National

1095 Results / Page 10 of 122

Background

National

INEC Approve 2 New Political Parties

By: Esther Ayoola Ahead of di 2027 general election, INEC don approve two new political parties, making it 21 registered parties now. Di new parties na Democratic Leadership Alliance (DLA) and Nigeria Democratic Congress (NDC). INEC Chairman, Prof. Joash Amupitan, announce dis one for dia first regular meeting with political parties for 2026, wey dem hold for Abuja. All dis approval follow correct assessment wey dey line with di 1999 […]

todayFebruary 6, 2026 4

National

Senate Minority Caucus Clear Tuks Say Senate No Reject Electronic Result Transmission

By: Esther Ayoola Di Senate Minority Caucus on Thursday tuk say Senate no ever reject electronic transmission of election results before dem pass di Electoral Act (Amendment) Bill, contrary to wetin some media report. Say confusion gadimma afta news spread on Wednesday, dey claim say senators reject electronic transmission and 10-year ban for vote buyers and other election offenders. Now, di Senate caucus pipo don clear di air, say di […]

todayFebruary 6, 2026 3

National

President Tinubu Meet Kwara Govo To Touch Light Di Deadly Worro Attack

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu don go do meeting with Kwara State Govo, AbdulRahman AbdulRazaq, for State House Abuja on Thursday, say make im con explain  wetin  hapun for Worro community inside Kaiama Local Government Area. U sabi say, just days ago news report say jaguda boys enter woro community kpai over 160 people, wey gornment link to suspected jihadist fighters. Afta, Govo Abdulrazaq explain to oga […]

todayFebruary 6, 2026 5 1

National

FG Dey Face Heavy Backlash As Fear Dey Say Over 100 People Don Kpai

By: Rilwan Agbomeji More than 100 people bin fear say don kpai for Tuesday night afta deadly attack wey Islamic militants carry enter Woro and Nuku communities for Kaiama Local Government Area of Kwara State. Kwara State Govo, AbdulRahman AbdulRazaq, On Wednesday night  later confirm say 75 people kpai for di gbege as e address residents for palace of Emir of Kaiama, say di victims na local Muslims wey dem […]

todayFebruary 5, 2026 10

National

Bandits Kpai Over 30 People For Katsina And Kwara

By: Esther Ayoola For Katsina and Kwara states, say bandits don kpai kpai more than 30 pipo for different villages on Tuesday. For Katsina, di Doma community for Tafoki Ward, Faskari Local Government Area, na at least 20 people dem kill. Dem burn house and motor, make pipo throway leg run for dia life. Faskari Local Gornment Chairmo, Surajo Aliyu, tuk say na revenge attack and na di worst wey […]

todayFebruary 4, 2026 4 641

National

FG Make Commando Movement To Boost Nigeria Oil Production

By: Esther Ayoola Wi oga presido don dey run racket to boost crude oil production reach 3 million barrels per day within di next five years, say dem dey ready to push anytin aside to ensure say reform for di oil sector old water. Presido Bola Tinubu tuk dis one yesterday for Abuja during di 9th Nigeria International Energy Summit wey dem title “Energy for Peace and Prosperity: Securing Our […]

todayFebruary 4, 2026 4 1

National

President Tinubu Say No Go Turn Back For Agbedo Mata

By: Esther Ayoola Wi oga Presido Bola Tinubu tuk say Naija reform programme no go stop, say im gornment no go turn  dia back on di economic changes even though say hunger dey. Tinubu yarn dis one on Tuesday for Abuja when e receive World Bank delegation for State House, with Vice-President Kashim Shettima and Anna Bjerde leading di team. Baba Seyi,  say agriculture na di way to go oh, […]

todayFebruary 4, 2026 4

National

Makinde Open New Meeting House For PDP For Oyo State

By: Esther Ayoola Oyo State Govo, Seyi Makinde, don declare say di pipos democratic Party nor get any problem, say pipo wey im dey call “vagabonds” don comot for di parti Makinde yarn dis one on Tuesday for Ibadan during unveiling of Oyo State PDP secretariat. Di Oyo state govo dey tuk dis tuk, afta former Rivers State govo, Nyesom Wike, on Monday for PDP NEC meeting for Abuja vow […]

todayFebruary 4, 2026 4

National

FRSC: Six Kpai, 23 Injured As Trailer Lose Control For Lagos–Ibadan Expressway

By: Esther Ayoola Say Six pipo ni kpai, while 23 others get wunjury for one road crash wey happen near Four Square Camp for Lagos–Ibadan Expressway. FRSC Public Relations Officer Odunsin Afolabi ni convastae dis one, say di askident  hapun around 11:27 am, and dia rescue team reach di scene in just two minutes. Afolabi Yanyanpu say na one trailer speeding and fatigue, ni cause di crash. Di FRSC tuk […]

todayFebruary 3, 2026 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app