obodo oyinbo

510 Results / Page 2 of 57

Background

obodo oyinbo

Iran, US Don Enter “Touch Me, I Touch You” Wahala

By: Mariam Ajayi Iran don fire back at US bases for Jordan and UAE after US military bomb Iranian rocket launchers for Larak Island. US say dem destroy di launchers to stop Iran from blocking Strait of Hormuz, but Iran say na lie and accuse US of killing and injuring dia fighters and civilians. Iran President Masoud Pezeshkian say Iran no want war, but dem no go siddon dey watch […]

todayAugust 31, 2026 7

obodo oyinbo

World’s Youngest King, Oyo, Dies at 34

By: Blessing Aminu King Oyo Nyimba Kabamba Iguru Rukidi IV, wey become king at just three years old, don die for Uganda at age 34. Di Tooro Kingdom Prime Minister, Calvin Armstrong Rwomiire Akiiki, announce im death on Friday and describe am as big loss to di royal family and Tooro people. We neva know di cause of e death, but Ugandan media tok tok pipu tok say di king […]

todayAugust 28, 2026 15

obodo oyinbo

US Pull Some Troop Comot Nigeria After Joint Operation

By: Kofoworola Olayinka US and Nigerian forces don carry out joint military operations for Lake Chad Basin wey lead to di killing of Abu Bilal al-Minuki, wey US identify as senior Islamic State commander. Pentagon Africa Command spokesperson, Colonel Becky Heyse, say di joint operation show say temporary US military presence fit deliver strong security results. According to reports, Washington dey plan to reduce some of im military presence because […]

todayAugust 28, 2026 15

obodo oyinbo

Trump Don Comot Maduro From Power for Venezuela

By: Kofoworola Olayinka US Presido Donald Trump don send American forces enter Venezuela on January 3, 2026, where dem reportedly capture Presido Nicolas Maduro and im wife, Cilia Flores, before dem carry dem go America. Trump later tuk say US go oversee Venezuela political transition, while America also move to take control of how Venezuela crude oil go dey sell and how di money go dey handle. Di move mean […]

todayAugust 28, 2026 15

obodo oyinbo

Norway King Harald V Don Kpai at 89

By: Kofoworola Olayinka Norway King Harald V don kpai  at age 89 on Friday after more than 30 years for di throne, with im 53-year-old son, Crown Prince Haakon, automatically taking over as king. Britain King Charles III mourn di death, describing Harald as im dear cousin and a big figure wey guide Norway through plenty changes. NATO Secretary General Mark Rutte and European Commission President Ursula von der Leyen […]

todayAugust 28, 2026 6

obodo oyinbo

Irab Write Conditions Like NEPA Bill To Open Strait Of Hormuz

By: Mariam Ajayi Iran security chief, Mohsen Rezaei, don tuk say Tehran dey prepare long list of conditions before dem go open Strait of Hormuz. Qatar Prime Minister don travel go Tehran go beg Iran make dem calm down, but Iran no gree. Meanwider, US gorment pipo say Iran action na just initial gragra as American naval blockade still tight. Di mata don turn serious gbas-gbos between Iran and America, […]

todayAugust 28, 2026 7

obodo oyinbo

How Nepal Floods Kpai kpai Over 160 People As 403 People Missing

By: Yusuf Abuh At least 160 people don die and 403 others still missing after heavy floods and landslides hit northern Nepal near Tibet border on Wednesday, destroying whole communities. Nepali police say dem don recover 157 bodies, while Chinese state media report three deaths and 265 people missing for di Chinese side of di border. Nepal tourism ministry say 403 tourists, including 341 foreigners, don also go missing hours […]

todayAugust 27, 2026 10

obodo oyinbo

German Embassy Warn Nigerians Against Fake Visa Information

By: Kofoworola Olayinka German Embassy for Nigeria don warn Nigerians on Wednesday to avoid misinformation from visa pipu when dem dey seek information about visa applications. Di embassy issue di warning for official X account, urging Nigerians to get visa information directly from official sources instead of agents. Di mission say Nigerians fit share claims wey dem hear from visa agents for di comments, so di embassy fit address some […]

todayAugust 26, 2026 12

obodo oyinbo

Fire Kill 14 Babies For Pakistan Hospital Maternity Ward

By: Kofoworola Olayinka Fire don gut maternity ward for hospital for Islamabad, Pakistan, killing 14 babies. Authority say faulty air conditioner cause di fire wey start for third floor of Pakistan Institute of Medical Science. Witness say heavy smoke, broken glass and slow emergency response make di situation worse.

todayAugust 26, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds