National

1100 Results / Page 97 of 123

Background

National

Tinubu tell Amupitan: Make 2027 Polls Clean, Free From Wahala

President Bola Tinubu don charge di new INEC Chairman, Professor Joash Amupitan, make e prioritise transparency, credibility, and non-violence as Nigeria dey prepare for 2027 general elections. Tinubu yarn say credible elections na di foundation of public trust and democracy stability. E give Amupitan clear charge to protect di integrity of elections and INEC, starting with di Anambra governorship election for November 2025. Tinubu yan say Amupitan appointment, wey Senate […]

todayOctober 24, 2025 35

National

Nnamdi Kanu Lawyers Don Waka Comot From Di Case

Kanu Agabi, former Attorney-General of di Federation and lead lawyer to Nnamdi Kanu, di detained leader of Indigenous People of Biafra (IPOB), don apply to withdraw from di ongoing terrorism trial for Federal High Court, Abuja. Kanu dey face seven-count charge wey Federal Government file against am over terrorism. When court sit on Thursday, Agabi tell di judge say him and him team no go represent Kanu again because di […]

todayOctober 23, 2025 23

National

Why Police Arrest Omoyele Sowore

Di Nigeria Police don explain why dem arrest African Action Congress (AAC) 2023 presidential candidate, Omoyele Sowore, for Abuja. According to di Force Public Relations Officer, CSP Benjamin Hundeyin, Sowore dey accused say na him lead protesters enter restricted area for FCT, despite say court don already issue order wey no allow anybody go dia. Hundeyin talk dis one on Thursday for Abuja, as e explain say Sowore go face […]

todayOctober 23, 2025 23

National

Police Don Redeploy Abuja DPO For Ushafa Division Wey Slap One Man

FCT Police Commissioner, Miller Dantawaye, don order immediate redeployment of Ushafa Division DPO after video wey show am dey slap young man during arrest go viral. Di video wey burst for X (formerly Twitter) on Tuesday make Nigerians vex well well as dem talk say di officer act unprofessional and abusive. Police Public Relations Officer, SP Josephine Adeh, talk say di commissioner condemn di officer action as e no pure […]

todayOctober 23, 2025 44

National

Student Dey Threaten University With N500m Lawsuit Over Fake Admission Gbege

One 200-level Law student for Achievers University, Owo, Ondo State, Akinlolu Richard Omisade, don threaten to drag di school go court to collect N500 million over fake admission wey JAMB no recognize. Di student lawyer, Barrister Abdulfatai Abdulsalam, deliver protest letter to Vice-Chancellor office, talk say di university no send Omisade details to JAMB for proper registration, and di admission letter wey dem give am na fake. According to di […]

todayOctober 23, 2025 22

National

FG Don Approve $1bn Project To Modernize Lagos Ports

Federal Government don approve $1 billion project to upgrade Lagos ports as dem start plan to modernize other seaports outside Lagos too. Minister of Marine and Blue Economy, Adegboyega Oyetola, talk dis one for 2025 Chartered Institute of Logistics and Transport Nigeria Conference wey happen for Lagos. Di Minister, wey Managing Director of Nigerian Ports Authority, Dr. Abubakar Dantsoho, represent, say dem dey work to improve port infrastructure, make cargo […]

todayOctober 23, 2025 13

National

NDLEA Don Launch Online Portal to Run Drug Test & Visa Clearance Sharp-Sharp

National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) don drop new digital platform wey go make drug integrity test and visa clearance waka easy, sharp and without stress. Dem unveil di portal for Abuja on Tuesday as part of di new system wey dem call Drug Integrity Test and Visa E-Administration System (DITViCAS). NDLEA Oga, Gen. Buba Marwa (wey dem represent by Secretary Shadrach Haruna), talk say dis move na big shift […]

todayOctober 22, 2025 21

National

Senate Don Begin Move To Increase Salary For Soldiers And Security People

Di Nigerian Senate go debate one motion on Wednesday, October 22, wey wan push for better salary and working condition for Armed Forces and other security agencies. Di motion wey Senator Ali Ndume from Borno South carry come Senate floor talk say soldiers and security people dey suffer under “grossly inadequate” pay despite risking dia lives every day for Nigeria. He yarn say junior officers dey collect just ₦50,000 to […]

todayOctober 22, 2025 80

National

ISWAP Dey Plan Fresh Attack for Ondo, Kogi — DSS

Di Department of State Services (DSS) don raise alarm say Islamic State of West Africa Province (ISWAP) dey plan fresh coordinated attack for some communities for Ondo and Kogi states. Confidential memo wey DSS Ondo State Command sign, dated October 20, 2025, warn Brigade Commander for 32 Artillery Brigade, Nigerian Army, say credible intelligence confirm say ISWAP insurgents dey ready to attack places like Eriti Akoko and Oyin Akoko for […]

todayOctober 22, 2025 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app