National

1427 Results / Page 9 of 159

Background

National

PDP Pick Senator Sandy Onor As Dem Consensus Presidential Candidate

Di Pipos Democratic Party (PDP) don pick Senator Sandy Onor as dia dia general market  candidate for di 2027 presidential election. Na di Chairmo of di PDP Presidential Primaries Collation Committee, former Governor Samuel Ortom, make dis announcement with im yamchop mouth  for Wadata Plaza inside Abuja on Tuesday. Di committee pipo yarn say dem do plenty consultations, dat all di oracles hear dia voice before dem finally choose di […]

todayMay 27, 2026 11

National

Amaechi Reject ADC Presidential Primary Say Atiku Play Wuruwuru

Former Minister of Transportation, Rotimi Amaechi, don reject di results of di African Democratic Congress (ADC) presidential primary election wey hold on Monday. Amaechi yarn for im X handle say di election wuruwuru full inside Di former Rivers State Governor claim say dem block many party members from across di country make dem no vote,  as dem announce former vice presido Atiku Abubakar as winner, say di tin pain am, […]

todayMay 27, 2026 13

National

IGP Disu Honour 17 Fallen Officers For Yobe

By: Esther Ayoola Di Inspector-General of Police, Olatunji Disu, on Tuesday enter heavy rain  to honour di 17 police officers wey terrorists kpai for active service inside Yobe State. Di officers, wey be members of Police Mobile Force, kpai during terrorist attack for Nigerian Army Special Forces School for Buni Yadi, Gujba Local Government Area, on May 8, 2026. While addressing journalists during di ceremony, Disu drop micro soft word […]

todayMay 20, 2026 16

National

Wike Praise Speed Of Abuja Projects

By: Esther Ayoola FCT Minister, Nyesom Wike don loud matas say infrastructure projects for Abuja dey move fast and na with Ogbonge quality. Wike yarn dis on Tuesday during inspection of ongoing projects, saying di government of Bola Tinubu dey serious about opening satellite communities through massive road construction. Im also reveal say Body of Benchers annex building and several road projects don near completion and dat dem go commission […]

todayMay 20, 2026 22

National

Peter Obi Clear NDC Screening, Say Presidential Race Sti Open For Everybody

By: Esther Ayoola Di 2023 labour party presidential candidate Peter Obi don complete im screening as presidential aspirant under Naija Democratic Congress ahead of 2027 general elections. Afta di screening wey last more than two hours for Abuja, Di former Anambra governor salutate di party, say dem ma  sabi democracy. Na so tori pipo sti carry Goodluck Jonathan contesting mata   stone Obi, according to obi make Jonathan feel free to […]

todayMay 20, 2026 17

National

PDP Screen 12 Gov Aspirants, Clear Jonathan As Sole Presidential Pick

By: Esther Ayoola Pipos Democratic Party, interim leadership under Tanimu Turaki don screen 12 governorship aspirants ahead of 2027 election, while dem give former Presido, Goodluck Jonathan automatic ticket to contest presidency. Former Vice President Namadi Sambo, through former Niger State Govo, Babangida Aliyu, naim announce di development afta dia screening exercise for Abuja on Tuesday. Meanwhile, Reacting to di move, African Democratic Congress tuk say Jonathan entering di contest […]

todayMay 20, 2026 11

National

President Tinubu Vow Say Kidnapped Oyo School Victims Go Regain Freedom Soon

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu while im dey open mouth shout, God ibeg oh for one side, don assure Nigerians say all di victims wey bandits kidnap during di attack schools attack for  Oriire Local Government Area of Oyo State,  dem go rescue dem. Di senior man presido put dis one statement through im Special Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga. Nor be amebo say, some […]

todayMay 19, 2026 16

National

SERAP Call INEC To Sharply Investigate APC Governors Election Funds

By: Esther Ayoola One Ogbonge human right group, Socio-Economic Rights and Accountability Project, SERAP, like dis don wire INEC Chairmo, Prof Joash Amupitan, to sharply touch light di mata of some APC governors diverting around N800 billion for political campaign. Dis one dey Inside one letter wey SERAP Deputy Director, Kolawole Oluwadare, sign, wey dem release to news pipo on Sunday. Di organization tell INEC say, dem gat force di […]

todayMay 18, 2026 13

National

Senate Promise To Fast Track State Police Creation

By: Esther Ayoola Senate don condemn di abduction of 87 students and teachers wey happen for Borno and Oyo states within 24 hours. Senate Leader Opeyemi Bamidele yarn dis one for statement wey im media office release on Sunday, say like dis Naija need strong and coordinated security to protect school childresis E tuk say di recent kidnappings show why Naija need state police quick, as National Assembly don already […]

todayMay 18, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds