Lagos

985 Results / Page 11 of 110

Background

Lagos

Csos And Youth Enter Street Say Cost of Living Wan Kpai Di Living

By: Shalom Ovie Plenti civil society groups, trade unions, and youth omo don go mout Ikeja Under Bridge for Lagos dey shout wi nor go gree, wi nor go gree, dat insecurity, and cost of living wan kpai di living. Di pipo pack demsef out to call on Federal Gornment say make dem consider di common man, say hunger dey di country.Dos wey dey protest, cry out say di way […]

todayJune 12, 2026 7

Lagos

Lagos Clean Up With International Mehn

Clean lagos, clean lagos, u dey feel say na play play, yesterday, lagos environmental pipo cary some senior mehn, show dem shegge, tell dem to clean. Dis na mehn wey dey in charge of international exchange, an dem  carry di senior exchange pipo go clean lagos Marina, to mark World Environment Day 2026. Di programme hapun in collabo with Lagos State Waste Management Authority and Recyclers Association of Nigeria to […]

todayJune 12, 2026 10

Lagos

Sanwo-Olu Show New Team To Run Lagos Gorment

By : Shalom Ovie Lagos Govo, Babajide Sanwo-Olu don present Deputy Govo, Obafemi Hamzat and senior lady Princess Damilola James as di team wey go carry Lagos gofnorship ticket. Di govo tok for news statement say di pair get di experience, vision and capacity to continue di development wey Lagos don enjoy over di years. According to am, di ticket represent di strength, diversity and bright future of Lagos State. […]

todayJune 11, 2026 17

Lagos

APC Aspirants clear Obasa name say Nor be im Sponsor Lagos Protest

By: Shalom Ovie Some All Progessives Congress aspirants for Lagos don explain how Speaker Mudashiru Obasa hand nor dey inside di protest over di party primaries. According to di protesters, say na based on say many election ground nor package di wey e suppose be naim make, di election scatta Di group also reject claim say Obasa give N2 billion to support di demonstration. Dem insist say angry party members […]

todayJune 11, 2026 14

Lagos

IKOSI-KETU Pipo Cry Out Over Cost of Living

Normally na di duty of every gorment of a country to balance tins, for citizen to survive, however e be like water don pass garri for obodo Nigeria. Complain here and there, unto di rising cost of living, konfam news tatafo, Esther Ayoola enter di street of Lagos, to tell us, how Lagos dey cope with di new cost of living.

todayJune 11, 2026 9

Lagos

Lagos Gorment, Agencies Join Hand Take Improve Waste Collection

Di Lagos State Gornment don receive 10 new waste trucks to boost waste collection and improve environmental sanitation across di state. Di trucks come as donation from Lagos State Lottery and Gaming Authority to support beta waste management system and reduce environmental challenges for Lagos. Untop yarnings for di handover ceremony, Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, say di donation na beta collabo between gornment agencies. E add […]

todayJune 11, 2026 10

Lagos

Obasa Watch Hand Comot For APC Protest

Speaker of di Lagos State House of Assembly, Mudashiru Obasa, don warn, say make nobody use im name take organise protest or rally for di APC House of Assembly primaries. Obasa tok dis one as reaction to di protests wey hapun for different parts of Lagos and for di APC Secretariat for ACME Road, Ikeja, on Tuesday. E say some pipo dey try link and blame am for di demonstrations […]

todayJune 10, 2026 12

Lagos

Lagos Assembly Back Royal Family For Oko-Ado Land Mata, Push Make Dem Collect C Of O

By: Esther Ayoola Lagos State House of Assembly on Tuesday don accept recommendation on petition wey concern land mata for Oko-Ado Village, Sangotedo. Dem dey ask, make gornment issue Certificate of Occupancy (C of O) give Igbaro Oteshade Royal Family. Na Chairmo of Judiciary and Public Petitions Committee, Oladipupo Ajomale, tuk dis tuk, say dem go check di land with Surveyor-General office and other agencies like Land Bureau and NTDA. […]

todayJune 10, 2026 12

Lagos

Lagos Gorment Set Compass To Rascal Ebola

Lagos Health Commissioner, Prof. Akin Abayomi, don shake table drop micro soft word say Lagos State get strong doings in place to package Ebola. Im tuk dis one during Invest Lagos 3.0 event on Tuesday. According to am, even as COVID-19 loud reach for 2020, say e dey choir practice for Ebola mata, but dat, Lagos don package tools for di Ebola.

todayJune 10, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds