obodo oyinbo

579 Results / Page 2 of 65

Background

obodo oyinbo

Israel Giv Greece 22 Items Wey Dem Thief From Dem

Israel don return 22 ancient artifacts wey dem steal from Greece, as di two country dey use di cultural exchange take make dia relationship strong well-well. Di Israel Antiquities Authority Theft Prevention Unit na dem find di stolen items, even though officials no talk how dem take see dem or how dem take carry am comot from Greece. Greek Minister of Culture, Lina Mendoni, naim receive di ancient objects for […]

todayOctober 14, 2026 7 1

obodo oyinbo

UN Press Yarns On How To Return For Peace Eastern Congo

United Nation, don drop micro soft word say peace dey possible for  eastern Democratic Republic of Congo. And na di senior UN oga, Huang Xia dey porporly dis mata give Security Council on Tuesday say US and Qatar peace talks make beta sense. U sabi say y di area wey get plenty mineral dey sufferly wetin nor good  for many years, as Rwanda-backed M23 fighters and Congo army dey gbege […]

todayOctober 14, 2026 8

obodo oyinbo

Trump Cut Chain Follow Pikin Former Girl Friend

Senior man Presido of America, Donald Trump don open case and plan to sack hin pikin former girlfriend, wey be US ambassador to Greece, Kimberly Guilfoyle, based on say she bin use back door clear her loans. As tori pipu ask Trump wetin hin go do to hin first pikin Donald Trump Jr former fiancee,  senior man squeeze face, tok  say make dem leave di mata to am, say hand […]

todayOctober 13, 2026 8

obodo oyinbo

Trump Drag Putin, Zelenskyy to stop Dia Nonsense War

US Presido, Donald Trump don blow grammar for ground again oh, say make both Russia and Ukraine  stop to attack, say na war wey nor make sense dem dey fight. Trump tok dis one on Monday even as Ukrainian President Volodymyr Zelenskyy dey complain say Russian soldiers don sti go bomb at least six energy centers for Ukraine after peace agreement on Sunday When reporters ask Trump about di new […]

todayOctober 13, 2026 8

obodo oyinbo

One Kpai, 11 Wound For Saudi Airport Attack

One person don kpai, while 11 others don wound for attack on King Khalid International Airport for Saudi Arabia. Di attack happen hours after Houthi media report say airstrike hit airport for Sanaa, di capital of Yemen wey rebel dey control. Iran Foreign Ministry spokesperson, Esmaeil Baghaei, talk say Iran dey seriously worry about wetin dey happen for Arabian Peninsula. E say di way di wahala dey increase go only […]

todayOctober 12, 2026 12

obodo oyinbo

Zelensky Fire Trump, Tell Putin Make Hin Drop Gun For 60 Days

By: Mariam Ajayi Ukrainian Presido, Volodymyr Zelensky don drop hin mouth odour unto how dem go take end di war for Urkain, say US presdio  Donald Trump go tell Russia to  agree  60 days ceasefire. Dis one dey come after Trump cast everywia with hin mouth odoour on Saturday say Ukraine need new president wey go agree peace deal. Zelensky dey respond for  interview with ABC News on Sunday say, […]

todayOctober 12, 2026 10

obodo oyinbo

Trump Send men to Meet Ukraine Leaders To End Russia War

By: Kofoworola Olayinka According to di latest update, US Presido,  Donald Trump mehn, mehn dey arrangr ground to meet Ukraine and Europe leaders for Miami today Friday to find how dem go take stop Russia war against Ukraine. Trump main man naim tie di mata for head like gele, Steve Witkoff, and im son-in-law, Jared Kushner, go bring new plans wey dem dey  hope say go help stop di war. […]

todayOctober 9, 2026 13

obodo oyinbo

Trump Promise No Attack For Iran Again Until November 3rd

By: Mariam Ajayi Iran military force don konfamate say dem dey do operation every night inside Strait of Hormuz to catch any ship wey break dia law. Mean wider, President Donald Trump say US for dia on part sef dey tuk with Iran and promise say, dem nor go attack dem before di November 3 midterm election. Already Dis tension don make oil price jump up by four percent, carry […]

todayOctober 9, 2026 10

obodo oyinbo

China Don Put Forward Song Li To Head WHO

By: Kofoworola Olayinka China don nominate maternity health expert, Song Li, to become di next Director-General of World Health Organization, WHO. China Foreign Ministry spokesperson, Mao Ning, announce di nomination on Thursday, say e show Beijing strong support for and global health. Song Li, wey dey head Department of Women and Child Health for China National Health Commission, get 21 years experience for women and children health matters. She go […]

todayOctober 8, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds