insert_link National Northern Govs Wan Lock Mining For 6 Months, Scatter Ground With ₦228bn Security Cash Govos and Traditional Rulers for north don form geng enter meeting for Kaduna, order say make mining stop for at least six months, and dat illegal mining, na im dey cause all di katakata of security for di North. Di leaders dey para say dat pipo dey face serious gbege wit Jaguda boys and so don set up regional Security Trust Fund, wey every state and local gornment go drop […] todayDecember 2, 2025 8
insert_link National Jonathan Brief Tinubu On Guinea-Bissau Wahala Former Presido Goodluck Jonathan don land for Aso Rock to give Presido Tinubu full gist of wetin shelle for Guinea-Bissau election, as tradition demand anytime former presido handle regional wahala. Jonathan talk say di election don already finish, results dey almost complete, and di only correct next step na to announce who truly win instead of dis confusion wey don drag military enter matter. E beg ECOWAS leaders make dem […] todayDecember 1, 2025 12
insert_link National Atiku Demand Make Dem Probe N17.5tn Pipeline Security Money Former Vice Presido, Atiku Abubakar don drag President Bola Tinubu gornment for Abuja on Sunday, say how dem spend N17.5tn on pipeline security and related wahala for just one year. Na for inside statement wey dem wrap like moi moi through di Atiku news waka waka dem, on Sunday, in yanyanpu dis one say, di money pass 12 years wey Nigeria dey pay fuel subsidy wey dey help millions of […] todayDecember 1, 2025 5
insert_link National Taraba Governor Go Meet Tinubu For Aso Rock Taraba Governor Agbu Kefas don go Aso Rock to meet Tinubu for closed-door session, E waka enter inside di Presidential Villa around 2pm on Monday. Dis na im first visit since e dash PDP goodbye join APC, and e waka enter di State House with APC National Chairman, Prof. Nentawe Yilwatda. Kefas cancel im APC welcome wey suppose hold November 19, say e no make sense to celebrate while Kebbi […] todayDecember 1, 2025 4
insert_link National Oluremi Tinubu Don Call Nigerians Make Dem Renew Fight To End Hiv/Aids By 2030 Wi Oga presido wife Senator Oluremi Tinubu, don call Nigerians make dem renew their commitment to end HIV/AIDS by 2030. She talk this one for statement wey she post for her X handle to mark World AIDS Day 2025 with the theme “Overcoming Disruptions; Transforming the AIDS Response.” According to her, the day remind everybody say make we ginger our efforts to finish HIV/AIDS once and for all. She still […] todayDecember 1, 2025 3
insert_link National FG, Asuu Don Enter Talks On 40% Pay Rise Na wah o! Federal Gornment don yarn say dem wan give ASUU lecturers 40% salary increase, according to di pipo wey follow tori pipo talk for Abuja. Dis one land as ASUU leaders dey ready to waka back go negotiation table with Federal Gornment team wey Yayale Ahmed lead, afta dem don finally settle matter and hammer deal for ASUU National Executive Council meeting for Abuja last Sunday. Branch leaders […] todayDecember 1, 2025 6
insert_link National FG Go Soon Name People Wey Dey Finance Terrorism Di Special Adviser to President Tinubu on Policy Communication, Daniel Bwala, don drop bombshell say Federal Government go soon expose di big men and networks wey dey pump money into terrorism for inside Nigeria. Bwala yarn for TV sit don talk say Tinubu administration don dey take heavy, far-reaching security decisions, and Nigerians go soon see clearly who dey sponsor, shield and empower terrorists across di country. E add say […] todayDecember 1, 2025 11
insert_link National Gunmen Kill Lady Weh Dey Film Ngige Convoy Attack One lady wey dem never take identify don shot dead while she dey record attack wey happen for convoy of Chris Ngige, former Anambra governor and ex-minister of labour and employment. Fred Chukwuelobe, Ngige former spokesperson, talk say gunmen ambush di convoy for Nkpor-Nnobi road, Idemili North LGA of Anambra on Wednesday. Chukwuelobe talk say Ngige no dey di convoy when di attack happen. “One policeman for di pilot car […] todayNovember 28, 2025 7
insert_link National Enugu Govt Cancel Underage Marriage, Arrest Parents, Groom & Matchmaker Enugu State Govt don cancel marriage wey happen between underage girl, Amarachi, and adult man. Di wedding wey happen for Amufie community, Enugu Ezike, Igbo-Eze North Local Government, don show for social media, wey cause public gbege. Commissioner for Gender, Women and Children Affairs, Ngozi Eni, confirm say di state step in sharp sharp to stop di “illegal and harmful union” wey dem talk say don already happen. Di ministry […] todayNovember 28, 2025 7