Niger Delta

13 Results / Page 1 of 2

Background

National

Wike Challenge Haters to Tell Tinubu to Sack Am

By Ebi Oboko FCT Minister, don tell im haters say make dem dey dia dey,  say, na only President Bola Tinubu get power to sack am from im cabinet, not people wey dey criticize am. Di minister yarn this one on Sunday when e go Obio/Akpor LGA for Rivers State for the last part of im “thank you” visit. Wike say if Tinubu feel say e no get anything to […]

todayJanuary 12, 2026 11

National

Senate Presido, Akpabio Repent Sake Of New Year Mass Message Wey Touch Im Heart

By Ebi Oboko Wi oga Senate Presido, Senator Godswill Akpabio, in the spirit of the new year don tell him lawyers make dem withdraw all di defamation cases wey e get against some people for inside the obodo naija. Akpabio speak on Thursday for Sacred Heart Parish, Uyo, say e get almost nine cases for court against people wey e accuse of defaming am. E explain say e hear di […]

todayJanuary 1, 2026 6

Niger Delta

Delta Assembly Pass 2026 State Budget Sharp Sharp for Two Weeks

By: Esther Ayoola Delta State House of Assembly, on Monday, don pass di 2026 State Budget of 1.7 trillion naira. Di approval happen for Asaba, two weeks after Govnor Sheriff Oborevwori present di budget to di House. Di new figure big pass di earlier proposal by 65.6 billion naira, as lawmakers adjust am to meet state needs. Breakdown show say 500 billion naira go for recurrent spending, while 1 trillion, […]

todayDecember 16, 2025 11

Niger Delta

Obi: Naija No Suppose Dey Poor, God Already Bless Us

By: Esther Ayoola Presidential candidate of Labour Paty and before before Anambra state govo, Peter Obi, don tuk say Naija no suppose dey poor, no be poverty capital of world, because God don bless us with plenty resources  wey dey under our foot and wey dey for sky. E yarn this mata for one book launch for inside Abuja wey dey talk about the ogoni experience and how di people […]

todayDecember 9, 2025 9

Niger Delta

FG Revive 450mw Geregu Plant

By: Alice Iduh Wi Federal Government don cure di crase wey dey worry di 450 megawatts enter national grid  after one heavy four-week maintenance for Geregu NIPP plant for Kogi State. Dem talk say dis work boost di plant reliability, make am run sharp-sharp, and even extend deir operating hours so di station fit deliver better light for Nigerians. Head of Corporate Communications, Emmanuel Ojor, yarn dis one on Monday […]

todayDecember 9, 2025 9

Niger Delta

Police Hunt Gunmen Say Dem Attack Imo Community

By: Alice Iduh Nor be small gbege for imo state , say  gunmen  go burst Amala Community, Ngor Okpala, Imo State, open fire for one Toyota Highlander and kpai di driver on di spot. Dem later drag di passenger from  one Lexus commot, and up till now the poice never sti fit confirm how many pipo dem carry. Police PRO, Henry Okoye, yarn say di wounded driver wey dem rush  […]

todayDecember 9, 2025 8

Niger Delta

Apc Cross River Wahala: National Body Block Eba Removal

By: Alice Iduh Progessives Congress wahala for Cross River don scatter reach national level as di party National Working Committee don All overturn di move wey State EXCO make to remove dia chairman, Alphonsus Ogar Eba. National Legal Adviser, Murtala Aliyu, send letter wey summon Eba make e come Abuja on Monday, December 8, to answer di vote of no confidence wey dem pass for am. Di summons land as […]

todayDecember 5, 2025 13

Niger Delta

Jimoh Ibrahim Nomination Don Shake Ondo South Seat

By: Alice Iduh Ondo South don enter political heat  period as Senator Jimoh Ibrahim, wey Presdo Bola Tinubu nominate as non-career ambassador, fit soon leave im Senate seat. Di senator, wey also chair Senate Committee on Inter-Parliamentary Worldwide, fit land posting for UN, UNESCO or African Union, and na dis gist don make contenders begin waka underground to grab di seat. Even though Ibrahim still dey hold im position till […]

todayDecember 5, 2025 7

Niger Delta

Delta Police Yan No Fire Fireworks This Yuletide, Zero Tolerance

By: Alice Iduh Delta State Police don yan say di long-time ban wey dey stop fireworks still dey gidigba as Christmas and New Year dey near, and dem no go tolerate anybody wey try break am. CP Olufemi Abaniwonda, through PPRO SP Bright Edafe, talk say di clampdown go cover di use, sell, storage, and public show of all pyrotechnics, including knock-outs and bangers. Di police talk say dem dey […]

todayDecember 5, 2025 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app