meeting for Lagos. Sanwo Olu explain say di money growing na based on gornment investing for digital tax system and expand how dem take collect tax across di state.

todayApril 23, 2026 20

Lagos

Lagos Clarify Sanitation Rules, Warn Defaulters Before April 25 To Cleanup

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don announce say monthly environmental sanitation go start again on Saturday, April 25, 2026, with movement restriction for di state from 6:30am to 8:30am. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab,naim put dis one for news statement. Say di exercise na to allow residents clean dia houses, environment and drainages wella. According to Wahab, enforcement teams from LASPARK, LAWMA, KAI and other agencies […]

todayApril 22, 2026 23

Lagos

Truck Kpai Anoda Dispatch Rider For Otedola Bridge, Lagos

By: Esther Ayoola Say Anoda dispatch rider don lose im life again for road askident for Lagos State, less than 24 hours afta similar one hapun for Alapere area. According to di tuk, tuk of Lagos State Traffic Management Authority, Adebayo Taofiq, statement on Tuesday, di crash hapun for Otedola Bridge inward Secretariat for Ogudu Toll Gate Road, as heavy-duty Volvo truck jam di rider. Lagos State Traffic Management Authority […]

todayApril 22, 2026 10

Lagos

Police Waka Lagos To Rascal One Chance Kidnappers

By: Esther Ayoola Di Lagos State Police command don carry work for head dey do on di spot check to rascal all di rascalities for inside di obodo Lagos. Say dis waka na, Oga commissioner, Fatai Tijani naim lead di waka by imself on Tuesday for di city. According to di Commissioner, di Tuesday waka sef na based on complains from Lagosians about one chance motors, and how dem take […]

todayApril 22, 2026 15

Lagos

Lagos First Lady Group Dash 11 Orphanages N60m Support

By: Esther Ayoola Say nor bi small betament hapun for Lagos oh, dat not fewer than 11 orphanage homes for Lagos receive household items and welfare support worth about N60 million from Committee of Wives of Lagos State Officials. Dis donation, wey First Lady Dr. Ibijoke Sanwo-Olu lead, hapun for Banquet Hall of First Lady Office for Alausa, Ikeja. Gornment tuk say di support include cash cheque for school mata […]

todayApril 22, 2026 12

Lagos

LAWMA Tighten Belt To Stop Flood As Rainy Season Dey Come

By: Esther Ayoola Lagos Waste Management Authority (LAWMA) like dis don tighten arrangement to reduce flooding as rainy season dey come for different parts of di state. Managing Director, Dr Muyiwa Gbadegesin, yarn dis one for interview with tori pipo say dem don increase waste evacuation, especially for flood-prone and crowded areas, so dat drainage work wella. E sti tuk say dem go enforce law against pipo wey dey dump […]

todayApril 21, 2026 19

Lagos

Lagos Lawmaker Promise More Projects As Road Work Continue For Oshodi

By: Esther Ayoola For Oshodi/Isolo Constituency I for Lagos State, House of Assembly member Hon. Stephen Ogundipe on Monday don go promise residents say more development projects. Di senior man make dis announcement as im go inspect ongoing road works for di area. Ogundipe use im mouth tuk say im check four roads Oluwasanmi, Baba Ode, Deji Adeoye, and Alhaji Sokoya streets, and body sweet am for di quality of […]

todayApril 21, 2026 17

Lagos

Jandor Tuk Why Lagos Governorship Race Dey Open, Say Hamzat Never Declare

By: Esther Ayoola Lagos 2023 governorship candidate of di pipos democratic party, Abdulazeez Adediran, AKA Jandor, don go pour cold water for Lagos Politics say Deputy Govo, Obafemi Hamzat, never declare say e wan contest 2027 governorship election. Jandor yarn dis one for TV sitdon tuk on monday E say Hamzat get plenty experience as deputy governor, but for now, no clear sign say e don enter race. According to […]

todayApril 21, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds