Lagos

879 Results / Page 14 of 98

Background

Lagos

INTERPOL Catch Runaway Lagos Bizman Over Alleged Double Kpaing

By: Esther Ayoola Police for Lagos don do ogbonge waka gbab one businessman, Hammed Tajudeen Akanbi, wey dem accuse of kpaing Prince Ademola Akinloye and Sheriff Ishola Salami for separate attacks. AIG Olohundare Moshood Jimoh naim yarn dis one for press briefing on Monday for Zone 2 headquarters, Onikan. According to di AIG, na INTERPOL track and arrest Akanbi on April 15 for one hotel for Cotonou, Benin Republic, afta […]

todayApril 21, 2026 9

Lagos

How Speeding Tanker Jam And Kpai Dispatch Rider For Alapere

By: Esther Ayoola Say one serious road askident wey hapun for Motorways Inward Estate area for Alapere, Lagos State, don kpai one dispatch rider. According to Lagos State Traffic Management oga, Adebayo Taofiq, di askident involve empty NIPCO Tanker and di rider. Taofiq say di tanker driver bin dey speed when e jam di moving dispatch rider, and di rider kpai on di spot. LASTMA officials quickly rush go di […]

todayApril 21, 2026 11

Lagos

TCN Close Ikeja-West–Osogbo Power Line Afta Rainstorm

By: Esther Ayoola Transmission Company of Naija (TCN) don legally suspend dia operations for Ikeja-West–Osogbo 330kV line afta heavy rainstorm wey happen on Thursday, 16 April 2026. TCN Public Affairs General Manager, Ndidi Mbah, tuk am for statement wey dem release on Sunday say di rain cause fault wey make di line trip around 14.9km from Ikeja West (Ayobo) side. She explain say inspection show say Tower 515 collapse for […]

todayApril 20, 2026 21

Lagos

Ogun Police Arrest 3 Suspects, Recover Local Gun, Charms

By: Esther Ayoola Ogun State Police Command say dem don do small jet li arrest three suspects for different operations for Mowe and Sagamu area, and dem recover local gun, cartridges and charms wey dem believe say dey linked to cult and crime activities. According to police tuk tuk, Oluseyi Babaseyi, statement on Sunday, dem carry out di arrest between April 14 and 18, 2026 through intelligence work and stop-and-search. […]

todayApril 20, 2026 8

Lagos

Lagos Prepare To Gather Big Men, Kings, Soyinka For Ogbonge Art Exhibition

By: Esther Ayoola Say like dis lagos State dey prepare to host one big art exhibition wey dem call “Gregorian Art Exhibition” to honour legendary artist Bruce Onobrakpeya. Organisers wey be St. Gregory’s College Old Boys Association put for news statement, say di event go bring top dignitaries, traditional rulers and art lovers come together to celebrate am. Dem also tuk say Nobel laureate Wole Soyinka, Obi of Onitsha Nnaemeka […]

todayApril 20, 2026 12

Lagos

How Lexus Jeep Askident Kpai Hawker For Okokomaiko, Lagos

By: Esther Ayoola Road accident wey hapun for Okokomaiko area for Lagos State don go kpai one roadside hawker. According to Statement on Sunday by LASTMA tuk, tuk, Adebayo Taofiq, e tuk say di victim, wey be adult man, kpai for di spot. E explain say di crash involve one Lexus Jeep wey hit di hawker for road. Taofiq sti tuk say LASTMA officers quickly respond to di distress call, […]

todayApril 20, 2026 11

Lagos

Lagos Launch Cybersecurity Rules To Protect People And Businesses

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don bring new cybersecurity guidelines wey go hellep improve digital safety for businesses, gornment offices and pipo wey dey Lagos. Commissioner for Information and Strategy, Gbenga Omotoso, tuk dis one for statement, say, di policy dey timely, as cyber risks dey increase for Naija every day. Say di framework go set protection rules and systems wey go help secure online activities as Lagos dey […]

todayApril 20, 2026 11

Lagos

First Lady Insist Say Na Unity, Love And Respect Go Push Nigeria Forward

First Lady, Oluremi Tinubu again don press tuk  say national development go only work, when citizens joinbodi share values like love, tolerance, peace, sacrifice, compassion and service to humanity. She yarn this one on Friday for wia  she go do inauguration of Odo-Noforija Ultra-Modern Central Mosque for Epe, Lagos State. She no dey there physically, she send message through her Senior Special Assistant on Public Affairs and Strategy, Wahab Alawiye-King […]

todayApril 18, 2026 46

Lagos

NSCDC Burst Baby Factory for Badagry, Rescue 18 Pregnant Women, 10 Pikin 

NSCDC Lagos Command spokesman, Afolabi Babawale, tuk say dem do small jet li  burst one baby factory for Okuju, Ilado for Badagry on Wednesday night into Thursday morning after dem get tip-off about the illegal operation. Babawale explain say operatives raid di place, rescue 18 pregnant women and 10 pikin, and arrest the operators, Joy Okeke and Raphael Agwu. According to am, the victims wey dey  between 18 and 30 […]

todayApril 17, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds