National

1288 Results / Page 122 of 144

Background

National

Ondo Police Don Catch Man (49 Years Old) For ‘Defilement’ Plus Drug-Induced ‘Abortion’ Of Small Girl (14 Years Old)

Ondo State Police Command don arrest one man, Azeez Lamidi, wey be 49 years old, resident for No. 64 Eegun, Akoko. Di reason be say dem suspect am say e def!le small girl wey be 14 years old and e give am drugs to do abortion for her. DSP Ayanlade Olushola, wey be di Command spokesperson, tell everybody dis tori for one statement on Thursday, October 16, 2025. Di victim […]

todayOctober 17, 2025 23

National

Angry Mob Beat Young Woman Wey Dem Accuse Say She Thief 2-Year-Old Pikin For FCT

Federal Capital Territory (FCT) Police Command don condemn wetin dem call jungle justice after one angry mob beat and nearly strip one young woman wey dem accuse say she wan thief two-year-old pikin for Giri-Kpasere, inside Gwagwalada Area Council. Di woman, wey her name never clear, bin dey with one crying pikin by di roadside around 5:12pm on Saturday, October 11, when one passerby notice say di pikin respond when […]

todayOctober 17, 2025 20

National

World Food Day: Dem Dey Tell FG Make E Support Local Farmers, Share Food Well Well

As Nigeria join di rest of di world celebrate World Food Day on October 16, 2025, stakeholders don call on Federal Government to invest in local farmers, promote agroecology, and support better food distribution to make di country food system strong and better for both people and environment. Mrs. Oluremi Kuteyi, di Executive Director of Spectra Industries Ltd for Oko-Oba, Lagos, make di call during program wey di company organize […]

todayOctober 17, 2025 19

National

FG Go Add Sign Language Inside Basic School Curriculum

Di Federal Government don announce new policy wey go make sign language teaching and learning dey compulsory for all basic education schools for Nigeria. Dis move na part of dem plan to make education inclusive so that no pikin go dey left behind. Di Executive Secretary of Universal Basic Education Commission (UBEC), Aisha Garba, yarn dis one for Abuja on Thursday during di 2025 International Day of di Girl Child. […]

todayOctober 17, 2025 24

National

Man Burn Ex-Girlfriend Inside Oyo Barracks

Di Oyo State Police Command don confirm say dem don arrest one man wey im name be Lawal Faruq, wey allegedly burn im ex-lover, Omolola Hassan, after their relationship scatter. Di incident bin happen for one military barracks for Ibadan, Oyo State capital. One counterinsurgency expert, Zagazola Makama, wey yan for X (former Twitter), talk say di guy claim say him and di babe don swear say dem no go […]

todayOctober 17, 2025 25

National

Tinubu Yarn Say Naija No Suppose Dey Poor At All

President Bola Tinubu talk say Nigeria get plenty solid minerals and no get reason to dey poor. Dia for 2025 Nigeria Mining Week for Abuja, Tinubu, wey Secretary to Government of Federation, Senator George Akume represent, yan say, “Naija no suppose poor because of dia resources and talented people. Di challenge be to use dia potentials make better life for all. Make we turn minerals to miracles of development. ‘Minerals […]

todayOctober 16, 2025 26

National

Bayelsa Woman Don Land 7 Years Jail For Trafficking Girls

One 29-year-old woman, Mariam Omokiri, wey come from Delta State, don land seven years jail plus ₦1 million fine as Bayelsa State High Court find her guilty of human trafficking. Di court yarn say Mariam traffic, export, and promote prostitution of young girls. She carry four girls from Bayelsa go Mali and Senegal to go hustle ashawo work. Na National Agency for the Prohibition of Trafficking in Persons and Other […]

todayOctober 16, 2025 25

National

Senate Go Screen Prof Joash Amupitan As New INEC Chair Today

Senate go screen Prof. Joash Ojo Amupitan for di position of INEC Chairman today (Thursday) after President Bola Tinubu nominate am. Dis matter waka quick as Tinubu letter asking Senate to confirm Amupitan waka floor just 24 hours ago, and Senate prepare to do di screening for National Assembly Complex. Amupitan nomination follow di National Council of State approval last week, as Prof. Mahmood Yakubu don waka go after 10 […]

todayOctober 16, 2025 40

National

Blind People Dey Beg For Inclusion, Make Govment Support Dem For Lagos

 Di Nigeria Association of di Blind, Lagos Chapter, don call on govment and everybody for society make dem support people wey no dey see well, by promoting inclusion and making things easy for dem. Dem talk dis one on Wednesday during 2025 International White Cane and Safety Day celebration wey happen for St. Paul Anglican Church, Ilupeju. Di theme na “White Cane, My Identity.” Di association use di event take […]

todayOctober 16, 2025 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app