obodo oyinbo

580 Results / Page 61 of 65

Background

foreign

Saudi Coalition Fire Bomb for Yemen South

By Ebi Oboko Saudi Arabia-led coalition day never break, early mor mor confamate say, dem don fire bomb scarra Dhale, Yemen, on Wednesday. Say Southern Transitional Council (STC) leader Aidarous al-Zubaidi even jump comot plane wey im suppose use fly, use leg pick race for di mata, and dat up till now nobody know wia im enter. Coalition add say e don gather plenty soldiers, tanks, gun, and munitions for […]

todayJanuary 7, 2026 23 1

obodo oyinbo

UN Clear US Say Wetin Dem Do Venezuela President Break International Law

By: Esther Ayoola United Nations confamate marra say US air strikes for Venezuela and di way dem carry President Nicolas Maduro comot, say e break international law. U.N tuk say no country suppose use force or threaten another country sovereignty, and dem dey call world leaders make dem speak with one voice. US commando and military force carry Maduro and im wife go America, where e appear for New York […]

todayJanuary 6, 2026 35

obodo oyinbo

Maria Machado Vow Say She Go Return Venezuela

By: Esther Ayoola Venezuelan opposition leader Maria Machado tuk say she go return afta US military comot President Nicolas Maduro from power. For her first public tuk since di weekend post, di Nobel Peace Prize winner yarn for Fox News say she dey plan come back Venezuela as soon as possible. Machado no gree with interim president Delcy Rodriguez, say, she na one of di people wey plan torture, persecution, […]

todayJanuary 6, 2026 27

obodo oyinbo

China Move Mehn To Guide Latin America Say Ameriaca Dey Misbehave

By: Esther Ayoola China Foreign Ministry don yarn again say dem no dey happy with wetin US dey do for Venezuela and dem ready join other countries make international law stand gidigba. Dem tuk say dem ready to join hand with countries for di region to protect peace for Latin America plus Caribbean. You sabi say, China don call on US make dem free Maduro sharp-sharp and stop dey topple […]

todayJanuary 6, 2026 33

foreign

Maduro Cry Kidnap, as US Drag Am Go Court

By Ebi Oboko Venezuela Presido, Maduro, 63, don go tell one US court for New York say dem kidnap am comot Venezuela, and say e no guilty, as e still dey claim say e be president. Im wife, Cilia Flores, too talk say she no do anything bad, as both of dem appear for court. US commandos carry dem early Saturday, and later President Donald Trump announce say America don […]

todayJanuary 6, 2026 46 10

obodo oyinbo

US Commandos Grab Maduro, Carry Am Go New York Court

By: Esther Ayoola Dem don carry comot former Venezuela president, Nicolas Maduro, reach New York court on Monday, few days afta US military grab am for Caracas. US say dem arrest am and him wife, Cilia Flores, because of drug trafficking case. Soldiers use helicopter, fighter jet and navy take dem comot Venezuela on Saturday. Meanwhile, interim leader Delcy Rodriguez don soften stance and tuk say she fit work with […]

todayJanuary 5, 2026 28 4

obodo oyinbo

Russia Send Bomb Scarra Kyiv, Kpai Two Pipo

By: Esther Ayoola Say nor be small tin Russia do with missile and drone for Ukraine early Mor mor on Monday, kpai, kpai two pipo for Kyiv area and wunjor plenty others. According to local oga dem, say, Air raid sirens dey shout across di country just afta midnight. Ukraine military even try air defence for different areas, ni soften di impact. For Kyiv, one private hospital catch fire afta […]

todayJanuary 5, 2026 31 4

obodo oyinbo

US Wan Enter Colombia, Trump Say Colombia Presido Get Bad Character

By: Esther Ayoola US Presido, Donald Trump like dis don turn attention to Colombia, say im no like Colombia Presido, Gustavo Petro. Dis one dey come afta world leaders send complain give am on why, U.S kramp Venezuela President Nicolas Maduro. For inside post for X, Trump tuk say goment for Colombia and Venezuela dey “sick,” and Petro dey do like person wey dey sell cocaine. Im still add am […]

todayJanuary 5, 2026 30 6

obodo oyinbo

Yemen Wahala, Say Saudi-Pipo An Separatists Scarra Yemen Border With Fight

By: Rilwan Agbomeji Fighting don break for Yemen, for Hadramout province wey dey near Saudi Arabia, between forces wey follow Saudi-backed govo and di Southern Transitional Council (STC) separatists. STC talk say Saudi Arabia dey bomb dia pipo near di border, but oga govo,  Salem al-Khanbashi yarn say dem just wan take back military bases “peacefully and systematically.” STC tuk, tuk, Lieutenant-Colonel Mohamed al-Naqib yarn say dia dey fight serious […]

todayJanuary 2, 2026 25

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds