obodo oyinbo

580 Results / Page 46 of 65

Background

obodo oyinbo

Iran Allow 10 Oil Tankers Pass Strait Of Hormuz

By: Esther Ayoola US Presido Donald Trump tuk on Thursday for Washington say Iran don allow 10 oil tankers pass Strait of Hormuz. Trump tuk for im truth social say dis na “gift” from Iran to show dia seriousness about negotiations to stop di war, wey don dey go on for nearly four weeks now. Di tankers, wey Trump say fit be Pakistani-flagged, travel di strait of Hormuz wey don […]

todayMarch 27, 2026 22

obodo oyinbo

UN Vote Say Slave Trade Na Biggest Crime In History

By: Esther Ayoola Yesterday for UN headquarters for New York, UN General Assembly vote say, transatlantic African slave trade na “di biggest crime against humanity.” Ghana propose di motion, and 123 countries gree to am. USA, Israel, and Argentina oppose di vote, while UK and all 27 EU countries watch hand comot. Untop yarnings with tori pipo afta di meeting,  Ghana Presido, John Mahama tell reporters say e dey support […]

todayMarch 27, 2026 36

obodo oyinbo

Iran Dey Fear To Admit Say Dem Want Peace Deal- Trump Yarn

Donald Trump talk on Wednesday for Republican lawmakers dinner for Washington DC say Iran dey secretly negotiate peace deal with di United States. Trump claim say even though Abbas Araghchi don earlier deny talks, Iranian officials still dey find way to make agreement. According to am, dem no dey admit am publicly because dem fear say their own people or even US fit harm dem. Di statement come as tension […]

todayMarch 26, 2026 29

obodo oyinbo

Make Una Stop Di War – Guterres Yarn

UN Secretary-General António Guterres don sama warning  say di war wey United States and Israel dey fight Iran don dey out of hand. Im yarn dis on Wednesday for New York, say e dey urge all sides make dem step back and try settle di mata wit diplomacy. Guterres explain say di conflict don spread pass wetin leaders bin expect, and e fit cause plenty suffering and economy wahala. E […]

todayMarch 26, 2026 36

obodo oyinbo

Britain, France And 30 Countries Dem To Join Bodi On Top Strait Of Hormuz Marras

Britain and France wan hold meeting dis week for Europe with about 30 countries to hellep reopen di Strait of Hormuz. According to Britain defence official rob mind with tori pipo,  di join bodi doings go include top officials from Britain, France, Germany, Italy, Japan and Netherlands and 24 other countries. Say Britain top military oga, Richard Knighton, don already meet di first six countries plus Canada on Sunday for […]

todayMarch 25, 2026 35 1

obodo oyinbo

US Send 15-Point Peace Plan To Iran

Iran don receive 15-point peace plan from US, and dat na Pakistan deliver am as intermediary dis week to try settle di nuclear issue. Di plan, wey dem no show to  public, fit help stop some of Iran nuclear facility and US suppose also remove sanctions from Iran. One Israeli minister explain di mat give tori pipo on Tuesday say di plan fine for paper, but e be like say […]

todayMarch 25, 2026 34

obodo oyinbo

US Police Arrest Driver Wey kpai Nigerian Graduate Fadero

Metropolitan Nashville Police for US don arrest one driver wey dey link to fatal hit-and-run wey kpai one Nigerian graduate, Oluwalayomi Fadero. Report from local station WSMV4 say di mata na since on Friday after di suspect, Ray Eugene Padgett, thief one vehicle come dey run. Di owner of di truck trace am reach one area, but when di suspect notice say dem dey follow am, e reverse motor jam […]

todayMarch 25, 2026 23

obodo oyinbo

Court Grant Former Brazil Presido House Arrest 

Former Brazilian Presido, Jair Bolsonaro don get temporary house arrest after im hospital stay for bronchopneumonia. On Tuesday, Alexandre de Moraes tuk say im approve 90 days house arrest for humanitarian reason, an dem fit extend if medical need dey. Bolsonaro, wey dey 71, dey serve 27-year jail sentence wey court give am for 2022 attempted coup. While im dey hospital, im announce say im pick im pikin, Flavio Bolsonaro, […]

todayMarch 25, 2026 25

obodo oyinbo

U.S Presido Trump Again Says U.S Dey Tuk With Iran To End Di War 

US Presido Donald Trump  again say dem still dey try negotiate with Iran, even as Iran yarn say di tuks na fake news. According to report U.S and Israel sti attack Iran yesterday, and for one strike for south Tehran, at least 12 pipo kpai and 28 wunjor. Iran and Hezbollah sti  fire new set of missiles reach Israel, including Tel Aviv and di north, kpaing one person and wunjor […]

todayMarch 25, 2026 30

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds